Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,171,438 members, 7,881,581 topics. Date: Saturday, 06 July 2024 at 12:37 AM

Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) - Crime - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) (1325 Views)

More Pictures Of The Army Couple Killed By Unknown Gunmen (very Graphic Picture / Offa Robbery: Quarrelling Couple Killed At Police Station / Couple Killed Along With Others By Fulani Herdsmen In Taraba. Graphic Photos (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by ManirBK: 5:30pm On May 09, 2022
BBC disinformation unit don confam say true-true dem kill army
Private Gloria Matthew, her fiancé, Warrant Officer Linus Musa Audu (Retired) and two of im relatives for di Orlu axis of Imo State, southeast Nigeria.

One family member of di couple wit first-hand informate of wetin
happun tell BBC for one interview say di killing happun afta some four armed youths attack dem not far from Banana Junction for Orlu, Imo State.

"E happun around three in di afternoon. Dem bin dey travel to
Nkwerre from Lagos," di pesin tok.
E also confam to BBC disinformation unit say di couple and dia
family members bin dey travel for di traditional marriage rites of
Private Matthew and Audu wey suppose happun on Monday May 2nd for Nkwerre Local Government Area of Imo State.
"Audu na from southern Kaduna but e dey live for Makurdi. Gloria
base na for Sokoto. Dem bin arrive Lagos from Kaduna on di 26th of
April to pick Gloria mama so dem go fit travel together for di
traditional marriage rites," di source tell us.
But e no dey sure whether dem kill Ms Matthew and her fiancé on di
30th of April or on di 1st of May, but confam say dem see foto of her
deadi bodi on her WhatsApp status on di 1st of May.
Dis na afta di killers direct dem to am wen dem answer di repeated
calls to Private Matthew phone.
Dem also kill "Linus' relatives dat day. Di leader of di armed men
order make dem shoot dem. Dem kill dem for front of Gloria 10-year- old daughter and her mama," di family member tok.
Di Army tok-tok pesin Onyema Nwachukwu bin earlier post am for di
Nigerian Army verified Facebook confam di murder of di sojas.
Nigeria army condemn di killing of two of dia sojas at di hands of
gunmen for Imo State, southeast Nigeria.
Di army for statement say di two sojass - Master Warrant Officer
(MWO) Audu Linus (retired) and Private (Pte) Gloria Matthew, bin dey on dia way to di south-eastern Nigerian state to Imo state for dia
traditional wedding wen di incident happun.
For inside statement wey di army release on Tuesday 03 May, 2022
dem say dem receive report of di incident on Saturday 30 April 2022.
Di army say di gunmen no even "use dia head" even as dem find out
say officer Gloria come from Nkwerre local goment area of di state.
Di Nigerian Army and Nigerian President Muhammadu Buhari don
accuse The Indigenous People of Biafra (Ipob) and im armed wing di Eastern Security Network (ESN) for di killing of di couple.
Ipob deny responsibility
Almost a week afta di video first appear on social media, one
conspiracy theory say dem stage di killings go viral on social media.
Conspiracists say di video dey staged and for dia tok, dem say di
killings for inside di viral video happun for Cameroon.
Meanwhile, careful observation of di video of di killing no show
evidence say di audio na fake as di conspiracies dey suggest.
We see Late Private Matthew dey clearly respond to di commands of
di voice of one man wey appear to be di leader of di armed men.
Also, di ambience of di video confam say dem no edit am.
Di movements and sounds for inside di video match well-well.
Na one Facebook user, Chidi Calibin first post di claim on Facebook
on May 7 2022.
Di post gada 1700 comments and 1000 shares in 24 hours.
Pro-Ipob handles on Facebook and Twitter also share one screenshot
of di wedding invitation of di murdered couple and claim say e show
evidence say di tori na false.
Di social media users dismiss di tori say di couple no fit dey travel to
Imo State for southeast Nigeria on di day dem suppose do dia
marriage for Makurdi di capital of Benue State for northcentral
Nigeria.
But di family source confam say di invitation letter na genuine.
E add say dem cancel di wedding for Makurdi because Private
Matthew no get clearance from di army in time and dem need do di
traditional rites first.
"Dem even delay di traditional rites sake of say as per Igbo tradition,
dem need check di date to dey sure say e correspond wit di market
day wey marriage rites fit happun for di village," di source tok.
Private Matthew join di Nigerian Army for 2019 and Warrant Officer
Audu recently retire, according to di family.
Dia killing na part of di latest for Nigeria southeast wia armed men
don target security officials and civilians.
More dan two dozen security officials and civilians na im gunmen
don kill for attack for di southeast between January and April 2022.

https://www.bbc.com/pidgin/tori-61376132

mynd44 oam4j lalasticlala seun seunmsg
OyigboUpdate OyigboUpdate2
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by ManirBK: 5:30pm On May 09, 2022
IPOB why Brutal killing
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by Malory: 5:31pm On May 09, 2022
How can someone read this piece of junk above?
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by Jennyjay283: 5:34pm On May 09, 2022
Indigenous people!!
Is this name for fancy?
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by Mooh247: 5:35pm On May 09, 2022
E no go better for all the people wey support this gruesome murder and all the people wey dey try cover am

1 Like

Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by tit(f): 5:36pm On May 09, 2022
"BBC Disinformation Unit"

Ok
continue
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by tit(f): 5:39pm On May 09, 2022
ManirBK:
BBC disinformation unit don confam say true-true dem kill army
Private Gloria Matthew, her fiancé, Warrant Officer Linus Musa Audu
(Retired) and two of im relatives for di Orlu axis of Imo State,
southeast Nigeria.
One family member of di couple wit first-hand informate of wetin
happun tell BBC for one interview say di killing happun afta some four
armed youths attack dem not far from Banana Junction for Orlu, Imo
State.

"E happun around three in di afternoon. Dem bin dey travel to
Nkwerre from Lagos," di pesin tok.
E also confam to BBC disinformation unit say di couple and dia
family members bin dey travel for di traditional marriage rites of
Private Matthew and Audu wey suppose happun on Monday May 2nd
for Nkwerre Local Government Area of Imo State.
"Audu na from southern Kaduna but e dey live for Makurdi. Gloria
base na for Sokoto. Dem bin arrive Lagos from Kaduna on di 26th of
April to pick Gloria mama so dem go fit travel together for di
traditional marriage rites," di source tell us.
But e no dey sure whether dem kill Ms Matthew and her fiancé on di
30th of April or on di 1st of May, but confam say dem see foto of her
deadi bodi on her WhatsApp status on di 1st of May.
Dis na afta di killers direct dem to am wen dem answer di repeated
calls to Private Matthew phone.
Dem also kill "Linus' relatives dat day. Di leader of di armed men
order make dem shoot dem. Dem kill dem for front of Gloria 10-year-
old daughter and her mama," di family member tok.
Di Army tok-tok pesin Onyema Nwachukwu bin earlier post am for di
Nigerian Army verified Facebook confam di murder of di sojas.
Nigeria army condemn di killing of two of dia sojas at di hands of
gunmen for Imo State, southeast Nigeria.
Di army for statement say di two sojass - Master Warrant Officer
(MWO) Audu Linus (retired) and Private (Pte) Gloria Matthew, bin dey
on dia way to di south-eastern Nigerian state to Imo state for dia
traditional wedding wen di incident happun.
For inside statement wey di army release on Tuesday 03 May, 2022
dem say dem receive report of di incident on Saturday 30 April 2022.
Di army say di gunmen no even "use dia head" even as dem find out
say officer Gloria come from Nkwerre local goment area of di state.
Di Nigerian Army and Nigerian President Muhammadu Buhari don
accuse The Indigenous People of Biafra (Ipob) and im armed wing di
Eastern Security Network (ESN) for di killing of di couple.
Ipob deny responsibility
Almost a week afta di video first appear on social media, one
conspiracy theory say dem stage di killings go viral on social media.
Conspiracists say di video dey staged and for dia tok, dem say di
killings for inside di viral video happun for Cameroon.
Meanwhile, careful observation of di video of di killing no show
evidence say di audio na fake as di conspiracies dey suggest.
We see Late Private Matthew dey clearly respond to di commands of
di voice of one man wey appear to be di leader of di armed men.
Also, di ambience of di video confam say dem no edit am.
Di movements and sounds for inside di video match well-well.
Na one Facebook user, Chidi Calibin first post di claim on Facebook
on May 7 2022.
Di post gada 1700 comments and 1000 shares in 24 hours.
Pro-Ipob handles on Facebook and Twitter also share one screenshot
of di wedding invitation of di murdered couple and claim say e show
evidence say di tori na false.
Di social media users dismiss di tori say di couple no fit dey travel to
Imo State for southeast Nigeria on di day dem suppose do dia
marriage for Makurdi di capital of Benue State for northcentral
Nigeria.
But di family source confam say di invitation letter na genuine.
E add say dem cancel di wedding for Makurdi because Private
Matthew no get clearance from di army in time and dem need do di
traditional rites first.
"Dem even delay di traditional rites sake of say as per Igbo tradition,
dem need check di date to dey sure say e correspond wit di market
day wey marriage rites fit happun for di village," di source tok.
Private Matthew join di Nigerian Army for 2019 and Warrant Officer
Audu recently retire, according to di family.
Dia killing na part of di latest for Nigeria southeast wia armed men
don target security officials and civilians.
More dan two dozen security officials and civilians na im gunmen
don kill for attack for di southeast between January and April 2022.

https://www.bbc.com/pidgin/tori-61376132

mynd44 oam4j lalasticlala seun seunmsg
OyigboUpdate OyigboUpdate2


ManirBkir reporting for BBC Disinformation Unit
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by 9gerian: 5:41pm On May 09, 2022
It appears the outrage over this particular killings may have calmed down the groups small. The only report I’ve seen today (online) was that of a vehicle being burnt down perhaps to enforce the sit at home order…



Malory:
How can someone read this piece of junk above?
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by doggedfighter(f): 5:47pm On May 09, 2022
Disinformation unit grin grin grin grin grin
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by Pierocash(m): 6:08pm On May 09, 2022
I watched the video of the beheading of that beautiful woman. Those guys are really beasts and heartless. They slaughtered that young woman like ram while Alive. Tied her hands and put a knife on her neck and cut it off.

Those evil guys must not go Scot free

2 Likes

Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by Polynek(m): 6:22pm On May 09, 2022
Dox guys died hurribly cry
May there soul rest in peace
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by Nobody: 6:23pm On May 09, 2022
If na American police,dem for don unmasked the killers.
Re: Army Couple Killed In Imo State: Family (BBC PIDGIN) by Nobody: 7:08pm On May 09, 2022
Pierocash:
I watched the video of the beheading of that beautiful woman. Those guys are really beasts and heartless. They slaughtered that young woman like ram while Alive. Tied her hands and put a knife on her neck and cut it off.

Those evil guys must not go Scot free
They didn't stop there, they slice her pvssy join. Very barbaric, May Amadioha struck all of them

1 Like

(1) (Reply)

49-yrs-old Man Arrested For Impr€gnating His 14-yrs-old Daughter(photos) / Kenyan Man Stoned To Death After Beheading His Girlfriend Over Infidelity / Police PRO Reacts To Viral Video Of Man Giving A Baby Marijuana To Smoke

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 42
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.