Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,196,089 members, 7,960,463 topics. Date: Friday, 27 September 2024 at 09:13 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (25) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (62659 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (22) (23) (24) (25) (26) (27) (28) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:08pm On Nov 10, 2009
e no fair,
dis my heart don stiff for u like chair,
but u no jus even care,
i dey ontop bed u dey fix ur hair,
na so u go pursue me from here!?
28 days offshore me & u no near,
d way i miss u i no fit bear,
u go tell me sey i dey dear,
yet drive me to go drink beer,
and blame me wen i meet ashi for there,
to lose ur love before i been dey fear,
now u don kuku vex me pass to dare,
if i look back make thunder strike me i swear,
i dey go remain for my land of no where!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 11:53pm On Nov 11, 2009
Ruudie, e don do - these ur love rhymes go kill person
But shey all this while, you neva learn your lesson?
No be by word of mouth but by the size of ur pocket
Cos if u no hold, babes go just dey play u like puppet
Abi, u neva hear se money dey make the world go round
Look around you and u'll see many examples abound
Moreover, we dey for period of economic recession
So u gats have a fat bank account to get a +ve reaction
Therefore take my advice, get to work and make the kish
Because na em be the bait wey man dey take catch fish.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid(m): 7:19pm On Nov 13, 2009
Right now, me no get time for sissy opata love yarn
As I dey vex gan cos seun don issue me ban
I know se the ban na the handy work of my detractor
Cos e be like se na one lily livered chicken report me to moderator
And truly,if I catch the person I go crush am with tractor.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by AyubaAbu: 8:01pm On Nov 13, 2009
na hmmmmmm ooooooooooooooo, my pady, but u sure say na u only u that thing dey wory
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 1:44pm On Nov 14, 2009
exactly dat day dey issue me spam,
i dont know wqewtin i do the pam,
na vex undecided make me won 4get diz place,
until i remember say, i fit make my ways,
semid take heart,
wey u wan cum start from on this planet earth,
hmmmmmmmmmmmmmm, i don know what to say, cry cry cry
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by efepro(m): 11:17am On Nov 18, 2009
@semid.no mind dem,na so dem go dey act like savages wey live 4 d past.Dem go dey issue BAN as if na gate pass.D thing dey vex me,i no know weda make i dey call dem mr. BANnabas.All dis bad belle 4 NL,na dem evn worst pass.No worry semid,make u tek heart,we go look for means to deal wit their ass.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:56am On Nov 19, 2009
Èfepro, welldone - U try cos e no easy
See as your rhymes flow like lil' wizzy's
BTW, thanks for the words of consolation
But please, no yabbing or words of condemnation
As Seun don restore my posting privileges
So I no gree with u say im dey behave like dem savages
For him lifting my ban, I remain eternally grateful
And from now on, I go dey act nice and cool
Cos I don see se it ain't cool to act the fool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:31pm On Nov 19, 2009
i don do all i fit,
many many night i no sleep,
today, tomorrow, i dey fight,
turn myself to ewu-me'e,
no let we luv jus kpa'fuka so,
u sef don over-try,
e no go make sense to go,
pack all ur things waka lef,
dis na gbe'ge wey we fit win
i dey beg u to believe. . . .

e no easy,
hardship no good,
tears dey heavy inside,
as u say e don do u,
u wan betta life,
man wey go make u smile
but i dey beg jus hold on small,
jus try make u believe. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:05pm On Nov 19, 2009



Semid, so becos dem re-instate u, u come dey humble
all those ur gra-gra don turn to cookie crumble angry tongue
if na me dem ban, me i no go come back undecided tongue
I go jus' close my mind and give NL the sack cool
But in ur case wey u talk say u act the fool cheesy
E good as you promise to dey calm like swimming pool wink grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 1:57pm On Nov 19, 2009
Hmmm - Maedan, I no know how I go explain am to you
See - the love wey I get for NL pass the one wey I get for my boo
As them ban me, I be like animal wey dem lock up for zoo
Becos 4 me, NL don become an obsession & addiction
Cos e dey damn interesting & is a 1-stop site for information
I assure u - no be good thing or pleasant experience
So abeg, make u no do collect ban o- cos I go miss ur presence.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 2:38pm On Nov 19, 2009


semid, e true say NL get im own plenty advantage
but make d Mods no dey go on banning rampage tongue
wetin dis place go be without the diversity of members
e go just dey boring like say na house of rep chambers cheesy
in any case, i no go dey find wahala wey go give me ban
or else dat one go be d fullstop to the era of maedan tongue grin wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:33am On Nov 21, 2009
becuz im don arrange rover,
u don dey swallow saliva,
ur mind dey move like jan'grova,
now 4 again ya eye im no be casanova,
babi u jus play ball go over,
use ya own hand catch palaver,
i no go cry too musch cuz mo'rova,
babes ya'kpa all-over,
wen im don chop u like gro'va,
add all ur pallys join inside d manuva,
by force u go waka dey beg 4 ur lova. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 11:39am On Nov 21, 2009
this is the new ruudie not the old one coz the new is hotter than the old. io love that.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:24pm On Nov 21, 2009
Yeah ruudie dat was a nice one. I dunno how u do it time after time. Kudos, smiley.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 11:04pm On Nov 21, 2009
Hmmmmm, Ruudie - good work. I particularly like this your one-sound rhyming sequence.

Keep it up!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:49am On Nov 22, 2009
Dat iz it @maedan
so u like it too @semid.

Topic:
we don already enta december,
special thanks to GOD 4 keeping me out of danger,
christmas don dey knock,
turkey, pigeon and hen don dey cock,
as christmas dey 4 corner,
everything don start to go higher,
u go get jeanz 4 about #2000,
while topz go dey go like #1000,
lagoz izland don turn to d busiest area,
just kno try to visit alaba,
na gutter u go meet urself,
coz pple kno dey right or left,
lastma money na b small,
na so pple dey fall 4 their destructive wall,
wel, make i wish una happy christmas,
abeg make una bring me sumtin xcept london rothmas grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:03pm On Nov 22, 2009
^^dis ur poem jus remind me of home
e no good make person dey roam
lagos na d enjoyment capital, me i know
even with d area boys & go-slow
@ adebayo, thanks 4 bringing bak d memories
time no dey,i for tell u plenty stories cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 7:16pm On Nov 23, 2009
maedan:

@ adebayo, thanks 4 bringing bak d memories
time no dey,i for tell u plenty stories cheesy

y when will you tell me
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 2:35pm On Nov 26, 2009
Nice one for the xmas season Adebayor. . . . . . really smoooth!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 1:22am On Nov 29, 2009
wow, so dis thread neva die,
i bin think say my guy dey lie
so una still dey flow d flow
and write d write,
well sha, all correct
everythin just plug inside d fun socket
make una carry dey go,
i just pop in to say hello.



@maedan,
i think might need your skills, if u game,
my emal is on my profile, holla if u interested
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 3:56pm On Dec 02, 2009
Mr olulu the playa,
plz, no mak ur heart grow fonda,
na u, rotimy nd d likes make we thank,
back in dayz, na ur rhymez wey dey 4 back,
we dey tap,
to make up a rap,
haw i which rotimy is here,
ruddie, maedan,semid nd me where there,
hmmm, what a hot thread here wil be,
even the love go dey radiate like bee,

wel, me just say make i swaley,
and also to make hay. grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 10:24pm On Dec 02, 2009
hmm
my guy adebayo
are u related to d actor kanayo?
but sha e good to know u still dey keep dis thread alive,
shows love go always survive.
e don tay way i flow last
and back in d days i use to have a blast
now i dey try turn my talent to gold
hoping d tin will b sold
but i no comot love from my heart
cos na d tin wey dey important pass for dis earth
i bin still need a woman to call my own
one wey my mama no go dis-own
so if u still dey lovable
and very portable
u fit come enter d place
make u fill up d space
then u go b my one and only
and i will neva leave u lonely
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by MyneWhite1(f): 2:36am On Dec 03, 2009
Check out this book for rhymes

You can now download a copy of the ebook here on LULU


http://stores.lulu.com/store.php?fAcctID=4531432
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 3:27pm On Dec 03, 2009
Ah, I bin fear cheesy. I think sey our reverred Myne White sef don dey wax pidgin rhymes grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:21am On Dec 05, 2009
;d ;d ;d ;d
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:35am On Dec 05, 2009
. . . sey yoruba ni e tabi ibo
are u frm osun or imo
talk naw b4 i use igo cool cool
u wan see places make we go mexico
i b a bonafide student of futo
i hot pass Ajegbe and Obanikoro
girls dey gang up as if i b Ronaldo
just agree to my offerando
kia kia i go buy u toyota kiaro,
cum nairaland, cum feel my memo
semid, olulu, maedan, ruudie dey rhyme pass I K Dairo
me adebayor, hot pass Naeto
we go take jet go do honet moon for pluto grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 1:48pm On Dec 05, 2009
my people e don tey wey i attend,
no be sey i no send,
ground no level i no go pretend,
man back dey down dey bend,
from eko all d way to southend,
d koko na jus to ruff am to d end,
do so that levelz go blend,
arrange things wey spoil to amend,
so no be only borrow we'sef go fit lend,
tight we side so e no go hard to defend,
on no pesin we go everly depend,
and the gods of we land we no go offend!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 2:26pm On Dec 05, 2009
i no be pikin again,
lai-lai xmas no fit do like rain,
nowadays e just be me too plain,
sometime sef e no dey do me gain,
but baby if i can marry u i no go complain,
na d only xmas gift wey can make me maintain,
i go happy tey i no go fit to explain,
walahi e go be me like i neva sabi pain,
to God i go run naked from Aguda to Costain,
even go baff inside tinubu square fountain,
u don gum my inside mind yonder like stain,
d luv i get for u sweet pass ripe plantain,
no one but u wey be captain,
e dey carry me up, up aeroplane,
all my life na im kpere i jus need to dey sustain.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 3:13pm On Dec 05, 2009
if u no be millipede,
or u no dey smoke igbo weed,
berra arrange ya'self with speed,
she be wetin u want, wetin u say u need,
but u no ever do am as expensive bead,
u say wetin? make i helep u to plead,
all ur problem na ur longa-throat & greed,
u go harvest from ground all ya seed,
na wetin hand work na im mouth go feed,
me i no go follow u as u dey waka lead,
and i pray ur word she no go heed,
for every wey u do her no be thing to read,
u suppose suffer wella & even bleed!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 12:35am On Dec 09, 2009
What happened to this thread? Where's everyone. Thnks Ruudie.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:03pm On Dec 09, 2009
@ fl gators,

madam no panic,
this no be titanic.
make u no afraid sey e go fall,
lai ti lai e go always dey tall.
i sure sey all man jus dey le',
dey hassle to arrange xmas dough like ko'le'.
wen time reash dem go show,
and d whole place go be like e wan blow.
luv na wan kain thing wey funny,
becuz 1ce u fall e go shack u pass money.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:48pm On Dec 09, 2009


like play like play d interest wan fade
bc e come dey taste somehow like lemonade tongue
but RuuDie dey try,
even adebayo201 no shy cheesy
so with those two i know dis thread go continue
because na plenty things dem dey add to this love rhyme revenue grin

(1) (2) (3) ... (22) (23) (24) (25) (26) (27) (28) ... (40) (Reply)

Out Of The Blue / Nephilim / Rhoda

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 50
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.