Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,205,867 members, 7,993,997 topics. Date: Tuesday, 05 November 2024 at 01:21 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow (146678 Views)
The Mysterious Girl(a Love Story From Epiphanus) / Mysterious Ileya Ram (2) (3) (4)
(1) (2) (3) ... (11) (12) (13) (14) (15) (16) (17) ... (25) (Reply) (Go Down)
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 8:12pm On Mar 06, 2016 |
[b] fiftysix hapter 56 when i heard the voice I don't need a soothsayer to tell me that Lizzy is here, I wonder wetin make her come oh, she be say she dey shrine, how manage she come come here now now now? as I turn and saw her coming from the crowd, she wear complete white gown with blood on her hands holding a dagger on right hand, all her hair scattered as if shes coming back from war, when she appear everybody begin run as if they know who she is or maybe them see ghost, oh yeah she's a ghost, within a minute everywhere don empty except the altar wey the chief they, even the cheif bodyguards run too. The Chief stood up and walk to Lizzy why I arrange myself on the ground trying to free myself from Annabel's grasp. Chief: Luciana. Lizzy: the devil himself. Chief: hehehehe If am a devil then what should I call you? Lizzy: what is going on here, ( she said and look at me on the ground, I hide my face becus I was ashame.) Lizzy: stand up Oz and take back your property. Me: which property? Lizzy: the hair. Annabel: the hair belong to me now Chief: Luciana don't tell he's the one. Lizzy: he is. Chief: we are very sorry. Ann: sorry for what dad, am not giving it back. When Lizzy hear that word e be like say she wan turn to devil because her face turn red like hell. Chief: Luciana calm down, Ann return back the hair. Ann: Papa........... Chief: return it, ona gba gbe ma (this one too big for us) Annabel return my hair back to me, me I nor know wetin they special about the hair oh, Lizzy hold my hand tight and pull me out of the stage. Chief: Luciana? she turn back and look at the chief. Chief: we have to talk. Lizzy: there will be consequences. Chief: but we never knew. Lizzy: you know now. Annabel: damn the consequence pa, who the hell is she? Chief: hold your tongue dear, she is your mistress. Lizzy: and I believe this won't happen again. Chief: of course it won't. Lizzy: see you then. Lizzy pull my hand and we continue going to nowhere in particular, I don't know were my friends are, but I believe they are safe anywhere they are. as we they waka they go for main road, any motor wey they pass they commot for road for us, once them use their light point us and see us them go reverse commot for road. Me: were are we going? she didn't even bother to reply me. she just hold my hand and continue drawing me along like handbag, I know I deserve it but at least she's hurting my hand, but I dare not talk because all of a sudden am now afraid of her, who won't be when she hold dagger on her left hand and hold me on her right as if she's going to sacrifice me just like Abraham in the Bible. after she don waka tire she stop for center of road and use force to stop one car, the driver run commot like rat, who go see fire and still stand? Lizzy: get in. see as this girl they command me oh, who she be wey she wan they form madam for me, though i don't have any choice so I enter inside the car and Lizzy speed off like neo in the movie matrix, the car they run like speed of light, Lizzy no dey look road oh na the stirring she dey look, e be like say I annoy her well well oh because the way wey she dey vex so na only god know weting they her mind, she enter the road to her street and fire more speed, as she they speed they go, something run pass our front and Lizzy jam the thing because no time to hold break because of too much speed. as she jam am she quickly hold break, I bash out of the car ignoring her warning not to go out, what I saw shock me, we hit a small cat with bright eyes like sun, w white cat for that matter, Lizzy came out of the car too to see what we hit. as she come out and see the cat, she shouted at me. Lizzy: get inside now. I saw the seriousness on her face then I know say she nor they joke I immediately rush inside the car, Lizzy try to start the car but e be like say the car don go thy kingdom come, she try many times but the car no gree start, then for the front of our car were we hit the cat person bring hand come out and put for the front of the car, I nor need babalawo to tell me say the cat na person, Lizzy: get out of the cat now. I rush out of the car with Lizzy and we started running back from were we came from in the middle of the night, then all of a sudden a heavy rain started falling followed by a heavy thunderstorm, me and Lizzy don wet as if we they river they baf, as we they run they go, then Lizzy stop. Me : why are we stopping? she point her bloody hands signaling me to look further"look very well" she said. I zoom my eyes to were we running to and thus I saw a rising smoke and dark smoke for that matter rising at the middle of the road in form of human being.[/b] 1 Like |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 8:16pm On Mar 06, 2016 |
@ iamfbanj tnx but u for bold am |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Remilekun101: 8:49pm On Mar 06, 2016 |
ozila:https://m./651531841626233?_e_pi_=7%2CPAGE_ID10%2C8546544157 |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 8:54pm On Mar 06, 2016 |
Remilekun101: tnx |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 9:06pm On Mar 06, 2016 |
Septembergirl I see you |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by akomolafe226(m): 9:58pm On Mar 06, 2016 |
if na me i go don piss for body 1 Like |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by NE555: 12:07am On Mar 07, 2016 |
my observation revealed to me that Oz is an Electrical student.. I doff my cap for good job done. |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 6:29am On Mar 07, 2016 |
NE555: really? |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Samueluj(m): 8:09am On Mar 07, 2016 |
Oz, your story is so fictional, I like it. |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Nobody: 8:30am On Mar 07, 2016 |
Samueluj: because u stay in one place with no trouble u think the world end there, there are many things in this world that happen and we don't even know about, from the beginning he said this story is real if you want to distract him with ur nonsense debate pls pack ur load and go. 1 Like |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Nobody: 10:24am On Mar 07, 2016 |
cho25bc: so u had to blast me with that email without hearing my side.of the story The silly girl deleted you once morr and i was mad at her when i found out. she is a jealous punk and i have ended everything with her last week. she deleted my junior sister too out of jealousy and that made me send her packing |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Samueluj(m): 10:43am On Mar 07, 2016 |
We 4 happy if this tory dey 4 movie, e for sell! 1 Like |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by hotswagg12: 8:23pm On Mar 07, 2016 |
Nice story...where is mr ozilla? Pls come and update. 1 Like |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by STANCO31(m): 2:18pm On Mar 08, 2016 |
I dey follow Ozila anywhere he go. Still STANLEY |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by olite93(m): 6:30pm On Mar 08, 2016 |
we hav d witch, i sure say d mirror go show. bt d carpenter i no sabi. btw nice story |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by joanee20(f): 6:34pm On Mar 08, 2016 |
I dey fear for u OZ... |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Nobody: 6:55pm On Mar 08, 2016 |
Oz,do now.Been waiting in all the stories- |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by NE555: 7:30pm On Mar 08, 2016 |
tell me it's a lie |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by NE555: 7:31pm On Mar 08, 2016 |
ozila:tell me it's a lie |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 8:05pm On Mar 08, 2016 |
NE555: its a lie |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 8:14pm On Mar 08, 2016 |
typing........ |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by artsoft1: 8:48pm On Mar 08, 2016 |
ozila:Waiting.... Good job bro. |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Nobody: 9:35pm On Mar 08, 2016 |
I have decided the step out of ghost mode. Please update now. This wait is getting too long. Meanwhile, well done. You're doing a great job. |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 10:01pm On Mar 08, 2016 |
[b] Chapter 57 Me: what's that? Lizzy: something you don't want to know. Me: what do we do? Lizzy: we have to run very fast. she hold my hand and we turn back running towards the place our car broke down, I just hope the mysterious cat is no longer there. Me: but what of that cat?, I ask as we continue running. Lizzy: the smoke is the cat stop talking let's focus. Me: okay dear, but can't you fight it? Lizzy: you can't fight what create you, no more question. I keep mute as we run Luke say na gorilla dey pursue us, we reach were our car they and we run pass am, of course no sight of the cat or any human being, that convince me that the cat is really the smoke we saw on our way to main road, as we continue to dey run, I wonder why Lizzy no just disappear make we appear for her house or maybe she nor get the power to disappear? of course she get am I remember that time wey I go her house wey I mysteriously see myself for my house after the kiss of death, hmmm I don really suffer oh I think its time I share my bunden with anoda person I can tell my mum or maybe my elder brother but they won't believe me, they fit even carry me go put for psychiatric hospital self, I nor trust that my elder brother wey im eye they chuk like chukuchuku, well I nor Blame am na the kind of work wey im dey do cause am. I forget say we dey run from danger begin wonder go wonderland, well after all na wonderland I dey already. na this kind night them they call evil night, the only sound you hear na the sound of our shoe, the noise of cricket and sound of owl, oh sorry Lizzy no wear shoe na ordinary leg she dey use run, I wonder whether e no dey pain her, and by the way why she even carry dagger come that party self, abi na altar she dey wey she appear come? question for the gods. as we dey run I look back I nor see anything or anybody e fit be say the mysterious smoke don give up oh, so I beg her make we rest small say I don tire she refuse, she say na she suppose complain no be me afterall I be man so make we continue till we reach her house, well I have no other choice than to obey like fellow slave, we run till we reach her bungalow, oh yeah I called it bungalow because na only that house they that side, no house they close except the filling station wey them don abandon Tey tey. as we enter the street to her house na by then her head say make we stop running, we walk to her house and she open the gate for me, I look her face and e be like say she still dey vex, which one she dey vex for me I nor know oh, whether na becus I dey kiss the girl or na becus I nor tell her say I dey go party or na becus of the girl wey challenge her I nor know, all I know be say na she sabi, as we enter her house, e be like say e don Tey wey she come this place so, she be tell me say she they her altar for ugbomiga so she never come this place since, but na only two to three days na her house no suppose they like this na, well that one no concern me, she just go one sit and sit down, she dey expect make I go join her for the sit well i jejely enter her room and locate her bed, then I lay my coconut head on her pillow and sleep off. I put my head for pillow begin wonder wetin they happen to me, so many things that I can't explain, from Lizzy to Lucy, from Lucy to Justina, from justina to my mysterious mother, I can't even name them, I just hope and pray God give me the power and strength to carry on, but na who be that smoke, and why e dey pursue us? for Lizzy to be running away from it then the person must really be powerful oh, since I know Lizzy na only one person she don run from and that person na my my mysterious mother, abi na she be that smoke? she fit be oh because Lizzy say she nor fit fight wetin create her oh yes that smoke is my mysterious mother, well I will have to ask Lizzy to know who the person is and why is he or she looking for us. I was still thinking loud when somebody walk in and alas I look up and saw Lizzy naked, oh men see beauty but why demons they fine like this? looking at her V part alone don make my dicck rise[/b] 2 Likes |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by cho25bc(f): 2:57am On Mar 09, 2016 |
wastedsperm:I'm very sorry abt wot happened and 4 not replying u on time,my service provider disrupted my internet subscription 4 2 days and I jst got it sorted out yesterday night. I'll prefer pms 2 discuss dis matter.Pls kindly resend a bbm request so dat I can explain myself 2 u. Once again,I'm sorry |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by akomolafe226(m): 12:36pm On Mar 09, 2016 |
NEXT |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by jnichole(m): 3:43pm On Mar 09, 2016 |
great job but please your update slow somehow. |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by joanee20(f): 5:55pm On Mar 09, 2016 |
OZ OZ..na wa for you o.. |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(m): 8:15pm On Mar 09, 2016 |
Chapter 58 strictly 18+ please and i cannot post it here because of the nairaland rules, click here to read it http://ozilatales.com/58-sex-of-death/ 4 Likes |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Emmyk(m): 11:49pm On Mar 09, 2016 |
It is time for evening prayers. |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by latino1131(m): 3:12pm On Mar 10, 2016 |
Ozila we re through with 58 ooo.. pls continue my broda |
Re: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by Peterjezy(f): 3:19pm On Mar 10, 2016 |
Ahead Head my dear. You are too good to be good. |
(1) (2) (3) ... (11) (12) (13) (14) (15) (16) (17) ... (25) (Reply)
Meant To Be / The Paradox Of Abel (The Sequel) / Black Maria 4 (Nemesis)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 46 |