Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,205,861 members, 7,993,965 topics. Date: Monday, 04 November 2024 at 11:27 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Some Common Nigerian Pidgin Proverbs (97158 Views)
Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. / Some Nigerian Pidgin Proverbs / 8 Nigerian Pidgin Words That You Probably Did Not Know Are Proper English Words (2) (3) (4)
Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by NLban: 9:29pm On May 02, 2017 |
Pidgin Proverbs 1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin. 2. Woman wey never see problem.. Na im dey still hold breast run. 3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep. 4. Rat wey follow lizard enter rain, na later é go hear am. 5. Na for afternoon dem dey find black goat. 6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg. 7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD?. 8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march? 9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far. 10. Person wey don faint before no be stranger to death. 11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see. 12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains. 13. Yansh no get teeth but e dey cut shit. 14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself 15. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, NA SHE SABI. 16. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck. 17. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside. 18. Pikin wey say him mama no fine dey use style call him papa blind man. 19. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat. 20. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch. 21. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open. 22. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK. 23. Dem no dey tell tortoise say race don start. 24. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food. 25. Before you see monkey, monkey don see you. 26. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again. 27. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury. 28. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am. 29. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze. 30. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am. 31. My thing and our thing no be the same oh. 32. Na happiness dey make prick stand. 33. Na as goat stand for market dem dey price am. 34. Craze no hard to form, na the trekking be wahala. 35. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London. 36. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans. 37. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup. 38. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap. 39. Akara and moi moi get the same parent, na wetin dem pass through make dem different. MY PIPUL UNA FIT ADD UNA OWN O! #Copied#. 118 Likes 22 Shares |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nixiepie(f): 9:39pm On May 02, 2017 |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by PopeExplicit(m): 9:46pm On May 02, 2017 |
hahaha |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by StarBukola(f): 9:57pm On May 02, 2017 |
Googoo gaga 2 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by oloriooko(m): 10:06pm On May 02, 2017 |
Laugh and learn 4 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nobody: 10:17pm On May 02, 2017 |
Omo ti o ni iya ki n dobo eyin... Pikin wey no get mama no dey doggilitate 6 Likes 1 Share |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nobody: 11:19pm On May 02, 2017 |
Na from clap dem take dey enter dance. 19 Likes 1 Share |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by AlamienDagash(m): 11:59pm On May 02, 2017 |
Lemme laff |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Richdotcom: 12:44am On May 03, 2017 |
No be power then take dey stand prickkkk Dey no dey use prick test cutlass jazz Pikin wen never strt market say gain wan kill am If 1 mouth reject food, anoda mouth go chop am 45 Likes 2 Shares |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by NLban: 11:24am On May 05, 2017 |
Lalasticlala, Seun when will you move these proverbs to FP? We need laff off the stress of the recession for the day. 1 Like 1 Share |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by GoodBuhari: 11:27am On May 05, 2017 |
NLban:When you stop posting trash and calling Lala. Na joke ooooo Frog food no de climb tree 4 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Reginna: 1:21pm On May 05, 2017 |
Who no go no know 2 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Lilaex: 1:22pm On May 05, 2017 |
na persin way get confidence for the strength of hin anus na hin day swallow coconut 8 Likes 1 Share |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by robosky02(m): 1:22pm On May 05, 2017 |
ok Man wey naked no dey put hand for pocket loose translation: You can’t do somethings if there are no certain conditions. Chicken wey run way from borno go Ibadan go still end up inside pot of soup loose translation: You Can’t Run Away From Your Destiny Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap loose translation: Keep calm! Nothing last forever Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef loose translation: Just be patient. Let the game come to you. Don’t rush! Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem diffrent loose translation: How you start doesn’t matter, what matters is how you finish. To piss no hard but fowl no fit. loose translation: It’s easy doesn’t mean everyone can do it. NO matterhow dark room wan be, man go still locate woman breast. loose translation; There is always a way when something matters much. Custard na just pap wey jand loose translation: Appearances are often misleading. – Looks are decieving Wetin concern agbero with twitter handle or malu with face cap? loose translation: Mind your business. If life dey show you pepper my guy make pepper soup loose translation: Make something good out of a bad experience I get am before no be property loose translation: Stop living in the past and start living in the present. If person too tey for party e go follow dem wash plate loose translation: Don’t outstay your welcome Rolling stone, of course na person push am now! loose translation: There is always a reason for something Craze no hard to form,na the trekking be wahala loose translation: Easier said than done No matter how hot your tempa be,e no fit boil beans. loose translation: Calm down,your temper won’t solve the problem Every mallam with em own kettle, every aboki with em own radio. loose translation: Every man for himself You no need cutlery to chop slap loose translation: You don’t need my translation to understand this Opolo eye no be open eye loose translation: Having Big eyes doesn’t make you civilised Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus. loose translation: Let sleeping dog lie Bring suya, bring suya….na cow body dey suffer am. loose translation: Every action has a consequence E go better na e go better, na im make ibo man still dey Kano loose translation:When there is hope,there is Life. Escort me, Escort me, na im slave trade take start. loose translation: Serious things sometimes start like joke Na from play play dem dey form PLAYER loose translation: Serious things sometimes start like joke Pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old. loose translation: Slow and steady wins the race The water wey dem use take make eba can never be recovered back. loose translation: Don’t cry over spilt milk Nearly no dey kill bird. loose translation: It’s either you have it or you don’t Fly wey no get special adviser na im dey folow dead bodi enta grave loose translation: Don’t stay ignorant No matter how lizard dey do press up e no go get chest like aligator loose translation: Be proud of who you are The cassava today fit be gari tomorrow loose translation: No condition is permanent If mad man don beat ur mama before,if she see mechanic she go run… loose translation: once beaten twice shy Jollof Rice wey dey for d bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro loose translation: no condition is permanent Fowl wey dey carry for head no dey know say to waka na work. loose translation: A dependent would not know the value of what he/she is enjoying. Na from clap dance dey start. loose translation: Big thing don’t happen suddenly! 116 Likes 9 Shares |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Partnerbiz2: 1:22pm On May 05, 2017 |
That ashawo part though |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nobody: 1:24pm On May 05, 2017 |
LOL |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by AkinPhysicist: 1:25pm On May 05, 2017 |
Okpolor eye no be open eye 4 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by toseen7: 1:26pm On May 05, 2017 |
MykOnyxo:Ha! Jesu! Baba your own translation get as e be o.... 9 Likes 1 Share |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Louiscutedude(m): 1:28pm On May 05, 2017 |
Dat na 9ja for uuuu |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by xtera27: 1:28pm On May 05, 2017 |
Owk ooo 8 Likes 1 Share
|
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by sotall(m): 1:29pm On May 05, 2017 |
ok |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Jimbiz(m): 1:30pm On May 05, 2017 |
Number 2 got me |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nobody: 1:31pm On May 05, 2017 |
They all got to me...and cramming done dey happen... 4 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by toseen7: 1:31pm On May 05, 2017 |
Person wey borrow cloth go party no suppose dance too much.... 12 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by nkemdi89(f): 1:32pm On May 05, 2017 |
No be all cloth dey dry for sun, meaning some issues are meant to be kept secret. 7 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by VeniJu: 1:32pm On May 05, 2017 |
No matter how high u get, you can never be the Most High. 2 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by homopoliticus: 1:32pm On May 05, 2017 |
Na pesin wey get money na him hin prick dy stand 2 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Noblemarce: 1:33pm On May 05, 2017 |
[color=#990000][/color] Na small small monkey dey turn chimpanzee 2 Likes |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by 3RNEST(m): 1:33pm On May 05, 2017 |
lolx |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Justuceleague2: 1:34pm On May 05, 2017 |
He don red |
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nobody: 1:35pm On May 05, 2017 |
5 Likes
|
If This Guy Refuses To Pay After Eating, What Will You Do? (Photo) / Funny Pictures Of The Day / Funny Pix!
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 27 |