Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,206,860 members, 7,997,051 topics. Date: Thursday, 07 November 2024 at 09:02 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Pets / My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess (40525 Views)
I Threw My Cat Away / I Named My Cat "Osinbajo" / LOL!!! Meet The Man Who Gave Up Being Human To Live Like A GOAT (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)
My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 7:04pm On Jan 09, 2015 |
I hail u my people... I hope say all dey ok? As I dey read plenty topics for this section e b like say I wan yarn small about my cat. Na this time two years ago, I don dey receive call from padi mi wey I know for work. E come tell me say this cat don become homeless... homeless sha?! how come?! The cat don dey for one house like that, wey people nor sabi look after animals, e b like say the person head nor well at all. They don throw am for winder from 12floors high, reach ground. Omo God dey ooo - lucky say this cat nor dey break back! Anyway sha, I don home am for one night initially - omo na almost two years don pass since!! I don name am Tippy, na appropriately so, when u don dey think wetin happen to am. Since the time wey I don own am, omo nor b small mata.... she get one luxury fluffy bed, a personalised cushion cover, pink litter tray, cute food bowls and mat, a clawing board, a clawing tower with hiding space, toys don full the house self!! She don tey since with these her toys ooo - I look am like... imagine na u be cat for 9ja oo - u nor go sabi anything sha. She dey lounge about anyhow, still as she don dey get all those things, she still come sleep for another place, like MY sofa!! She get big eye oo, na she dabaru! Na house cat she be, e b like say if I free am for outside, another catgo scatter am anyhow, she go return house look like she don chop wowo lick plate!! Chaiiii - God dey ooooo As you don read my topic finish, if u wan see more you for add me on here. I also get facebook (Oyinbo Princess) and I dey for twitter too @OyinboPrincess Videos uploaded weekly on YouTube - subscribe to and watch Oyinbo Princess ONE LOVE! 50 Likes 2 Shares
|
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by nwaanambra1(m): 7:16pm On Jan 09, 2015 |
okey we don hear! now tell me wetin you wan make we do for u? you wan make we find u 'horseband'? 40 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by KELVINXY: 7:18pm On Jan 09, 2015 |
Funny Op If u see as i take rush open this thread as i see kitty cat. Mstcheww Op i no blame u shaa, na my dirty mind I go blame By the way dat ur kitty dey flex wella shaa Take gud care of am abeg #luvCats 39 Likes 1 Share |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by SELENAqueensy(f): 7:30pm On Jan 09, 2015 |
So oyibo sabi pidgin like this? E make sense o 39 Likes 1 Share |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 7:31pm On Jan 09, 2015 |
@nwaanambra1 - I nor wan make una take do anything sha - if una like make u follow my twitter, if u nor like abegieee nor b by force @ KELVINXY - omo I nor dey blame u sha... see as u don dey rush am sooo, deliverance don dey come ur way I nor blame u self, na catchy title go get views ooo I don take good care, ose baba 27 Likes 1 Share |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 7:32pm On Jan 09, 2015 |
@SELENAqueensy - ose I hail u oooo!! Highest HAIL self - check youtube for a laff oo 1 Like |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by KELVINXY: 7:42pm On Jan 09, 2015 |
OyinboPrincess:Chaii I don bend See as oyinbo dey chop pidgin like pepperoni.! U make sense joor 26 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Nobody: 7:56pm On Jan 09, 2015 |
Nawa o! U sure say u no be naija product? Anyways oyinbo people don dey copy our swag sha. Maybe na google translator u dey use. Who knows 7 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 8:04pm On Jan 09, 2015 |
It is a lie o |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 8:15pm On Jan 09, 2015 |
@KELVINXY - beta blending baba.... na pepperoni confirm e don sweet me well well self - abeg follow me jare u knw say eh, person like una good for me sha - u for help me go viral OOOoooosssseeeeeeeeeee @pureguide - omo nor b 9ja product ooo - I b confirm whitey yes, Oyinbo don too like to follow 9ja sawg, because e don hot google na a very good thing ooo, but I nor need make e help me write, I don go school well well before sha!! Shooooo u too dey fear - if disbelief dey ur mind, go youtube watch my videos, then make I hear wetin u wan yarn YouTube - Oyinbo Princess Titles - Hit Me, Mata Dey O, Omo See Yanch 13 Likes 3 Shares |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by KELVINXY: 8:30pm On Jan 09, 2015 |
OyinboPrincess: I knw sey u go like pepperoni,e dey ur face No wahala shaa I don follow u for twitter So na ur turn to go follow back. #you Just made my day 3 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 8:34pm On Jan 09, 2015 |
@KELVINXY - I don follow back Mr Man chaaiiiii - pepperoni no dey for my face joooooooor LOOOOOL - na viral mata dey for ur hand so ooo! Omo Chineke Baba dey ooo!! ps - @ just made ur day 2 Likes 1 Share |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Prodeegee(m): 8:48pm On Jan 09, 2015 |
*e be like say dust dey my eyes* Brb...make I wash am 7 Likes 1 Share
|
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 8:53pm On Jan 09, 2015 |
@Prodeegee - omo dust nor dey dem ur eyes ooo abegieee make u nor make am sore with all this ur washing mata Baba Check am for YouTube - u go believe say ur eye don dey tell u truth finally, na so e go b oooo 2 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by KELVINXY: 8:58pm On Jan 09, 2015 |
OyinboPrincess: U na confirm No worry u hear? Just leave mata for mathais 3 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 9:13pm On Jan 09, 2015 |
O girl, no be play o, I waka find you go YouTube, who teach you this kind pidgin wey you dey yarn so. Thumb up. I dey enjoy your style. You just perfect my day men. 12 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Nobody: 9:13pm On Jan 09, 2015 |
OyinboPrincess: Nawa o 6 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 9:28pm On Jan 09, 2015 |
@iyisco2001 - I don glad say na u don see am with ur own eye b that - na u go tell me nor b lie oooo abi ose baba @pureguide - na so OOOOO!! 2 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 9:33pm On Jan 09, 2015 |
OyinboPrincess:U for just edit the topic of the thread na, make u just change am to "my kittycat just dey live like queen" E go dey meaningful like that. 1 Like |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 9:43pm On Jan 09, 2015 |
@iyisco2001 - e nor go let me change am na.... or I nor sabi how - one or the other sha |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 9:46pm On Jan 09, 2015 |
OyinboPrincess:Waka go the first post wey you take open the thread, click modify, for the page, find the topic/subject section, then put wetin u want for there, submit am. Na so everything finish. 1 Like |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by niggadee(m): 10:00pm On Jan 09, 2015 |
U know 2 much are u British 1 Like |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 10:02pm On Jan 09, 2015 |
@iyisco2001 - I go try am now sha - oooosssseeee @niggadee - na so I b ooo, una for check my video 3 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 10:04pm On Jan 09, 2015 |
@iyisco2001 - OOOSSSSEEEEE BABA - I hail you ooo - u don see am abi?! na chief learner b me ooo 1 Like |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 10:07pm On Jan 09, 2015 |
@OyinboPrincess no be big deal na, e don sweet well well like that. How u take enter nairaland self dey amaze me. There is God o. Wey me I never perfect myself for your language finish, u don master my own. 3 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by niggadee(m): 10:18pm On Jan 09, 2015 |
Your head dey there u sabi speak pidgin English Fluently and Confidently. 2 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 11:07pm On Jan 09, 2015 |
@iyisco2001 - lol e don beta jare - ose... omo na nairaland b the 'hub-ub' of the 9ja society and culture, na learning curve for me self... make I follow learn better things sha abegiee baba, I never master am yet ooo - na longest way to go self! But, ose, all the same @niggadee - omo na head mata ooo Mr Man - I knw say na my head I don take learn am, but na my heart go carry me finish am I hope say una both don see my video and follow me ontop twitter / facebook 5 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by yurme(m): 12:22am On Jan 10, 2015 |
Nawa 0 4 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Prodeegee(m): 6:17am On Jan 10, 2015 |
OyinboPrincess: No worry, I don put u up for adoption... 2 Likes |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 11:26am On Jan 10, 2015 |
@Prodeegee - I nor b dog ooo - which kind adoption u yarn na?!?! 1 Like |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by yurme(m): 11:34am On Jan 10, 2015 |
Lol adoption keh 1 Like |
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Nutase: 3:08pm On Jan 10, 2015 |
na u b dat for d pix. kitty cat ke. be careful o. 2 Likes |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)
Lady Scolds Her Dog For Giving Birth To 6puppies Without Any Job (pics/video) / Help! Ruggedman Is Dying!! :-( / Joachim Iroko Names Daughter 'Aisha'
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 35 |