Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,196,095 members, 7,960,508 topics. Date: Friday, 27 September 2024 at 11:19 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (23) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (62660 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (20) (21) (22) (23) (24) (25) (26) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:17am On Sep 26, 2009
grin grin grin
@FL Gators,

I sure say him no lie say im dey single
Or why else he go dey come here dey mingle
As u can see, he don give you im preference
In fact, he come take YOU as point of reference cheesy
So quick quick, I hope u get twin or maybe even clone
Wey you go give adebayo201 to be d bone of him bone wink grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:57am On Sep 26, 2009
Dat 1 kno b crime,
2 b hukd 2 a prime,
God don show me d way,
i wil neva mak u go astray,
u see say d tin don dey reflect,
to say i kno fit sleep corect,
i post arund afta 1,
u rply dat afta 1, grin
shai, i kno go vigil,
kno b say i dey ill,
bt dat fink dey disturb me,
to say i decid 2 see ur hymn,
shey u kno lyk 'am,
meadan nd semid b padi,
u nd me go dey joli,

abi aw u see dat point,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:41pm On Sep 26, 2009
tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 1:24pm On Sep 26, 2009
like play, like play,
i don dey old,
na so time dey carry me go
and i still dey find,
looku looku efri'wh'ia,
for dat chic'alla wen be my own.

dis wan no be joke,
but like sey na film trick,
i still dey siddon look,
efri'bodi dey carry eye enter market,
me remain like sigidi,
put stone inside pot to boil.

dis na very serious matter oh,
shuo whish levels with me so?
shey na becuz i no fine,
abi i no gree sabi yarn,
d thin' don tire me pass mark,
sotey wetin remain na "i no know."
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 9:59pm On Sep 26, 2009
Oga ruud,
i kno dat u'r gud,
u see_nawa dayz babes,
no wan giv guyz facez,
aw many times i don talk 2 fl gators,
she stil dey send me rhyme_terminators,
she talk say she don get prime,
wey me bcoz of her don already commit crime,
i tink to say i cum dey cry,
doktor Seun confirm say my bone don dey dry,
i'm ready 2 du anytin 4 u,
bcoz i dey support man u,
abeg kno trow dat ur rhyme arrow,
na only u i want 2 dey see 4 my life rainbow.

Fl Gators! Fl Gators!! Fl Gators!!! grin :-C
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:32am On Sep 27, 2009
adebayor, j'owo coolu temper,
ma' lo kpa ra e lori kini yi oh,
shebi o' ti so' fun e kpe o ti ni eni'kan t'owun fe,
abi o fe ki o'ko e, wa da bi'ba'i ru?
well, nkan ti ma so' fun e ni'kpe,
ko ni'suru fun,
mi o' le kparo fun e,
paddy ati ManU fans ni wa,
su'gbon aw'on ebi wa ti so' w'in kpe,
ee'fe o'kin sh'ey ee'ja,
ti obirin ba like e, oma gba fun e,
but o' la ti ni'suru fun,
je'je l'aiye,
je'je no ni o'ro ee'fe,
ni'nu kini yi ti o'ba gbe ikpo'kini,
ko'si nkan t'o buru n'be
infact, o' ma pay e ju,
because oni shey ra e le'shey,
so paddy mi, shey solo,
asiko olukaloko shi ma'de
to ba like e' gan, o' ma du'ro de',
jo'wo ma te'ley di'e di'e. . . . . . . . . . . . .


                                                                  Abeg no vex,
                                                                          Yoruba no be my mama language
                                                                          hope sey i make small sense sha. . . . .  lol
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:04pm On Sep 27, 2009
@ruudie,
I don hear u,
bt lik man u,
we get al we want by pawa,
and me kno bi mama tawa,
wey dey sell rice 4 luth,
i b correct yuth,
atleast, she suppose reply,
my broda fink say i don dey ly,
babe, chek my calendar,
d luv sweet pas sugar,
i tin don dey du me yori_yori,
nd me no b guy 4rm warri,
just reply me,
abi until i sing church hymn
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 9:29pm On Sep 27, 2009
adebayo201:

Oga ruud,
i kno dat u'r gud,
u see_nawa dayz babes,
no wan giv guyz facez,
aw many times i don talk 2 fl gators,
she stil dey send me rhyme_terminators,
she talk say she don get prime,
wey me bcoz of her don already commit crime,
i tink to say i cum dey cry,
doktor Seun confirm say my bone don dey dry,
i'm ready 2 du anytin 4 u,
bcoz i dey support man u,
abeg kno trow dat your rhyme arrow,
na only u i want 2 dey see 4 my life rainbow.

Fl Gators! Fl Gators!! Fl Gators!!! grin :-C

grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 1:33am On Sep 28, 2009
Wetin b d meanin of dat TEETH
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 1:34am On Sep 28, 2009
adebayo201:

Wetin b d meanin of dat TEETH
grin grin grin grin
Nothing, just a day to smile
Abi shey I dey lie?
grin grin grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:46pm On Sep 28, 2009
oh baby na u,
only u can make my sky blue,
blow 1 kiss cure ma bird flu,
remix me sotey i turn new.

chei. . . . baby na u,
only u i wan to be my boo,
dey gum tight me so like glue,
fit make me abandon ogbono and foo-foo.

egbe. . . . baby na u,
only ur food i wan see for menu,
no be lie oh dis na true
to God no wan fit ever do,
biko, no deny jus say u luv me too.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 6:50pm On Sep 28, 2009
Me kno fit shout @oga ruudie.0

fl gators me kno nid ur teeth just giv me ur rhyme meat me dey hungry grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 7:44pm On Sep 28, 2009
Those flyin chickens don lose again
And inflict on top me an unbearable pain
Why be se things no just go our way?
This match of all matches & 2day of all day
Now, my supper I no go fit chop
Because my appetite & morale don drop
E be like se I go stop to dey watch our match
After all, all our national teams just dey crash.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 10:17am On Sep 29, 2009
hmmmm cry cry
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by McDoe(m): 4:29pm On Sep 29, 2009
I no fit commot my look frm you
that's why i be like lucozade.
everything thing about u dey spur me to action,
that is why i dey churn out my unction.
u be de rose wey dey inspire,
and the reason i want to aspire.
You be the one I love badly
and the only one that cares for me like a buddie,
nothing on earth can make me loose u,
even everything will lost for your sake.
my plea to youfor this valetine,
is to accept my gift of violet .
I want to say I love ya,
like goat dey love yam.
li
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:55am On Sep 30, 2009
I stand stil kno kno wey tin i fit write,
until i saw u standin by my right,
let me b wit u,
like a sheep and a ewe,
ur luv dey shak me like shepe,
na e make me dey du lik Makelele,
my frends cald me a brat,
i tld dem dat i'm ur pussy cat,
pls, turn me 2 ur pillow,
na only u i go dey follow,
if my luv iz put inside prison 4 Alaka,
walai, i swear i go turn 2 b a prison seeker,
from they, u go kno say i b d man wey dem dey cal prison breaker, undecided
me nd u kno nid revocation,
in 2months tyme na 4 us 2 du convocation,
4rm Lagos City,
2 Manchester 'City' grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by ravenzord(m): 3:32pm On Oct 01, 2009
E don tey wey I don enter dis place
I dey busy dey hustle,tryna get outta d rat race
But now I don come back make I show my face
And my rhyming 4 2day na 2 sing my praise
God create me,come give me d right 2 brag
Cos I dey blessed,dat one nobody fit drag
E no matter say my clothes no get Louis V tags
Cos d one wey I get,I dey wear am with swag
Now no get d impression say I dey go around feeling
But I remember d time wey I dey spend my days dreaming
Of how I go dey cool,but now I dey steaming (hot)
I know say my rhyming s'poz dey in pidgin (but)
This truth I've found:
That my gifts abound,
One of which is to speak thoughts so profound
,that great minds they enlighten and small minds they confound,
so even if U feel bereft,got ur soul on the ground,
U'r gon' be lifted when u hear my sounds,
cos they really are divine verses expressd by mortal mouth.

Happy independence day anniversary y'all.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 2:28am On Oct 02, 2009
Amen,Amen,Amen,
i open my eye i see myself 4 a tal hil,
prayin 4 my nation on my kneel,
God, wu iz goin 2 save uz,
from diz pple wey cuk uz needle lyk nurse,
dem dey climb uz dugbe_dugbe lyk Tufan horse,
9ja my papa land,
wey ful of blaky lyk sand,
dem talk say we b 49,
wey we stil dey find our helpa go river nile,
wat a pity!
They cnt du deir duty,
nation ful of human nd natural resources,
bt we stil dey bak dey wear my stockings,
wel sha, Gob bless 9ja,
weda war or peace me i kno go ja,
i go mak sure say i make am b4 i payin,
i kno go let dem mak my lif wayin,
Fellow 9ja, let rais d flag,
mak we cary our freedom bag,
coz I'M BLACK, I'M PROUD, I'M N_A_I_J_A. grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 2:49am On Oct 02, 2009


@ ravenzord, u really really hit the spot
@adebayo201, you sef drop am like it's hot
I always dey respect true patriotism
Cos my luv for my country strong pass favouritism
As we don finish to celebrate the independence anniversary
Make we always remember to be a positive emissary
Of the plenty good news wey go soon full our motherland
And remember say, any foreign country wey we dey na contraband wink grin

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 9:23am On Oct 02, 2009
9ja don nack 49 yrs but shey anythin' dey to celebrate?
That na the big question wey we suppose dey debate
Wetin we get to show for all these our independent 49 year?
Apart from curruption, epileptic power, militancy & poor health care (etc)
Sometimes I think the amalgamation was a mistake
And on such occasions I wish Nigeria will just break
See - our case don become very serious and critical
And this in turn has made many Nigerians very cynical (like moi)
I laugh everytime I hear 7 point agenda
Becos to me all na noise & political propaganda
Anyhow sha, I go give Yaradua the benefit of the doubt
Afterall dem say em be academician & not a political tout
Hmm - here is wishing Nigeria a happy 49th birthday
I just hope our government would change its way   

And sit down, govern well and not lead the country astray
Finally, Make we just continue to dey pray
To keep evil intentions 4 our country at bay.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:49am On Oct 02, 2009
shocked grin

shuo see men dey scatter ground,
serious thing oh, no be lost and found,
from all corner na ogbo'nge sound,
e sweet pass cuz d thin' dey go round,
mukulu melodies like were yam dey pound. . . .

una no vex, me jus cross border,
na kudi omo boy go find 4 side of d other,
we need to arrange 4 father & mother,
so dat dem no go too dey bother,
na only dem dey, we no get another. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:53pm On Oct 02, 2009
wetin i go do without ur love?
my church-mind don think am tire,
still yet e neva do,
na wan place i go jus dey
motor wey no get tyre go too fast.

wetin i go do if u say u wan go?
dis i no wan gree hear,
but inside my mind i know e fit be,
house wey dey on fire na small,
my heart go da'ba'ru final-final.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 10:26pm On Oct 02, 2009
Dnt make me cry,
inside my bones dey dry,
see as evrybdy dey drop(rhymes),
nt until i see or read ur own i kno go chop,
9ja dey celebrate,
we dey formulate,
which day we go stop 2 calculate,
i kno want diz agape luv 2 liquedate,
4 ur eye i see y?,
my own dey show fine,
na only u,
dnt mind semiu,
na önly u,
baby, dnt mind chinedu,
na only u,
ur name Fl Gators. grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 10:39pm On Oct 02, 2009
grin
sad
shocked
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 4:54am On Oct 03, 2009
Fatherland and or motherland al na join,
mak we grab our löin,
diz country must nt fall,
if nt we go suffer 'am all,
ppl dey shout say na government,
government say na just the nation settlement,
shey una dey comprehend,
if nt better cum nd stand at diz end,
ppl just 2 funny,
dem say d country dey own money (debt),
notin bad if dem self go borrow mony,
al i kno iz dat 9ja na our surname,
ourname na e b our username,
yl our papa name na e b password,
so let mak 9ja a beta home in diz part of d world.
Gud morin, happy new SATURDAY grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 1:51pm On Oct 04, 2009
I bin sabi one foolish & yeye guy like that
Em case dey hopeless and em be useless brat
The guy na also ogbanje and a certified retard
Infact Yabaleft don confirm se the guy don run mad
Na so so bush bush grammar em dey nack 4 all the thread
But for em mind him get correct queen's english cred
I don tell am se make em go take em medication
Or better still make em enter mental institution
Because em be living proof of the word ignorance
Abeg make una come take am for special deliverance
Before em case become critical and e too late
Just incase una dey wonder, em name na Gaga4hate
Even from em name sef una go know se em don go gaga
And em be slowpoke, M.U.M.U and a confirmed maga
The guy be like those district 9 aliens from another planet
So 4 now, I go sheath my sword cos em no be worthy oponent
The guy is filth and not fit to be on cyberspace
If dem born u well, enter here come show ur face
And u go see how I go quick put u 4 your place
If u no do that thing wey u talk se u go do
I repeat na holy thunder go fire you.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 3:45pm On Oct 04, 2009
Take it easy,
i kno dat guy_just ful of satan fizzy,
talk talk ful e mouth,
wen dem born 'am na middle of month,
oga semid point of correctiön,
kno b say i b e fellow mechanization,
e name na ogaga4luv,
shai see name wey b lik loav,
mak we settle diz matter,
'coz if mod yawa,
i kno go happy,
seein u goin out of diz rhymy. cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 3:46pm On Oct 04, 2009
Take it easy,
i kno dat guy_just ful of satan fizzy,
talk talk ful e mouth,
wen dem born 'am na middle of month,
oga semid point of correctiön,
kno b say i b e fellow mechanization,
e name na ogaga4luv,
shai see name wey b lik loav,
mak we settle diz matter,
'coz if mod yawa,
i kno go happy,
seein u goin out of diz rhymy. cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 4:24pm On Oct 04, 2009
Lol good morning y'all
I see that you guys are having a ball
writing about hatred, dislike and satan, no doubt
have we forgotten what this thread was about?
Where's the love? the sweet? the beds of rose?
What's with this position of hatred that you guys  pose?

Has the thread lose its sweet aroma that draws one to read and post?
No more can I smell  the sweet aroma the thread used to boast
undecided undecided
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:37pm On Oct 04, 2009


@FL Gators & co.

me sef no fit understand what went wrong
d hatred wey dey pour for here too dey strong
i understand say semid dey vex, i've been there b4
but na im even advise me to always overlook
make anger no come hold person like hook
I surely hope the bad mood go improve
So we go continue our naija luv groove undecided
smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:00pm On Oct 04, 2009
tongue tongue diz 4 my post cry undecided

yl diz 4u grin grin grin @fl gators cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 3:02pm On Oct 06, 2009
5yrs don pass nah,
And no wan fit reash u,
Many egbedus don show,
Cross many many water,
Frog, toad, lizard i don kiss,
Princess dem don do kongba dance,
Door don open close,
But dat hole still dey,
And mouth don dry tey'lee,
Wu'sai dat rain wan comot?
Bad as e bad, I go dey wait.

(1) (2) (3) ... (20) (21) (22) (23) (24) (25) (26) ... (40) (Reply)

Out Of The Blue / Nephilim / Rhoda

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 74
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.