Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,171,375 members, 7,881,344 topics. Date: Friday, 05 July 2024 at 05:20 PM

NYSC 2017 Batch A Corps Members House - NYSC (23) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / NYSC / NYSC 2017 Batch A Corps Members House (1146148 Views)

NYSC 2019 Batch A Corps Members Thread / NYSC 2018 Batch A Corps Members House / NYSC 2018 Batch A Corps Members House (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (20) (21) (22) (23) (24) (25) (26) ... (835) (Reply) (Go Down)

Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by segunk1(m): 5:21pm On Dec 12, 2016
bussieboi:
where al dis ushers sef

I give Una easy job to arrange pple, Una no fit!

see as church scanty!
I no fit preach for dis kin church oo,

make Una get up go do evangelism carry pple enta here,
we need deir offering and tithes to go do Christmas for dubai, den london.

See this one.

Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by segunk1(m): 5:28pm On Dec 12, 2016
arewatech:
Toh, na faso. Barka da yau.

Abdullahi Ibrahim
Katsina/Kaduna
Kano university of technology.
Mechanical Engineering.

It's nice joining you people.

Welcome oga danlami, pls find me goro for ya pocket diah before you waka far.

2 Likes

Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Bashnigga(m): 5:58pm On Dec 12, 2016
Mexyz:
Mogbe, what's the tithe sir?
meet bussieboi to tell u how much, he wants to go to Dubai & London
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 8:19pm On Dec 12, 2016
my guys i hail una, is not easy to always remember that you have a family here. Some nigas just d read d go and no wan comment, kwantinue! I d fear for this our ministry for 2 reasons, 1) Visitors/ newcomers go d wander if this na just gay fellowship? if I read previous and the current batch thread, i no come understand if our case d different for bad o? 2) Segunk1, you will agree that it looks like this batch no go pass 1000 pages ni, we fit no even get up to 1m views, Anyway I gree say time still de but no be with this our style o. Na 2016 batch A family own d thrill me, d still d post up to now sef, their girls and "Segunk1 girls" know whatsupp, d are dope.
Guys I wish i can bottle all of una for the good job so far, anyway i look forward to doing so for una wey i go jam for either black gold camp or mangu camp next year "god willing". Ma una d prepare o, by Jan/Feb work go serious for here o, no dulling!. Kai! my bad luck be say, my galaxy note 3 of just 2 years screen broke on Saturday night, na my rubbish itel iPad i just d manage now o, d phone d dull me like Buhari. Anyway i go always de here

1 Like

Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 8:33pm On Dec 12, 2016
Ehen! come, all of una, i no know wetin una d do o, una suppose enter comedy industry o on a serious note. Segunk1, Bashnigga, Bussieboi, mexyz, philgbeee, ehmmmmm, wia una monikers sef! Una d make me chuckle loud here o
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Mexyz(m): 9:30pm On Dec 12, 2016
Chriswazo:
Ehen! come, all of una, i no know wetin una d do o, una suppose enter comedy industry o on a serious note. Segunk1, Bashnigga, Bussieboi, mexyz, philgbeee, ehmmmmm, wia una monikers sef! Una d make me chuckle loud here o
Bros naso we see am o... I greet you sir.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 10:24pm On Dec 12, 2016
Mexyz:
Bros naso we see am o... I greet you sir.

Greet you too bro
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 10:25pm On Dec 12, 2016
Mexyz:
Bros naso we see am o... I greet you sir.

I greet you too bro
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Philgbeee(m): 12:11am On Dec 13, 2016
Chriswazo:
Ehen! come, all of una, i no know wetin una d do o, una suppose enter comedy industry o on a serious note. Segunk1, Bashnigga, Bussieboi, mexyz, philgbeee, ehmmmmm, wia una monikers sef! Una d make me chuckle loud here o
jobless has made us discover our talent...show me the way to the industry fa..
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Philgbeee(m): 12:16am On Dec 13, 2016
Chriswazo:
my guys i hail una, is not easy to always remember that you have a family here. Some nigas just d read d go and no wan comment, kwantinue! I d fear for this our ministry for 2 reasons, 1) Visitors/ newcomers go d wander if this na just gay fellowship? if I read previous and the current batch thread, i no come understand if our case d different for bad o? 2) Segunk1, you will agree that it looks like this batch no go pass 1000 pages ni, we fit no even get up to 1m views, Anyway I gree say time still de but no be with this our style o. Na 2016 batch A family own d thrill me, d still d post up to now sef, their girls and "Segunk1 girls" know whatsupp, d are dope.
Guys I wish i can bottle all of una for the good job so far, anyway i look forward to doing so for una wey i go jam for either black gold camp or mangu camp next year "god willing". Ma una d prepare o, by Jan/Feb work go serious for here o, no dulling!. Kai! my bad luck be say, my galaxy note 3 of just 2 years screen broke on Saturday night, na my rubbish itel iPad i just d manage now o, d phone d dull me like Buhari. Anyway i go always de here

maybe you should try NokiaA17..na attach Internet follow am come but u go need go Nokia office to configure am grin..anyways its to early to speculate how many pages this thread gonna reach..I know by March it won't longer be like all guyz angry
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 12:17am On Dec 13, 2016
Philgbeee:

jobless has made us discover our talent...show me the way to the industry fa..

Lol, i wish i get the connect bro, i 4 do something but if you put interest fa, opportunity go come. Lol
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Philgbeee(m): 12:20am On Dec 13, 2016
segunk1:


Welcome oga danlami, pls find me goro for ya pocket diah before you waka far.

no b only goro u go collect,u no go like kulikuli
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Philgbeee(m): 12:24am On Dec 13, 2016
Chriswazo:


Lol, i wish i get the connect bro, i 4 do something but if you put interest fa, opportunity go come. Lol

Broz the bottle part of ur comment,bottle of palm oil will b preferable now..you know that ingredient now cost for market
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 12:31am On Dec 13, 2016
Philgbeee:


maybe you should try NokiaA17..na attach Internet follow am come but u go need go Nokia office to configure am grin..anyways its to early to speculate how many pages this thread gonna reach..I know by March it won't longer be like all guyz angry

Lol, how much d phone be? where you see money to buy ur NokiaA17, for this buhari economy? Lol, omo me don kuku park d phone 4 im pack o, I no get strength to kill myself for anything now, person never belle full na to come d spend more than 10k just to fix phone screen, mtcheeeew!
For the page matter, I totally agree with you we gat to keep this house warm na til then. You know say this thread be common front page sometime last month, i just post one careless thing just to restore am for FP. Anyway, na poco apoco, we go achieve even if na 4k pages.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 12:45am On Dec 13, 2016
Philgbeee:


Broz the bottle part of ur comment,bottle of palm oil will b preferable now..you know that ingredient now cost for market

grin gringringrin, LWKM! Bia! who tell you i fit bottle una palm oil for this Buhari period, omo i no fit o. Imagine buying 1 bottle wey b 800 naira for market to everyone here and upon that some guys like Bashnigga no go do with 1 bottle, d fit consume up to 4 bottles. That palm oil money go produce like say 2 crates of ompa na, since 1 bottle na like 4 ompa bottles, Nawa o, even if na political campaign, e never reach that side o. **smiles**
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by segunk1(m): 12:46am On Dec 13, 2016
Chriswazo:
my guys i hail una, is not easy to always remember that you have a family here. Some nigas just d read d go and no wan comment, kwantinue! I d fear for this our ministry for 2 reasons, 1) Visitors/ newcomers go d wander if this na just gay fellowship? if I read previous and the current batch thread, i no come understand if our case d different for bad o? 2) Segunk1, you will agree that it looks like this batch no go pass 1000 pages ni, we fit no even get up to 1m views, Anyway I gree say time still de but no be with this our style o. Na 2016 batch A family own d thrill me, d still d post up to now sef, their girls and "Segunk1 girls" know whatsupp, d are dope.
Guys I wish i can bottle all of una for the good job so far, anyway i look forward to doing so for una wey i go jam for either black gold camp or mangu camp next year "god willing". Ma una d prepare o, by Jan/Feb work go serious for here o, no dulling!. Kai! my bad luck be say, my galaxy note 3 of just 2 years screen broke on Saturday night, na my rubbish itel iPad i just d manage now o, d phone d dull me like Buhari. Anyway i go always de here

Good to see you back here bro, Shebi na since wen I tell you to come join me for my DJ work na em u escape say u no fit carry speaker, u no fit carry speaker but you fit carry spoon of rice baah kare lae.

But am not really bothered about people not turning up yet cos 2016 is still on not yet ended, even stream 2 of B16 hasn't gone too so we still have more time to play, as e be say people never enter here much we need not worry much when the time comes no one go teach them bro blive me, and thank God say I get many funny blokes around make we just dey catch fun dey go jare gurls go soon port in sote una go taya. And as for the views and pages we ll sure get more than 2m views cos if you check B16 views now I think its about 7m plus or so with about 1986 pages as at this ninuite...... Them try ko? Toh the only reason they got to that point is because 2016 has been so crazy with buhari/budget/graduates/nysc/mobilization/sad news/giving people headache, 2016 has been the most controversial year for our Mr president and NYSC, you see so many strings attached that's y they got to that point initially e no suppose reach like that but I dey very much sure say we go reach them too but I Don't pray for it to be in a bad way like 2016 oooo. Ours is gonna be with good news en not with bad news.

As for ur fone yhmmm! sorry ooo, my advice be say make u go drop am for somewhere now oo cos phone accesories don cost like werey now, even my LG 3 wey screen break lasan dem say make I go bring 20k for comon screen, that's d disadvantage of using big phone accessories too na big money, I just vex go hide am for one old briefcase wey my papa dash me if d price don com down to 10k I go go bring am out can't come and kee my sef b4 2017 come.
Welcome back bro we don miss you sef.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by segunk1(m): 1:04am On Dec 13, 2016
Philgbeee:


no b only goro u go collect,u no go like kulikuli

C'mon sharrap diah! Na you I dey talk to? See yar face like rock burns. Don't worry I promise you sambisa camp for 2017 you hear mee?
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by segunk1(m): 1:13am On Dec 13, 2016
@Chriswazo no blame people wey just come to look ooo, u know say some people na luku luku bantashi.

Cc:Bashnigga
Chriswazo
Philgbee
Bussieboy..... Also people I can't remember, nice job for keeping the room warm let's just keep balling.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 1:13am On Dec 13, 2016
segunk1:

Good to see you back here bro, Shebi na since wen I tell you to come join me for my DJ work na em u escape say u no fit carry speaker, u no fit carry speaker but you fit carry spoon of rice baah kare lae.
But am not really bothered about people not turning up yet cos 2016 is still on not yet ended, even stream 2 of B16 hasn't gone too so we still have more time to play, as e be say people never enter here much we need not worry much when the time comes no one go teach them bro blive me, and thank God say I get many funny blokes around make we just dey catch fun dey go jare gurls go soon port in sote una go taya. And as for the views and pages we ll sure get more than 2m views cos if you check B16 views now I think its about 7m plus or so with about 1986 pages...... Them try ko? Toh the only reason they got to that point is because 2016 has been so crazy with buhari/budget/graduates/nysc/mobilization/sad news/giving people headache, 2016 has been the most controversial year for our Mr president and NYSC, you see so many strings attached that's y they got to that point initially e no suppose reach like that but I dey very much sure say we go reach them too but I Don't pray for it to be in a bad way like 2016 oooo. Ours is gonna be with good news en not with bad news.
As for ur fone yhmmm! sorry ooo, my advice be say make u go drop am for somewhere now oo cos phone accesories don cost like werey now, even my LG 3 wey screen break lasan dem say make I go bring 20k for comon screen, that's d disadvantage of using big phone accessories too na big money, I just vex go hide am for one old briefcase wey my papa dash me if d price don com down to 10k I go go bring am out can't come and kee my sef b4 2017 come.
Welcome back bro we don miss you sef.

Haba! you sure say na me you and am yarn d DJ work, lol, no be me o! I think say na Bashnigga.
For the page and views own, I just pray it goes smoothly o, may distraction like their earlier whatsapp ginger no disrupt am o.
Segunk1 I think say na B16 stream 2 u de?
Jeez!!!! You mean say phone accessories don skyrocket to that amount? Screen, 20K? Hmmm, I ask 1 guy wey d put music for my street here, he say ma i no budget less than 10k since d break affect both the touchpad and the screen, and the screen come be galaxy note wey d very sensitive and d write with pen, Cheiiii ayam finished o, cheii!! why e come be now this thing go happen to me o? Man get plans to execute before 31st, na him devil d give me unnecessary expenses. mtcheeeew!

Note of Advise: If you are here and your android screen d bare like that with no screen protection, you are looking for your trouble, mine had case up until September I removed the case hoping to buy new case, is just a case of carelessness on my part, say na case of highest 3k i just d postpone since, mtcheeew!.
Please let's be extra careful with our properties for this Buhari period o.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Bashnigga(m): 1:23am On Dec 13, 2016
Chriswazo welcome back... U no b babe but I haff missed u grin grin grin
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 1:27am On Dec 13, 2016
segunk1:
@Chriswazo no blame people wey just come to look ooo, u know say some people na luku luku bantashi.

Cc:Bashnigga
Chriswazo
Philgbee
Bussieboy..... Also people I can't remember, nice job for keeping the room warm let's just keep balling.

gringrin na so we see am, wetin we go do kwanu? na wetin d time be, by this time next 2 years, i don't think any of us will still be rigmarolling on NYSC Nairaland section again except for some direct and meaningful quotes, you no go see am for my profile as my active NL section, so til that time comes, my duty is to be active and participatory here.
That your "Bantashi" come sound like Buratai, fear catch me o gringrin
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 1:30am On Dec 13, 2016
Bashnigga:
Chriswazo welcome back... U no b babe but I haff missed u grin grin grin

gringringringringringringringringringringringrin, lol! omo, you wan injure me with laughter?, abeg o! gringrin
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Bashnigga(m): 1:33am On Dec 13, 2016
Chriswazo:


Haba! you sure say na me you and am yarn d DJ work, lol, no be me o! I think say na Bashnigga.
For the page and views own, I just pray it goes smoothly o, may distraction like their earlier whatsapp ginger no disrupt am o.
Segunk1 I think say na B16 stream 2 u de?
Jeez!!!! You mean say phone accessories don skyrocket to that amount? Screen, 20K? Hmmm, I ask 1 guy wey d put music for my street here, he say ma i no budget less than 10k since d break affect both the touchpad and the screen, and the screen come be galaxy note wey d very sensitive and d write with pen, Cheiiii ayam finished o, cheii!! why e come be now this thing go happen to me o? Man get plans to execute before 31st, na him devil d give me unnecessary expenses. mtcheeeew!

Note of Advise: If you are here and your android screen d bare like that with no screen protection, you are looking for your trouble, mine had case up until September I removed the case hoping to buy new case, is just a case of carelessness on my part, say na case of highest 3k i just d postpone since, mtcheeew!.
Please let's be extra careful with our properties for this Buhari period o.
In Agu's voice "I am not understanding" . I no know say Bashnigga reach 2 here o , still looking for the Bashnigga dat discussed the DJ ish wit segunk1 pls u ppl should help me search for him tongue tongue
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 1:37am On Dec 13, 2016
Bashnigga:

In Agu's voice "I am not understanding" . I no know say Bashnigga reach 2 here o , still looking for the Bashnigga dat discussed the DJ ish wit segunk1 pls u ppl should help me search for him tongue tongue


gringrin, oh! No be you? e then go be philgbeee.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Bashnigga(m): 1:40am On Dec 13, 2016
Guys we dn turn security men for this thread o, we even dey do night shift grin grin
Bia Chriswazo keep ur eyes open make I go sleep small... Remember sleeping while on duty is not allowed "over & out " wink wink
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by segunk1(m): 1:42am On Dec 13, 2016
Chriswazo:


Haba! you sure say na me you and am yarn d DJ work, lol, no be me o! I think say na Bashnigga.
For the page and views own, I just pray it goes smoothly o, may distraction like their earlier whatsapp ginger no disrupt am o.
Segunk1 I think say na B16 stream 2 u de?
Jeez!!!! You mean say phone accessories don skyrocket to that amount? Screen, 20K? Hmmm, I ask 1 guy wey d put music for my street here, he say ma i no budget less than 10k since d break affect both the touchpad and the screen, and the screen come be galaxy note wey d very sensitive and d write with pen, Cheiiii ayam finished o, cheii!! why e come be now this thing go happen to me o? Man get plans to execute before 31st, na him devil d give me unnecessary expenses. mtcheeeew!

Note of Advise: If you are here and your android screen d bare like that with no screen protection, you are looking for your trouble, mine had case up until September I removed the case hoping to buy new case, is just a case of carelessness on my part, say na case of highest 3k i just d postpone since, mtcheeew!.
Please let's be extra careful with our properties for this Buhari period o.

Oooookaaayy! Sorry no be you jare, na dat yeh yeh philgbee no wan carry speaker, say him no be big doctor (ironically).

That one no fit cos distraction as we don explain give wassap pple dem sef don take note, for fone issue I still go computer village for ikeja today, wen d guy tell me 20k ehn I say I hook my belt wella come lace my jaguar well too before I begin dey run go enter bus com house but for dat ur samsung I nono d prize ooo but still 10-12k suppose do am na year of hike we still dey na.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 1:46am On Dec 13, 2016
Bashnigga:
Guys we dn turn security men for this thread o, we even dey do night shift grin grin
Bia Chriswazo keep ur eyes open make I go sleep small... Remember sleeping while on duty is not allowed "over & out " wink wink

gringringrin, you gat no worry bro, i gat your back tonight, "no b unto homo things o" gringrin
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 1:50am On Dec 13, 2016
segunk1:


Oooookaaayy! Sorry no be you jare, na dat yeh yeh philgbee no wan carry speaker, say him no be big doctor (ironically).

That one no fit cos distraction as we don explain give wassap pple dem sef don take note, for fone issue I still go computer village for ikeja today, wen d guy tell me 20k ehn I say I hook my belt wella come lace my jaguar well too before I begin dey run go enter bus com house but for dat ur samsung I nono d prize ooo but still 10-12k suppose do am na year of hike we still dey na.

Nawa, No p bro, I go do am, one way or the other so far as there is life o.
You no answer my earlier question, are you still going with B16 stream 2?
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by segunk1(m): 1:50am On Dec 13, 2016
Bashnigga:
Guys we dn turn security men for this thread o, we even dey do night shift grin grin
Bia Chriswazo keep ur eyes open make I go sleep small... Remember sleeping while on duty is not allowed "over & out " wink wink

These niggz ehn gringringrin night shift kwa?
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 1:52am On Dec 13, 2016
segunk1:

These niggz ehn gringringrin night shift kwa?
gringrin, na so today own enter o.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by segunk1(m): 1:54am On Dec 13, 2016
Chriswazo:


Nawa, No p bro, I go do am, one way or the other so far as there is life o.
You no answer my earlier question, are you still going with B16 stream 2?

B16 Keh? No ooo no be wen I no see my name for senate list I come buy mansion for here jeje nii.
Re: NYSC 2017 Batch A Corps Members House by Chriswazo(m): 1:58am On Dec 13, 2016
segunk1:


B16 Keh? No ooo no be wen I no see my name for senate list I come buy mansion for here jeje nii.

gringrin, same here o, anyway this our estate go better pass theirs hopefully.

1 Like

(1) (2) (3) ... (20) (21) (22) (23) (24) (25) (26) ... (835) (Reply)

NYSC 2014 Batch C House / NYSC 2016 Batch B Corps Members House / NYSC 2016 Batch A Corp Members House

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 80
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.