Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,198,487 members, 7,968,343 topics. Date: Monday, 07 October 2024 at 04:27 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / After God Fear Women (1264 Views)
After God Fear Woman / After God Fear Ph Girls (pictures Added) / After Devil, Fear Women . (2) (3) (4)
After God Fear Women by Iceking1(m): 10:55pm On Apr 01, 2015 |
AFTER GOD, FEAR WOMAN Na base on my experience as a marriage counsellor and inspiration from personal encounter with pipo nai I take write this book wey I title "Devil Dey Fear Woman" Just go through the first 10 issues wey make chapter one of the book. 1. Carol and Felicia na two best friends wey dey husband house. When Carol get one kain issue with her hussy, her hussy cum tell her to park. Felicia and her hussy try to settle the matter but carol husband say e need space now. Felicia cum tell her husband say make carol cum stay with dem for the meantime befor she go settle with her husband. Only one week nai Carol stay the house befor she begin doke Felicia husband. Befor Felicia know wetin dey sup, her husband don drive her from house as e continue dey doke her friend as new wife. 2. When Lucy born finish, her younger sister cum follow her mama come do ormugor. Na the two months wey dem stay nai Lucy younger sister for get belle for Lucy husband. Being say dem come from one kain funny tribe for Nigeria, their family say make Lucy husband kukuma pay Lucy younger sister bride price make e marry her join e wife. Befor dem even start to hold family meeting, Lucy younger sister don poison Lucy die. 3. Benson carry babe wey e wan marry go show e papa. Befor dem do the marriage, the babe don dey straff Benson papa. Dem continue their doking till the babe get belle. When she wan born, pikin nor gree come out. Doctors say both mama and pikin go kpuff if dem do operation. Na for native nai dem for tell the babe to confess becos the pikin for belle say e dey vex. Na so the babe take talk how she take start to dey service both papa and son. 4. Clara husband travel yankee for two years course. Befor e come back, Clara don get belle for e driver. She try to do abortion but the thing back fire. Na when her husband come back nai her bleeding start. She feel say the abortion through. She dey unconscious for hospital wey the husband rush her go when the doctor for tell am say na complication from the abortion wey she do nai dey worry her. When God cum wake her up, her hussy threaten to kill her befor she gree confess say na driver dey shine her congo when the hussy nor dey. 5. When small Yinka dey sick anyhow, nai her papa cum carry am go hospital make doctor check her. Na from genotype test the doctor for tell papa Yinka say Yinka na AS. The papa na AA. E wife na AA. So how come? Na so e eye dey red when e dey ask mama Yinka. Na last last she for confess say na her ex nai give her penalty befor her wedding. That free kick score goal. So, Yinka nor be papa Yinka pikin. 6. Every evening, Eguonor go tell her husband say she dey go all night prayers for one house fellowship. News cum fly enter her husband ear say she dey go meet one guy wey dey massage her steady. Na when the hussy trace her one day nai e discover say she dey true true dey doke on top o her pregnancy. 7. Mr Joseph and e wife and senior son of 7 years dey house one evening when one chief wey norva born come meet Mr Joseph say na e pikin e cum collect. E wife nor fit talk again when the chief dey shout say e go carry them go court to show dem say na him she born the pikin for. When Mr Joseph dey date Helen, she dey doke chief join. She get belle but chief tell her to remove am she nor gree cos she dey fear abortion. Na so she hang the belle for Joseph. Na becos of say she get belle nai make Joseph rush marry her. 8. Benji decide to marry Chioma when Chioma lie for am say she get belle. Na so so wayo she dey play Benji for the 5 years wey dem don marry now say she miss period whereas nothing dey happen. Na when she and her childhood friend get quarrel nai the friend use am take curse her say na the aborted baby wey she use mortar and pestle take pound for native doctor shrine nai dey worry her wey make her norva fit born so. 9. Utienyin and e wife dey owe landlord 10 months rent. Make the landlord for nor drive dem, the wife cum go seduce the landlord without her husband knowing. Befor you know what, na steady doking. Dem doam sotay the landlord wife cum know she cum go tell Utienyin. Utienyin cum say make e wife park. But landlord cum say make Utienyin park. As Utienyin dey park, the wife remain for the compound as landlord babe. 10. James with e babe go club. Where James for dey find e babe make dem dey go house, e sight her for one Range Rover. She sidon for front dey wave James as she dey use straw dey sulk star. My pipo, from number one to ten, e get wetin one woman go do again wey big pass any of dem? We dey construction company wey one guy waka pass me. Wetin e write for e helmet nai inspire me to write this book. He write "After God, fear women" When I ask am why e write that kind thing. This na wetin e tell me. "My brother, when God dey question Adam why e eat from the tree wey e tell am not to eat from. Adam say, "Baba, nor be the woman wey you give me nai say make I eat am? Lwkmd. Why Adam nor fear God but e cum fear Eve? Mind you, the second chapter of my book "DEVIL DEY FEAR WOMAN" go come tomorrow. Watch out! |
Re: After God Fear Women by falconey(m): 10:56pm On Apr 01, 2015 |
NOTED!!! |
Re: After God Fear Women by Nobody: 10:57pm On Apr 01, 2015 |
When you offend a woman, just pray she does not hold it against you! |
Re: After God Fear Women by wenger2(m): 10:59pm On Apr 01, 2015 |
Re: After God Fear Women by Iceking1(m): 11:00pm On Apr 01, 2015 |
rubey: Gbam!!! , u jst nailed it |
Re: After God Fear Women by Hawlahscho(m): 11:05pm On Apr 01, 2015 |
rubey: Let me quickly change My signature. |
Re: After God Fear Women by Iceking1(m): 11:07pm On Apr 01, 2015 |
Re: After God Fear Women by Hawlahscho(m): 11:11pm On Apr 01, 2015 |
Iceking1: |
Re: After God Fear Women by floma07(m): 11:44pm On Apr 01, 2015 |
Oh boi no be small tin ooo |
Re: After God Fear Women by Nobody: 11:51pm On Apr 01, 2015 |
Re: After God Fear Women by jashar(f): 8:27am On Apr 02, 2015 |
*sighs* And the OP never gave credit to the male actors. The one who betrayed his wife The one who lacked self control The one who betrayed his son ... Et al. *sighs* 2 sides to a story, several perspectives to it. |
Re: After God Fear Women by ivyT(f): 9:51am On Apr 02, 2015 |
na Long tory b dis,fear every one_cos no one is to b trusted |
Re: After God Fear Women by Iceking1(m): 9:59am On Apr 02, 2015 |
Re: After God Fear Women by englishmart(m): 10:11am On Apr 02, 2015 |
sometimes I fear women more than the gods 1 Like |
(1) (Reply)
Hilarious Dating Tips For Broke Guys :how To Have An Amazing Date With N200 / My GF Is Cheating On Me With A Soldier, I Want 2go To The Barrack & Confront Him / How To Find Out If Your Boyfriend Is Cheating On You (for Girls)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37 |