Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,206,785 members, 7,996,808 topics. Date: Thursday, 07 November 2024 at 04:04 PM |
Nairaland Forum / Flyesst's Profile / Flyesst's Posts
(1) (2) (of 2 pages)
Literature / Re: STARDOM (pidgin Story) by Flyesst(m): 8:08am On Jun 03, 2020 |
EPISODE THREE We don reach house back as i carry my phone they watch 'could this be love' one movie wey Ruth Kadiri dey like that one person go love someone then confine am for inside one room i trust mushin girls my mind drift small to Simbi i remember how she break that coca cola bottle if na mushin girls this Ken Okonko or wetin be hin name try am with dem go target am when he enter room if na clock dem see dem go break am ontop hin head ni o,my mind drift from the movie drift to my life shey na like this we go continue i ask myself make God just bring helper make he sign me for their music label make things change. I pause the movie to reason with my guys Me: Guys, how na shey na like this we go continue this kin yeye life don tire me o ab..Peter no gree make i land Peter:Oh boy no be only u so i call that engineer say shey work dey make we carry block make money small buh he talk say the house dem wan build for Ejigbo na month ending dem go run am. Efe: E no spoil na ending don reach, Sauce how your side sheybi you talk say you go meet Alaga yesterday? Alaga na one notorious guy for our street baba too like gboli! na iya chioma wey dey down our street tell me say Alaga sabi one music producer wey close with Dbanj wey fit help me Me: Omo Alaga na person? he too like gboli Efe:You mad (Efe too sick the guy go just dey gimme word anyhow, to say e no go chop am one day na lie) wetin concern you concern Gboli we dey talk about how e go take help you,us for here. Me:Okay i don hear you i go go hin house this evening. Peter:What of now he ask me, abeg make we move this yeye sitting no go do us any good. This one my brother em dey stand up en i know say no be only me things tire e don tire them too. But Alaga no be person i just hope say things go go well. ALAGA HOUSE As we reach i don sigh 'Alaga Oba Bourdillion' wey dey inscribe in front hin house, this guy sha when hin turn Tinubu i thought. Kokoko as Peter knock Kokokoko again wetin i just see one time person just open door peter run back small, me too shift back small na only Efe wey stand for where hin dey stand before Alaga open door. This guy and hin stupid guts ehn e be think say na Warri we dey naso Alaga talk o Alaga:Who be that Odeshi wey wan break my door like say hin papa no get house Omo! na wetin i no like be this o wetin concern pale for this matter now Peter:Baba no be so abeg no vex Alaga enter hin house carry one chair outside (i sight the gboli wey dey hin left hand, hin lung go burst one day na just matter of time) Alaga:Okay wetin i fit do for you? Me:Alaga o, Oba Bourdillion(King of Bourdillion), Irunmole ton fa gboli lori mainland (Demon wey dey smoke gboli ontop mainland,Alaga Baba awon stubborn (Alaga papa for stubborn pikin) baba e shanu emi omo yin(Baba help me your pikin. Alaga:Oshey! Gbera tan you know person me Alaga! anywhere dey hear my name for Lasgidi dem dey fear. (No be lie sha Iya Chioma once tell me say e get one time when police arrest one of Alaga brother wey dey do yahoo she talk say Alaga reach station even DPO sef dey fear,Alaga na one crazy person wey you no go wan vex at all. Okay my guy wetin i fit do for you he talk as hin smoke hin gboli (See smoke everywhere, Sango oo ina loju ina lenu). Me:Boss i be upcoming artist i wan make you use your connection better my life ni. Alaga:Hun! You people sabi me o no lele na because of una God create people like us,Gimme small line make i feel you. Haha this guy don bring me my food i think say if i monster my inner Drake this one no sabi English, make i go full Badoo jor naso i start. 'eh Alaga typical man everywhere e enter dey for us yanga man for the people,Irunmole fun awon boys ma beju tori Alaga ma fun e tan' (god for the boys no fly too much o Alaga go finish you) Alaga:Oshey Omo iya mi you sabi(as e dey give three of us chop knuckle) omo you don blow forget am,me go connect you with people wey go change your life. Peter:Oga thank you o, God bless you. Alaga:Forget leave God blessings, we don pass person wey dem dey pray that kin prayer for, when my mama born me na blessings water dem use bath me,na protection water dey use feed me,na long life dem give me drink(I wan ask say shey dem give am common sense but the size of hin fist like Anthony Joshua one dey scare me),no worry come tomorrow by 2:17PM we go go my guy studio no worry. Ope oo! Me:Ese oga mi, o ni baje, iba one million (Thank you boss, you no go spoil,one million tuale tuale for you) As we wan waka there Alaga resound that 2:17PM for my ear again i hear him talk say 'Wo! lo beere mi everywhere emi Alaga mi o kin waste time oo toba late 1 secs iya e cast niyen' (See! ask of me anywhere me Alaga i no dey waste time if you come late you don cast be that). As we dey movement na so we see Macaroni oo yes na the you are doing well guy. MR MACARONI Me:Omo no be the you're doing well guy be this omo this guy don get money o see hin posh chai! Peter:I hear say na this street hin papa dey live Me:Serious abeg make we no dull o na dinner opportunity be this o Efe:Na me go do the talking Warri things (When this guy go geh brain. Efe: You are doing well! Oga oga you too plenty o we dey watch you skit for Twitter omo na you be number one nobody come close. Macaroni: hahaha, you are doing well my brother (See hin teeth like bulldozer na teeth we wan see? Alaye give us money make we waka) naso he dey look us we too no comot after some minutes Macaroni:Una dey wait for person ni abi what (Oh boy! see parol o na this kin format me i no like o) Peter:Na you we dey wait for Oga hungry dey do us drop something. Omo naso Macaroni turn professor he dey drop Vocabulary for us back to back i sha know say he no wan give us money he say make we go hustle naso one skit happen there one time o as we say make we comot. One girl like that wey get bastard curve lasgidi and mami water sha! The Girl:Oh daddy freaky freaky she talk as she hug broda, daddy freaky my account and freaky me too Macaroni:Aye mi o! Ekan semi! Put your account number for here(the girl put am) you see i just send you 500k enter moto make we dey go. 500k! Just like that this guy no gree give us money for chop o! 500k for mami water as i dey para naso comedy sup o Lady : Me? Inside your car? I just need money o and you gave you thank you Oko mi (My husband) see you next time oo. Eeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeeee You dey think as Pete drop hin stupid laugh one time, me and Efe join sharp. Me: Omo see broda Efe and Peter: broda Me:Brother wey no get Akonuche Efe and peter:Akonuche Omo long laugh enter again. Naso he waka o buh i give am word sha 'Maca o je oju aye abi ma worry a ma mu e ni igboro' (Maca you fumble abi we go caught yoy for street) The rest of the day go like that hustler life as i prepare for tomorrow. Big Day! Episode 4 OTW! |
Literature / Re: STARDOM (pidgin Story) by Flyesst(m): 10:15pm On Jun 02, 2020 |
EPISODE TWO Fadeyi dey always buzz for monday morning music coming from one place to the other. Omo i don tell Iya jere make she shift her shop small to our house all this trekking no do me o who else you think say go talk am pete of course my guy too lazy,e no like stress but he be confam hustler o,name that job Pete never do he carry block for Somolu sotey hin head wan bald he do fuel attendant for Mushin sotey hin hand curve pete my guy,abegi shut upu you no geh money you still dey carry shoulder better give yourself brain Anambra boy,Efe give am one sharp i no bother talk cos na now dem go corner me i no need that kin stress this early momo. IYA JERE SHOP We don hear Davido 'One Milli' 'elo lowo ori e shogba one milli one million dollar' i no too like Davido sha when music matter enter na only DRAKE wey i respect he be my role model, i no tell una i be kind of person wey no know how to do anything even if you gimme fine bae like Beyonce i fit dey stare at her nothing go sup but MUSIC?! Chineke! hype aside i know say i dey sing e easy for me die mention any kind of Afro i go kill am raw emi ika. I stan drake and REAL MADRID eh eh eh i fit strip for Real Madrid matter o i remember the day we flog Atletico 4-2 for Champe final omo dem hear for football house that day i no get time. Where Iya Jere i dey hear Efe as he dey ask Simbi, simbi bad girl she get that figure 8 wey fit run you mad but her gist full street sha dem dey polash am steady steady all this G-boys most especially i no too blame am sha her boss gan nko iya Jeremiah herself after shey she sabi cook and she sabi music polash(Sex) na next time she know how to do i remember the day i caught am for one hotel one saturday like that the boy she carry come very young lasgidi sha and hin doings. Efe and Peter once yarn me say she dey trip for me but me i change am for them that day which kain yeye trip be that dakun,she dey kitchen Simbi reply Efe. Abeg call her for us na now she go dey shout dey person enter her kitchen,naso she come oo iya Jere herself! she just dey add weight anyhow the Vitamin D she dey collect from all the young boys for the street dey enough to dey run am sha. Me:Iya Jere morning o Iya Jere: Three Jolly Furends morning o Chai this woman sha English na by force what is Furends radarada and this jolly friends of a thing we no be pikin na, na peter voice short my thoughts Peter:Iya Jere abeg we don come as usual money no dey now but we go pay before tomorrow morning. The kin eye Efe give Pete fit kill sha, money wey no sure this week sef Iya Jere:ha! It's too early o but because its you people i go do for God Funke! I wan give am voice i go do for God? shey English na by force ni? E necessary? But i won't give more than 2,000 food o That one too go do i reply am. She gave us Eba but me na fufu i request for when food no sure again tomorrow na fufu fit do am As we sit dey chop naso i sigh Jide wey sit for left side of Iya Jere canteen though he no sabi me buh me i know am very well na hin dey polash all virgin girls wey dey our street the day dem go reason hin matter for Twitter dey come. Two girls dey approach the canteen be like say them wan eat i am not surprised sha iya jere food too sweet even rich men dey come her shop come eat i see am Jide dey look them as dem dey come i be dey think for my mind say the guy wan carry out hin mission like always buh omo na lie he don do mission already na yawa of mission con gas oo abeg call Instablog quick Jide As i dey look everyone inside the canteen dey chill naso i sight dey the TWINS chai ekan semi! they are definitely coming to the canteen or has something to do here he remember how e run home and away project for this ladies they just finish their secondary school last year o Taye no know say he know kehinde, kehinde too no know say he sabi taiye wetin spoil am be his sex appointment with Kehinde this thursday why e go be just one door enter this canteem sef he thought if yawa gas Iya Jere go here from him. He use hin left hand cover hin face buh he leave camouflage for Ruth Kadiri when he realize say all eyes inside the canteen are on him, he slowly look his back omo! dem no come to eat o e be like say dey don discover things o. Taiye: Epele (sorry) Mr Jide wey know how to sex people like say me and other girl wey dey this street no do you enough you dey do me dey do my twin sister. Ha! People wey dey the canteen exclaim some who knewJide arent suprised no be today he e do am. Kehinde :come see today we go show you pepper after all the love, affection i give you the police are on there way you this son of a b***ch the remaining pepper pepe no show Van Djik we go show you. Jendor kinni mo gbo to se yen (Jendor wetin i hear say you do) na one voice from the kitchen talk o wey turn out to be Simbi. SAUCE and hin guys don smell say e go turn physical soon,sauce don know sha as e enter simbi leave even if Odumeje cross river wahala go sup already mushin ladies mad no be small Simbi:Jide! you wey i aborted 10 pregnancies for you all men wey dey f**k me for this street na you i dey give the money! you promised me better life, yoy say you go get job me and you we go go Abuja so you've been sleeping around with girls in this street including twins for that matter you go hear today i no be mushin for mouth. Simbi enter sharply their shop go find Coca-Cola bottle (po) break am for ground you go hear today Iya Jere dey shout no fight for here o no fight for here as she no fit carry her body just dey amuse Efe. Omo yawa gas o if not for police intervention Simbi say she wan comot Jide pr*ck ni sha by fire by force emi liquid metal since one bad experience inside Lagos Poly i no dey stay for where fight dey sub again,but come trouble too dey this monday o to think say 12 just knack! Episode Three OTW! No view alone drop comment mbok na beg i dey beg o |
Literature / Re: STARDOM (pidgin Story) by Flyesst(m): 8:01pm On Jun 02, 2020 |
********************************************* Omo Pete blow send me go sleep ni sha but the worms wey dey fight Royal Rumble for my stomach wake me there must be Roman Reign in this stomach sha because the way the worms are aggressively fighting ehn, i drag body enter sitting room o i know say this guy called EFE e no get brain e go still bring up wetin sup earlier why i attempt to punch pete sef i regret that move but himself suppose chop am he disrespect Indaboski father na radarada. Guys wetin sup i asked them as i enter, hehehehehehe na so Efe dey laugh this him contagious and stupid laugh e go chop am one day Aje! the guy dey ontop my neck of recent. Why you dey laugh like Aro patient o i ask am, omo na one you chop o wey make you go sleep open mouth o he reply. Oh boy! He enter o eeeeeeeeeeeeeeeeeeee, pity am na e be our guy the war himself eeeeeeeee pete adds with another in the rubbish, in the nonsense laugh. Omo see as dem dey drag me this one pass Twitter drag o twitter dey forget thing but my brothers next year dem fit use am drag you. Una foolish sha shey na that one remain now worm dey fight WWE for my stomach o, my guy no be only you o na our last 1k we use chop yesterday pete reply me. Omo wetin i been dey think be say make we go Iya Jeremiah shop she go reason with us. Omo oya movement! Quick! I don use this one finish episode one, two next! make una no vex. One gbege go sup for Iya jere shop omo e go chock una 1 Like |
Literature / STARDOM (pidgin Story) by Flyesst(m): 7:06pm On Jun 02, 2020 |
STARDOM Episode ONE 7:47 AM for inside one street like that inside lagos Omo me i just dey wake o and na noise wake me o lagos and this hin noise sha make i stand up go bathroom go piss jare,i pass through our sitting room i sight peter wey serious with hin phone i know say the mumu don dey play mili militia again imagine 8 neva knack o when this guy go get life i see my guy efe too wey dey one corner dey scratch his thing the guy no sabi when country dey talk at all na to polash be hin own . Make i sharply introduce you to my brothers EFE: My guy himself if dey talk say wetin Efe hate pass for hin life na say hin dey bear same name with Efe BBNaija my guy go talk say "how person go collect 60 mila or how much dem give am just lavish am like that hin con sing with Badoo dey shout warri warri dem must hear am now, abeggi leave warri make warri dey warri" . Peter:This one na Mr Frank Donga of our gang, the mumu too funny and e dey fear like but if you wan monster hin anger call him Pete yawa go gas one time my guy go change am for you. And me una wan know my name abi? na me dem dey call the war! Indaboski lomo! lion from origin! Emi liquid metal! una dey think Odumeje omo e no trademark am anybody fit use am my name na Effiong Success but my guys dey call me SAUCE my papa na confam warri born my mama na from Ojuelegba for lasgidi but both of dem no get craze sha but me eni gangan ni crazy. I met my guys for lagos polytechnic na ND we do wey we comot for those of you wey dey think say i wake up 7:47 when i suppose dey place of work or dey on my way no think am i be hustler to the core product of LASWARRI no think am o, good morning i dey greet caro as i dey come from bathroom caro caro she fine die i wan date am before buh peter yarn me say na landlord dey chop her work. Lemi tueh! tufiakwa! I no fit chop work wey landlord dey chop. Una good morning i greet my guys as i enter, the way dem reply i dey suspect something already even peter pause hin yeye game reply good morning na them sabi sha i move to the container where we dey keep foodstuff no mind me which yeye foodstuff hustler dey get if no be garri, na yesterday i keep am say i go use am step things this morning oo. Omo! Shey una dey see wetin i dey see sha? my hand dey touch nylon buh i no feel garri haha chineke o! ekan semi! so na why this f**kas dey greet me dey hail me be this?! Chai! Buh see those idiot go suffer today una go know why i dey call myself INDABOSKI! Pete! Guy come you mad why you swallow my garri? Baba drop phone sharply challenge mi o i know say i don ginger hin adrenaline,you mad who swallow your garri shey i no tell you say never for your life for your papa life make you no call me Pete again. Oh boy this guy don enter am e drag my pale join Effiong Chukwuemeka himself, i charge toward him with my fist i wan dash am one naso efe hold my hand omo na this kin thing me no like o! Omo why you hold me na free me make i show am say dem no dey drag Chukwuemeka for matter, sauce na your guy na free am but the garri you dey talk na me chop am Efe reply me, gbege o! Yoruba dey talk day 'Isu eni lon towo eni bo epo"i no think Efe at all na peter like food die among us . Omo na gbos i hear pete dash me one sweet punch like that liquid metal don fall o! guy why na i sit for floor dey stretch my hand ask peter with the why na face, that one go tell you say next time you go ask before you challenge person cos i like food no mean say na me dey chop every food for house na come make i help you up i shove hin hand as i dey eye efe at the same time, what you wan revenge me i don chop o you never chop o you be half warri i be full warri i go run warri package for you i don give pete bragging right for the week first i no wan give Efe too i just waka go room jejely. But Efe hin mouth too much sha i go show am level one day Make i pause small Chapter two on the way! |
Phones / Re: US To Approve Sale Of Huawei Phone With Licenses by Flyesst(m): 8:26am On Jul 11, 2019 |
China no be Iran! 28 Likes 2 Shares |
Celebrities / Re: "Being A Woman Is Hard Enough But Being A Woman In Nigeria..." - Adesua Etomi by Flyesst(m): 7:45am On Jul 04, 2019 |
Sense is far from so people,she talked about how being a woman is hard you are talking about how her husband married her atleast she got a sensible husband whose lifestyle is not on going from one slut to slut, a husband who is not high on drugs to post those shit you've posted |
Celebrities / Re: Nigerians React As Teni Loses BET "Best New International Award" To Sho Mad Jozi by Flyesst(m): 8:06am On Jun 24, 2019 |
Not be today BET dey Rob Naija go ask wizzy |
Celebrities / Re: "Without Drake, Nobody Knows Wizkid In America" – Road Podcast Says by Flyesst(m): 6:13am On Jun 24, 2019 |
thesicilian: Like he paid Chris Brown,Future,Metro Browmin,Normani and host of USA/UK artiste he collaborated with too? You need to reason more bro |
Celebrities / Re: Joro: Wizkid Looks Cute In New Photos, Set To Drop New Song by Flyesst(m): 1:50pm On Jun 20, 2019 |
Sense is out of this platform for long! Only a few that still has it give reactions to topics with a sincere mind, from A-Z of the comments so far many gave reactions base on hate, sentiment but true you can only do this in our small nairaland village don't go Twitter and say shit about starboy cos his fan gonna give you more than you want. And all the way someone said Wizkid don't know how to dress? Lol,sense is useless when you lack wisdom. If many of you don't know his baby baby,mama mama and trashy songs are giving him awards and recognition he deserves,if you are at the peak of your game hate is free. 1 Like 1 Share |
Celebrities / Re: What’s Happening BTW Wizkid, Davido & Tiwa? – Davido Snubbed On His Birthday!! by Flyesst(m): 8:27am On Nov 22, 2018 |
Check Tiwa Insta Story Alaye..Before Splitting Shit���� |
Celebrities / Re: Wizkid Slams His Baby Mamas: "God pls save me from the money hungry ones" by Flyesst(m): 7:26pm On Sep 10, 2018 |
Why IS Jada Not Moaning? She Don't Even Need Nigga Support Ffs�.. Build Her Own Life If You Are Big,You Big For Life 2 Likes |
Celebrities / Re: Wizkid's Baby Mama Blasts Him After His 'Star Boy' Jerseys Sold Out In 10 Minute by Flyesst(m): 7:23pm On Sep 10, 2018 |
If You Are Cheap..You Are Cheap For Ever This Fools Claim He Gives Out A Milli Support Per Month And Them Clowns Be They Shout "No Support, No Support" Imma Use Your Brain Not Ya Body |
Celebrities / Re: Starboy Wiz Kid And His Baby Mama Jada Pollock Unfollwed Each Others On Instagra by Flyesst(m): 6:01pm On Jul 16, 2018 |
Jada that wizkid like her hbd post 50mins ago on insta |
Celebrities / Re: OAP Dotun Calls Out Hotfm OAP An A**kisser Over Comment About Yemi Alade & Tiwa by Flyesst(m): 7:02pm On Jul 12, 2018 |
Factttt |
Celebrities / Re: Wizkid Rock Star Boy Necklace In New Adorable Photos by Flyesst(m): 8:59pm On Jul 08, 2018 |
Release Song Jorrr������ |
Celebrities / Re: Davido Promise To Beat Wizkid At O2arena And Set The Stage On Fire by Flyesst(m): 8:57pm On Jul 08, 2018 |
If you like Burn London..That doesn't makes u d best,instead of doing things because Wiz does be the Game Yourself and stop your arrant bragging |
Celebrities / Re: Wizkid Buys 400M Naira Wrist Watch. Wow by Flyesst(m): 10:03pm On Jan 24, 2018 |
LagosCiti:Still Trying Hard To Be A Savage Though, A Celeb Can Lie But What You Dont Know Dont Say. Davido Too Lie La,Everybody Lie |
Celebrities / Re: Wizkid Buys 400M Naira Wrist Watch. Wow by Flyesst(m): 9:57pm On Jan 24, 2018 |
LagosCiti: Ya Pain? So Wizkid Get Properties Pass Davido? Ahahahahahahah |
Celebrities / Re: Wizkid Buys 400M Naira Wrist Watch. Wow by Flyesst(m): 9:55pm On Jan 24, 2018 |
SalamRushdie:Bros..What Do You Knw About Musicians? |
Celebrities / Re: Wizkid Buys 400M Naira Wrist Watch. Wow by Flyesst(m): 9:52pm On Jan 24, 2018 |
Can Someone Tell This Idiots That Wizkid Is Valued Above Davido In 2017 Forbes List? If Davido Makes 500m From A Show Then Wizkid Need Just A Should To Buy This. |
Celebrities / Re: Poor Attendance At Wizkid's Concert In Botswana (Photos) by Flyesst(m): 10:03am On Dec 03, 2017 |
Why You Mumu Like Dis? Wizkid Neva Do Any Show For Dah Country Yet..Man Just Arrive Sef |
Literature / Re: Fight For The Bride..[love Saga] by Flyesst(m): 12:06pm On Nov 14, 2017 |
Divineroyalty: Noted.. |
Literature / Re: Fight For The Bride..[love Saga] by Flyesst(m): 10:43am On Nov 14, 2017 |
Back In Nifemi Office.. She Narrate Everything To Daniel From How..She Beg Her Mother To Pay Mic School Fees When His Family Couldnt Afford It. Daniel-It's Okay..He Step Up,You Too Do The Same. Nifemi-Thanks Mister.,by The Way What's Your Post Here Daniel-Director Nifemi-Direc? Amazed.. Daniel-You See..That Lady You Met In That Office Is Named Eva...She Is Married To The G.M..But With Mic Fully Know He Can Have It All Being Eva Husband Nifemi-But How Do You Know All This Daniel-Eva Is My Young Sis.. Nifemi-What? Daniel-Hum..Am Out Of Here..I Will Pick You Up For Lunch..He>Exit * Nifemi-Wonders..Buh I Will Be Strong..I Must Move On Too.. Lemme Check This File.. Pls Corrections Are Importants..Thanks |
Literature / Re: Fight For The Bride..[love Saga] by Flyesst(m): 10:26am On Nov 14, 2017 |
Daniel Ran After Her..Then Knock.. But She Refuse To Open..Just Then He Open The Door.. Daniel-Lady,Any Problem. Nifemi-He He He Is My My Just Then Hot Tears Again He Ran To Her And Hug Her --------------- After A Hot Round Of S3x.. Eva..The YoungLady Earlier Eva-Buh Mic..Who Is That Lady To You..From The Way I Meet You Two..What Is Going On With You Micheal-Even If I Want To Cheat On You,Not With A Lowly Secretary. Eva-You Better Not Cheat Ni Oo .....------ Tbc |
Literature / Re: Fight For The Bride..[love Saga] by Flyesst(m): 10:09am On Nov 14, 2017 |
Nifemi-Micheal! She Muttered. He Is Her Ex-Boyfriend Who Dump Her For A Rich Man Daughter.. Hey! What Are You Doing Here-Mic Countered With Suprises. Nifemi-Am..Am The New Secretary. Mic-Sec What! She Was About To Reply When A Lady In Mid-Twenties..Enter Without Knocking. Lack Of Respect,She Thought.. Sweetheart! What Is This Scene About-She Called.. Okay You Take This File And Work On It..Micheal Said To Nifemi. Is She? Nifemi Said.. She What? Are You Okay? Its Your First Day Here..Dont Get Me Angry.. Micheal Said Angrly.. She Was Over To Him..And Give Him A Deep Kiss...Nifemi Had Her Eyes Wide Open And Her Hand Covering Her Mouth.. What Are The Doing Here? The Lady To Nifemi, When Two Lovers Are Kissing,You Ought To Give The Privacy..She Continued. Now Get Out-Micheal Ordered.. She Ran Out Of The Office Immediately..With Hot Tears Running Through Are Cheek.. She Was About To The Corner Again When She Bump Into Someone Again.. You? Again?.-No One Than Agbaje Daniel Daniel-Wait Are You Crying,What's Wrong Dear.. She Try To Say Something..But She Couldn't Just Find The Right Words..She Just Ran Straight To Her Office.. Tbc |
Literature / Re: Fight For The Bride..[love Saga] by Flyesst(m): 9:54am On Nov 14, 2017 |
Her Mind Occupied With Many Thought...She Was About To Enter The Company When She Bumped Into A Young Man.. He Is Handsome To Heaven[Lol],His Dimples Is Enough For Lunch.. The Young Man Noticed The Lady Has Been Carried Away Maybe With His Handsome And Pretty Face. Oh! Sorry..He Muttered. "Out Of Her Thought" I Should Be The One Saying Sorry She Replied Immediately. Daniel Agbaje Is The Name-The Young Man Introduced Oh! Nifemi Olarewaju Nice Meeting You-She Replied. Daniel-Are You New Here? Nifemi-Yap..Oh! Sorry Yes.. Daniel-Or,The New Secretary? Nifemi-Yes..Seems You Are Expecting Me..She Smiled Daniel-Anything More Than Sorry Is Overstatement. Nifemi-Ok Then,See You Later. She Get To The Her Office..Close To The G.Manager Own. She Quickly Say Her Prayer.. Just Then The Intercom Rings 'Report In My Office In 5mins'. Nifemi-Ok Sir It Is The General Manager. She Get There And Meet A Face She Recognised Immediately. Who Did She Meet? Tbc |
Literature / Fight For The Bride..[love Saga] by Flyesst(m): 9:40am On Nov 14, 2017 |
She Has Date Many Guys During Her Secondary School And University Days. She Completed Her N.Y.S.C Last Month,Then Applied For A Job In A Business Firm In Lagos. Unfortunately,The Accountant Post Is Applied For Has Been Pre-Occupied.. But She Was Given A Job As The Secretary Of The Company Today Is Her First Day At Work.. Take A Breath Lets Go 1 Like |
Literature / Re: Advocate OF Justice.:( Blockbuster Of The Century by Flyesst(m): 10:56am On Nov 09, 2017 |
A Big Building..Containing Many Apartments.. 3hrs Ago Marcus And His Two Mens Were Carrying Out Their Investigations, When A Call Was Pull Through Marcus.. Sir,Miss Mirabel Car Has Been Found. Officer Ben Announced To Marcus Through Phone.. Dolapo,Bash..Lets Go,Marcus Told His Guys The Two Follow Their Boss Gently. Hey Ben,Text Me The Address Of The Place Right Now..Marcus Said Authoritatively.. Where The Place Mirabel Car Was Found.. After Searching The Car For A Clues, They Couldnt Find Any.. How About Searching These Area? Bash Suggest. What Do You Mean,This Place Is A Bush Man..Dolapo Replied And You Expect A Kidnapper Hideout To Be An Open Place..Bash Again.. Bush Or No Bush We Are Going To Attempt..Marcus Told His Two Guys After Almost 2hours Inside The Bush..'The 3' Locate A House.. And That Must Be It...Dolapo Announced.. Back In The Kidnappers Building! Let Me Take A Drink |
Literature / Re: Advocate OF Justice.:( Blockbuster Of The Century by Flyesst(m): 10:26am On Nov 09, 2017 |
The criminals seeing Marcus John and team,tried to fight them.. But they are never a match for Marcus Men.. --- Detective Dolapo-Part Of Marcus Team..30years, Very Experienced And Intelligent. Officer Bash-A Pot-Bellied Officer That Can Make Joke A Dead Point.. ------ Do you think we can make it outta here if we decided to fight upto 60-70men in the this house? Dolapo asked. It's Either We Make A Perfect Escape Or We Destroy Them Perfectly..Marcus Replied.. But 3 Of Us Cant Attack Upto 60men And You Expect Us To Make It Out Of Here Alive...Detective Dolapo Countered.. Took A Sight At His Wristwatch, Then The Innocent Lady On The Floor.. Marcus Took Her Hand..And Drag Her Up.. We Will Be Attacking As We Make Escape.. D.Dolapo Tried To Counter His Boss Speech Again But Marcus Is Already Making His Way Out |
Literature / Re: Advocate OF Justice.:( Blockbuster Of The Century by Flyesst(m): 10:07am On Nov 09, 2017 |
Wait! you beast what are you trying to do,the lady look up to see who is her saviour. [Lady] Name;Mirabel Martins Daughter of the richest man in Nigeria.. ----------------------- She has been reported missing since 3 days ago..after investigation upon investigation, the kidnapper's hideout was detected. ------- Name; Marcus John A Nigeria-U.S born. Studied Criminology In [UNN] Nsukka.. What Is Going To Happen? Is Marcus John and his team going to safe Mirabel in a big compound? with more than 70 guards in the house,is he going to safe Mirabel and make a perfect escape? Just take a deep breath and and and WATCHOUT!! |
Literature / Advocate OF Justice.:( Blockbuster Of The Century by Flyesst(m): 9:52am On Nov 09, 2017 |
*Prologue No part of this story should be reproduced without the consent of the writer. what to expect? Crime! Love! and most important one or two lessons. This is my first story and being a Science student,all corrections will be accepted. |
(1) (2) (of 2 pages)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 109 |