Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,201,858 members, 7,980,007 topics. Date: Saturday, 19 October 2024 at 11:07 PM

Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day (3074 Views)

Sexdoll Sexdoll ..NL Male Abeg Wetin Come Happen / Samyj247: Abeg, Wetin Imo State Ladies Do You? / A Girl Ask Me To Explain Masturbation For Her ( Abeg Wetin I Go Do) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (Reply) (Go Down)

Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Menemonic: 4:38pm On Jul 15
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


🙏🙏🙏

5 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by FaceTanke: 4:42pm On Jul 15
Beating...

50 Likes 1 Share

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by WhiteIverson: 4:44pm On Jul 15
Garri and okpa
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Snowx: 4:47pm On Jul 15
Lol...read a book titled Unago C. Shege

27 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Weezyclan(m): 4:47pm On Jul 15
Three leaf yam

1 Like

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Iamanearthling: 4:49pm On Jul 15
Cocoa yam and sweet potatoes. Drink plenty water.

2 Likes 1 Share

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by NiRfreak(m): 4:49pm On Jul 15
Two cups of garri....leave am for water make e swell for 15 mins, then pam am with 200 naira ground nut ..
.
Ur belle go rest for the next 24hrs..tank me later

6 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by RealityKings: 4:49pm On Jul 15
Koboko or Bulala

1 Like

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by EmekaBlue(m): 4:50pm On Jul 15
Na to dey drink enough cheap ogogoro ...e dey block belle! then substitute eating food like 3times a week

4 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Tokskob2008: 4:50pm On Jul 15
FaceTanke:
Beating...
grin grin grin

7 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by RealityKings: 4:50pm On Jul 15
EmekaBlue:
Na to dey drink enough cheap ogogoro ...e dey block belle! then substitute eating food like 3times a week


You are playing with your kidney and liver

10 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by EmekaBlue(m): 4:53pm On Jul 15
RealityKings:



You are playing with your kidney and liver
with enough sweating exercise... The toxins normally sweat out! Thank God I have stopped such life though
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by brain54(m): 4:56pm On Jul 15
NiRfreak:
Two cups of garri....leave am for water make e swell for 15 mins, then pam am with 200 naira ground nut ..
.
Ur belle go rest for the next 24hrs..tank me later
This one na suicide mission o...
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by drmikeadams(m): 5:11pm On Jul 15
Menemonic:
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


🙏🙏🙏

Go restaurant buy garri and soup.make them put am for nylon..the nylon measurements dey pass wen them put an for plate.. grin if u reach house make another eba or buy fufu..divide the soup into 2.. chop noon and night.smoke cigar sleep

21 Likes 2 Shares

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by DevilsEqual(m): 5:13pm On Jul 15
WhiteIverson:
Garri and okpa

Bread and Okpa actually

U no go drink water till u chop am finish

Make sure say u mold am sotey, na force u dey use swallow am but stiil no drink water, add another one join am till u finish am. Con drink like 2 sachets of water

8 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Menemonic: 5:15pm On Jul 15
drmikeadams:


Go restaurant buy garri and soup.make them put am for nylon..the nylon measurements dey pass wen them put an for plate.. grin if u reach house make another eba or buy fufu..divide the soup into 2.. chop noon and night.smoke cigar sleep
idea..

But the bolded, NO.. Not smoking
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by OfficialP: 5:21pm On Jul 15
it's well dear. Drinking top tea reduces appetite for food, try it.

1 Like

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Normally3D: 5:29pm On Jul 15
Menemonic:
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


🙏🙏🙏
Try this and thank me Later

1 Share

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Dshocker(m): 5:30pm On Jul 15
Buy 1 cup of garri, then soak it overnight with 1ltr of water, by tomorrow morning, the garri would have multiplied by 5×.

If you no belleful, make i know wetin cause am 🤣
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Menemonic: 5:31pm On Jul 15
Normally3D:

Try this and thank me Later
if I can afford this then why all the thread for..

This is luxurious..

2 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Nemesis0147(m): 5:48pm On Jul 15
Beans and roasted yam.

3 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Anguldi(m): 5:54pm On Jul 15
Agbado, EWA ati cassava

1 Like

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Elliotwaveforec: 6:04pm On Jul 15
Chai! Nlanders no go wound person with laugh.

Country hard gan.

2 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Elliotwaveforec: 6:06pm On Jul 15
Nemesis0147:
Beans and roasted yam.
Beans na no go area! Even more expensive than rice.

1500 per derica - Beans
1200 per derica -. rice.

Who dey chop beans before? Na big man food now.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Vergovert: 6:09pm On Jul 15
Apple will give you all the nutrients you need for a day, according to science.

2 Likes

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by okoroemeka(m): 6:13pm On Jul 15
Menemonic:
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


🙏🙏🙏
if you target at 1-2pm and consume garri and okpa, believe me you will not remember to eat that day again

1 Like 1 Share

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by drmikeadams(m): 6:15pm On Jul 15
Menemonic:
idea..

But the bolded, NO.. Not smoking

Lucky you
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by drmikeadams(m): 6:16pm On Jul 15
Vergovert:
Apple will give you all the nutrients you need for a day, according to science.


According to human wants..hunger go still dey wire belle
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Klinxmanz(m): 7:02pm On Jul 15
Very easy, chop rat poison and take cheap chemical injection for unconciousness, if u hungry forever make i no wetin cause am! Guys prepare ur burial condolencial polo, wtf!
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Yugoslavia247(m): 7:07pm On Jul 15
Menemonic:
Abeg Wetin person fit chop once in a day wey you no go hungry again until the next day..


🙏🙏🙏

Potatoe and beans.
Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by BigYash: 7:07pm On Jul 15
Just find wetin go dey give u money feed daily outside your salary .. Cux there is no way you can stop hunger if you no eat o..

10 Likes 2 Shares

Re: Abeg Wetin Person Fit Chop Once A Day by Vergovert: 7:08pm On Jul 15
drmikeadams:

According to human wants..hunger go still dey wire belle

You won't feel hungry once you master the act.

(1) (2) (3) (Reply)

Girls! Am I Searching For Them In The Wrong Places? / Can U Be In Love With Som1 U've Never Seen? / Best way to kiss a girl

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.