Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,201,610 members, 7,979,057 topics. Date: Friday, 18 October 2024 at 07:27 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? (1085 Views)
Davido: Why Wizkid And I Settled Our ‘Beef’ Of Many Years / Davido: Why I Love Chef Chi; Chioma Is The Only Woman That'll Treat My Kids Well / Dammy Krane Reacts To News Of His Arrest in Miami, USA: "I go talk everything" (2) (3) (4)
Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by OKorowanta: 8:18am On Oct 28, 2015 |
Cynthia Morgan don tell Davido make he go siddon for one place, few days afta she tell tori pipo say, na Davido be one bobo wey be say, if dem giam chance,she go leak him ear. Kasala don buss out bitwin dem two, four days afta she yarn say,among all di celibritis,na Davido she dey trip for pass. Di hole wahala start wen Davido hand skratcham go write for twita say, na Lil Kesh go win di best new miuzishan for di Headies Awards wey go appun veri soon. Akordin to Davido,he say na Lil Kesh be di MVP dis year make evri oda pesin chill for di boy wey sabi. Quikquik mazamaza,naim Cynthia Morgan reply say, make Davido go siddon for wia containam bicos evribodi wey dia name appia for dat list na MVP. Apart from di German Juice singa and Lil Kesh,oda artist wey di oganisers choose for dis award na, Reekado Banks,Kiss Daniel and Korede Bello. Like follow come battery for phone,di next rated award go follow come wit brand new motor. So anybodi wey win di award,go win di motor join. Issorait,make I go prepia for di next tori. Gudluck to all of dem. Read more for hia....http://ogakpatakpata..com.ng/2015/10/sharrap-davido-why-u-go-talk-say-na-lil.html
|
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by sissylucy(f): 8:20am On Oct 28, 2015 |
Op plz can u translate in English |
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by sissylucy(f): 8:21am On Oct 28, 2015 |
Op plz can u translate in English...I no dey understand pigin by dis time of d day |
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by OKorowanta: 8:24am On Oct 28, 2015 |
Di battle!
|
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by OKorowanta: 8:27am On Oct 28, 2015 |
sissylucy: Lol. na di language wey my malleh undastand for warri be dis. ask yor palleh,he go gist u more about dis first language of ova 100 million naija pipo. nor go carry last o. |
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by sissylucy(f): 8:41am On Oct 28, 2015 |
OKorowanta: no b say I no dey understand pidgin but no be by this time |
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by PoosPoos: 8:58am On Oct 28, 2015 |
Lolling |
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by Eliza5050(f): 9:02am On Oct 28, 2015 |
sissylucy: I don't want to laff dis morning jor. U're already replying with pidgin dis morning na! |
(1) (Reply)
2face Idibia, Wife & Daughter Dancing @ Ubi & Lillian Wedding ( Pics & Vid ) / Sisiafrika Storms Nairaland With Her #hellochallenge / For Big Babies - Govt Bans Fire Crackers (knockout) As Xmas & New Year Approach
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16 |