Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,200,889 members, 7,976,314 topics. Date: Wednesday, 16 October 2024 at 04:15 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) (247928 Views)
Future In Chaos (A True Life Short Story)written By Etz Sky Prince / Soyinka Backtracks On U.S Visit, Returns To Deliver Lectures / The Day MTN taught me the Lesson of my Life ( Short Story) (2) (3) (4)
(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (36) (Reply) (Go Down)
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by bukatee2015(m): 3:27am On Oct 19, 2015 |
Choi see tori wey wake me by this time to watch finish *choi like say I dey wake up early b4 to work* Classcostain u b wizard oo, even u fly come wake me frm slip to update me on d 14sth page *yawa dey oo |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by linconoyee: 4:48am On Oct 19, 2015 |
Haha Op thump up, I open a new Web for ur thread and never touch am, abeg finish this Torry today. And I need some scope from u personally. A go dm you, am lincon from Canada |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by victorava(m): 6:28am On Oct 19, 2015 |
Mr. ClassCaptain, your story is very interesting. Keep up the good work. But we are eager to know how it ends. Patiently waiting... Haters should take a dive into an empty swimming pool |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by emmy02(m): 7:48am On Oct 19, 2015 |
This one u write 'to be continued...: i hope no b till next yr this time u mean?? |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Nobody: 7:52am On Oct 19, 2015 |
richommie:did he finally finish the story? pls give me a recap .what happened in the room.? lol |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by surbrown(m): 7:58am On Oct 19, 2015 |
OP abeg finish am oo |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by surbrown(m): 7:58am On Oct 19, 2015 |
linconoyee: see pervert :v |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by pharmagba: 8:03am On Oct 19, 2015 |
ClassCaptain:You are creative and good. Dough my hat |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by shona2487(f): 8:11am On Oct 19, 2015 |
can't stop laughing. Truly entertaining. |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by TENHEU22(m): 10:03am On Oct 19, 2015 |
trishguy:i no see my name |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 10:11am On Oct 19, 2015 |
Episode ( Check where we stop naa no vex just go check am ) ... THE " D " DAY "!" As next day reach like this,na around 5am i don wake up.. i no kukuma see d sleep sleep like that sef .I see say he be like say morning never reach well,make i chill small.i go sleep back. By d time wey 8 go knack,i don wake up. I wan use the Close up tooth paste .I see say he don finish .I use knife cut am into two.use d one wey remain inside brush mouth well.All d inner and all those corner corner teeth na hin i wash well as i no pity d Tongue sef.. I scrape d thing wella make i no con wan day kiss ,make mouth day smell..After i finish The small close up, i con use the other Oral B toothpaste wey i get,use am brush mouth again.. If one toothpaste no work ,d other go work. After i brush finish.i used sponge and Dudu osun to scrub away every impunity and dirty dirty wey day for my body. Na almost 1 hour spend for bathroom..Any place wey i fit Scrub na hin i scrub..As i day scrub,dey baff ,na hin i day sing Reminisce Tesojue laleyi.,wafe Ku laleyi Infact na d kind baff wey person wey day baff am go sabi say d baff wey hin day baff pass oda baff wey hin don dey baff before . 8 Likes 1 Share |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Nobody: 10:13am On Oct 19, 2015 |
ncoolsome:lollzz...brother, both of you are right in your own way. 6.1 is a number. Though it is a decimal number. What the op originally meant was integer or whole number which you were trying to explain for him. Nice one though. Classcaptain nice write-up. Waiting for final episode sha. |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 10:17am On Oct 19, 2015 |
Episode 31 I shaved all the hair wey dey my body comot ,both upper and lower region, ..Anything fit shele anytime, wey she go feel like licking the Stick sweet . She fit go vex comot if na Mangroove Forest she go meet for there,i make sure say everything,clear like Sahara desert... Na Reflex action . Time no day today ..i get plenty things i must get sharpaly .as soon as possible.. I sharply go bank atm...i go withdraw the last 7 thousand 500 naira wey remain for d account.. One guy wey day beg for transport fare go hin village,though nobody give am any money.i comot 500 wey day top.give d guy. From there,i comot go market. The First thing wey i bin buy na flowers..I buy flowers.. I buy this poster abi na banner wey dem day put for wall for inside house .I specifically make sure say na d one wey dem day kiss and romance and half naked ladies in bikinis day na hin i buy.i buy 3 of that one. I buy air freshner and better perfume,i buy hanger to arrange all my clothes wey i be no arrange and i buy Foot mat wey i go put for door as i bin no get any before.. 8 Likes 1 Share |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by leederrty1997: 10:23am On Oct 19, 2015 |
ClassCaptain: I first think say u wan use dudu osun wash mouth too. I for don call ichinbong say make she wear black black come to mourn a great loss. lol 3 Likes 1 Share |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 10:25am On Oct 19, 2015 |
Episode 32 After i reach house, i go Mama Peter Store, buy Viagra and two bottles of alomo..con use one leg branch iya shakira alagbo ,na there i con buy 200 naira worth aleto,opa eyin.jedi jedi and Ato pa. After i buy all this.i go Abigurl and Prettyjo pharmaceutical store and supermarket , go buy condom..Make she no day dey reason me cheap or local ,i buy Original Durex condom..... He be like set everything don day set small small... What of the rice wey she wan chop ?? I hustle go market back ..Be like say I get rice for house,I just go buy fish.small meat.tomato.Maggi. ponmo and the rest wey i go use sama d girl better jollof rice. i just day sweat day pespire as i bin day jump from one okada to another. ... Na dere i meet one of my old padis,Edgyslim. . We greet. talk small and he talk say make he con sabi my house ,say he get one big business way he wan involve me. ..Today ?? oloshi..He no con fix better time,na,around 6 and 7 the bastard go fix again. Destiny destroyer, by d time wey my guy go talk say make he carry wetin hin buy and comot phone collect my number,i don tear comot. 12 Likes 1 Share |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by muta1996(m): 10:26am On Oct 19, 2015 |
you just dey spend money |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Richie0974: 10:32am On Oct 19, 2015 |
ClassCaptain: Abeg how many episode still remain |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by leederrty1997: 10:33am On Oct 19, 2015 |
B. C. O. S NEWS!!! Ni iranti oloogbe, Boo Osin jade laye abi o padanu emi re ni kete ti odobirin kan, ichinbongi...... make i still dey observe till d end. 1 Like |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 10:34am On Oct 19, 2015 |
Episode 33 As i dey come,i branch Eleniyan15 electrical shop.buy this disco light bulbs wey no day white, wey day usually day club. i buy one red bulb and i buy one blue bulb.. . I no forget also branch Dj abiambo Syd. Na there I buy two collection of blues and romantic Foreign songs.At least person no fit day play Terry G nack apako for insyd dat kind parol naw.. .how body go even move ?? Choi.i no get music player naa ?? How i wan take do am.i sharply rush go Trishguy house go, borrow him sound system.2 k na him d guy request for.. 2k too much naw ?? " Take it or leave it ?? He said.. No be today i sabi say d bastard stingy with money. Shebi na just 2k...Na 40k i go win if i tear dis girl oo.I pay d guy carry d speaker go ?? " he no day spoil oo,na my papa hand i inherit am oo " " Your father yansh, if he spoil shey i no pay u... .. 8 Likes 2 Shares |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by muta1996(m): 10:34am On Oct 19, 2015 |
leederrty1997:me sef but since he don dey alive to tell us,i don know say maybe he no later use hem |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 10:40am On Oct 19, 2015 |
Episode 34 i carry the banner wey i buy. Plaster am for wall in a position wey be say na d first thing wey she go see be that..Hehehe half naked women in bikini.that will send her d signal say look " You are here for business". But wait,Gen nko. .in case light no day i go TechsNg house. dem say he don go school.lock hin gen inside room. Oh wetin be this one naw. I sharply go one of the holy holy guys wey day hood, djeezy. ...The guy na very cool guy,he no day smoke.drink or fornicate and na pastor hin be. I sharpaly formulate one lie give am and he agree give d The Gen with d Assurance that i return d thing d next day. While the guy day go sort out d Gen for me.i see say na pastor Chris oyakilome day preach for hin phone and d topic na " Sexual prosmicuity ". Dont sleep with that girl.. The Bible says in d book of something something something ..that ...The woman lures the man.. ..the kini kan do d man.. Mtcheww..Everything wey d man just day talk be like jargons to me..This message is not meant for me..No be me get am..If God no want make i kpansh inchinbong.he no go allow her change her mind and come my side.. Abeg pastor Chris abi ludacris ni,Swerve go one side abeg.i just use Vex comot d man video comot.Shey dog wey go lost. No go hear hunter whistle. 14 Likes 3 Shares |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by muta1996(m): 10:42am On Oct 19, 2015 |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by edgyslim: 10:52am On Oct 19, 2015 |
ClassCaptain: Bro I dey come read later. Make I finish with my Oga first. |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Hormenah97(m): 11:07am On Oct 19, 2015 |
OP!!!!! Where is U na? Mai ba3 don low oo, I dey wait for d next Episode |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 11:21am On Oct 19, 2015 |
Episode 35 The guy come back and hin give me d Gen..i no pay am anything at all..i prayed for d guy....Tho d Gen don old gan and oil just day gooze from the body.i carry am like that from pastor djeezy syd reach my side.. The distance reach 3 kilometers.. i day drop am day rest for road.Day drop am day rest for road. People just day look me for road.me sef dey look dem. " My guy ,ur gen spoil" na wetin guys dey ask me be that " yes" i no get strength to day talk long tori again..By d time wey i don almost reach House, i don be like mechanic as na all my cloth don dirty but me i no send,ichinbong na hin be my inspiration. Next thing as i reach house,i buy card call Emusmith make hin con repair d spoilt fan and Wristbangle to con repair d toilet, way no day gree flush well. I no fit day kpansh inside heat ooo.. " Oga we no fit repair am today,na inner wiring spoil" Haa..no be today dat one go happen.i paid his transport fare from there go there market and come back.wetin dem day sell for 1k d guy call am 2500 for me.As i no fit go buy am myself,i give emusmith. The toilet guy no give me probelm,he just come do hin own work comot as we gather dey make jest...He knew i was quite happy....Fan fix .Toilet fixed .everything getting in shape.. I think am ready to receive ichinbong 4 Likes |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 11:22am On Oct 19, 2015 |
The tori day end today.Less than 9 episodes left |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Dramadiddy(m): 11:26am On Oct 19, 2015 |
Classcaptain!!! U use five episodes set your room! Kontinuu! |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by stan241(m): 11:27am On Oct 19, 2015 |
ClassCaptain: 9 episodes ke Class captain this thing don turn seasonal film na |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by stan241(m): 11:28am On Oct 19, 2015 |
Dramadiddy: As in eh my brother just imagine |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Eleniyan15: 11:33am On Oct 19, 2015 |
booked!!!!!! |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by MoriYanu(m): 11:35am On Oct 19, 2015 |
in Mama Peace voice "continuee" |
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 11:46am On Oct 19, 2015 |
Episode 36 I con start d cleaning proper.Comot bed.comot carpet ,dust everywhere. comot cow webs, comot all dirty dirty tins and everything.. Clean d whole house proper.. The kind sweeping and cleaning wey i never clean since i packed in 3 years ago,na hin i give the room dat day. I sharply wash d two Cottons ,hang am for outside.. As per say my bed don tear tear and d thing don soft. as usual i borrow foam from MrCork ,put am under for more thickness.. Con spray perfume for d bed sheet put am for there.. Ehnn i think all is set now. All dese while i never see a single thing put for mouth. Everything don set..I don pack Spartacus.game of thrones and all dis erotic movies full lapi incase she wan watch film..dat one go ginger her up. 3 Likes 1 Share |
(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (36) (Reply)
The Dog Attendant (T. D. A) [COUNTLESS Part 2]. A story By Darousmart Emmanuel. / Iyawo Nylon Bag / HERO (A Violence, Mind Control And Sex Story) a story by Queenliz
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 59 |