Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,205,713 members, 7,993,529 topics. Date: Monday, 04 November 2024 at 01:45 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! (75177 Views)
Can You Marry A Lady Or Guy Who Already Has A Child? / 6 Places You Should Never Toast A Nigerian Girl / Advice To That Babe Wey Say Her Guy Gives Her ONLY 1K (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (39) (Reply) (Go Down)
Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:38am On Jun 20, 2015 |
My people how far? I create this thread make we woo anybody we like(e must not be your crush) for pidgin english. Some guys wan woo some girls but dem dey find am hard to use correct english. So na your chance be this. Mention any guy or girl wey you like and use pidgin english take woo her. Make I open floor. PS: Language on this thread should be strictly pidgin english 10 Likes 2 Shares |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:38am On Jun 20, 2015 |
______ how far? You know say I like you well well? Anytime wey I think about you my heart dey do "jibi" "jibi". But you no dey try for me at all. You go just dey form for me up and down. You see that your smile,,e dey melt my heart and your eyes dey so sexy. I dey like read your comments because e show say you carry brain well well and you no dey ever disappoint me. Sometimes sha you dey look for my trouble,,but I dey forgive you because say my heart no fit hate person wey l like. I go take you go dubai for shopping and we go stroll for paris,,catch siesta for carribbean beach and chop dinner for Italy. Your car go be german and our pikin go be twins. Reason all these things and make you tell me your answer. No keep a guy waiting. 31 Likes 7 Shares |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by peeparty(m): 10:40am On Jun 20, 2015 |
cc honeygirl17 mzztega adeh39 midehi gifttracy Aminat508 ginawest mzlaurel jollyjoy |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Hazardd(m): 10:41am On Jun 20, 2015 |
make i observe |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:42am On Jun 20, 2015 |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by yorubaboiy: 10:42am On Jun 20, 2015 |
[size=13pt]lemme too do my wooing sharp sharp make i no go turn omoge wey no wear pant *clears throat* nwa mo....bkos of you i no fit slip i no fit chop ,as i dey always think of you my brain dey always do me wayo.....anytime wey i c ur profile pix ehn,my system dey always restore back to default settings.... i no go mind to be the ewo soup to step down your yam d only banga to step down your starch your loff just dey do me tinini for body if you no mind,abeg make i park my small car in your garage..... your one and only yorubaddest cc prettythicksme aminat508 mhizel introvert [/size] 7 Likes |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:44am On Jun 20, 2015 |
yorubaboiy:Na we own am |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by dharay99: 10:44am On Jun 20, 2015 |
tut i saw it musnt b ur crush. |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naija1stpikin: 10:44am On Jun 20, 2015 |
Every night wen I don sleep, I dey always face one high hill for dream. Guess wetin d hill be? Na aminatu508 yansh o E dey be me make bulldoze your yansh with my weapon of mass destruction but liver dey cut me. I wish say you go fit let me enter the promise land like Joshua and path the Red Sea with my rod like Moses. If I don see your pic my heart dey melt like salt wey dey for rain. I no know wen I look back like lot for inside bible wey make me turn salt wey dey melt. If you fit gimme chance, I no go chop you rush rush like hungry mechanic, walahi Na fvck and knife I go take chop you. Pls no say no to my toast make man pikin for no go drink cement I ruv you Cc naijaboiy 19 Likes 1 Share |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by jonaifame22(m): 10:45am On Jun 20, 2015 |
Hey babes how u dey na,I just dey feel ur signal 4 where I dey, omo mehn u make brain die,I no fit jst bear d tin again na him make I disco come meet u so,my name na john, e go sweet pieces if me and u fit just go take peppersoup tins later for evening dat kind 7pm tins,I believe sey u na soji gal because u be uptown babe,as I dey look dis ur eye sef, I no sey u dey reason me sef , no fear o, me no get wahala make I get ur control so I go fit call u lerra,u 2mch babe,okay na lerra tins,u're blessed. 6 Likes 2 Shares |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naija1stpikin: 10:46am On Jun 20, 2015 |
So who dey crush on me? |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:47am On Jun 20, 2015 |
My @dey do jibi jibi got me laughing i swear 3 Likes |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:47am On Jun 20, 2015 |
Kingtom Alberto2k Orijin101 Jacksparrow0100 Tosyne2much Stephenqueen Misssclassy Ladyboss1 Twaci Tomfrench Adeh39 Deejavuu Truckpusher Afapecharis Ronald4lif E.t.c... e.t.c...e.t.c 1 Like 1 Share |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:48am On Jun 20, 2015 |
dharay99:Yes it mustn't |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by dharay99: 10:49am On Jun 20, 2015 |
peeparty: is daht all, Was expecting like 50tags. |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by stephenqueen: 10:49am On Jun 20, 2015 |
Make I cum woo ishilove 4 Likes |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by elantraceey(f): 10:49am On Jun 20, 2015 |
Sonofmark come show your skill |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:49am On Jun 20, 2015 |
heheheheehehehe..chaii |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:49am On Jun 20, 2015 |
misssclassy:No be everything be english. Type for pidgin sometimes. |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:50am On Jun 20, 2015 |
prettythicksme:HeHeHe |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by lekinz(m): 10:50am On Jun 20, 2015 |
Na today I go woo elantraceey |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by peeparty(m): 10:51am On Jun 20, 2015 |
Midehi:I dey wait |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:51am On Jun 20, 2015 |
jonaifame22:Bros who you write this one for? |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by agarawu23(m): 10:51am On Jun 20, 2015 |
baba God na you get the glory o, if no be Nl eh, how I go take meet this my oyinbo pepper soup joy wan mama babe na you let my head dey kolo since the time wey I jam your moniker. nne eh! make you just take me the way I be na, you know say money no be love . I dey ready to spend all my dollar for your head if you go be my one and only. joy biko afurunginaya I don ready to meet your mama & papa so that our love go enter another level I know fit chop without u I know fit sleep without u all my body just dey do me like say dem nak me jass yesterday instead of make I pour water for kettle, na ground I dey pour am as your love don enta my brain hope say you go give me chance make I show you say na you be my lost coin jollyjoy 8 Likes |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:51am On Jun 20, 2015 |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:52am On Jun 20, 2015 |
lekinz:Oya drop am. |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:52am On Jun 20, 2015 |
Typing......... |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by peeparty(m): 10:52am On Jun 20, 2015 |
dharay99:you want more? |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Shamstiel: 10:52am On Jun 20, 2015 |
Ladyboss1 how far now? I know say we never rap before but I just wan use this opportunity tell you say I gbadun your swag. I no too like to dey yan long tory but e dey do me like say make we gather dey for real life Make I wake up for early mohmoh make you be the first person I go see. E dey do me like say make I run my hand through you hair and see you dey blush one kin one kin...make I kiss your ponmo lips and enjoy the sweet sweet flavour whey dey inside am... I wan make we dey plaii like bread and bama or like fat and oil. I just want make I be that person whey go bring smile to your face anytime you dey think about me 12 Likes 4 Shares |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:52am On Jun 20, 2015 |
naijaboiy:chess! It seem that is ur area of specialization. |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by naijaboiy: 10:53am On Jun 20, 2015 |
agarawu23:This one nor be Front page material o. |
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 10:53am On Jun 20, 2015 |
Ori ife...the only love dat has an head Anytime i wey i see u na so i dey fall yakata in love, my heart go dey do like say e wan tear my body and tear my cloth join so dat e go fit enter ur own make e become one... e just be like say make i grab u and carry u go house i want make u be the ororo for my sardine, my 1, my 2, my 3 and my only... i ruff you from the ground of my heart...oya talk ur own 2 Likes |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (39) (Reply)
My Butt Is Causing Unnecessary Attention For Me / Zimbabwe Pastor Involved In Car Accident During Sex With School Girl / Wedding Photos Of Kwoyela Derrick ‘Taller’ & Kahboh Patience
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 36 |