Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,206,113 members, 7,994,782 topics. Date: Tuesday, 05 November 2024 at 08:24 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest (38820 Views)
Words From The Epie Language Of Yenagoa. / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up / Pidgin Words, Meaning And Origin You Need To Know (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply) (Go Down)
Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 8:15pm On Sep 29, 2018 |
Ehehn! Why I open this thread be say everybody don de too Binu for Pidgin leadership for this Naija as e stand. So now ehn I wan make we for do proper Pidgin Battle. Una de hia me so! I de rep Yenagoa. I lap this thread ruggedly. so make una kpompi small, make I for be Judge. Oyaaa! Show una Self! The Rules be say. wen pesin throwey Slang come another person go try decode am if e no fit then im fail I go de give points according to person weh trowey slang pass and pesin weh decode slang pass! 34 Likes 3 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by cooldipo(m): 8:16pm On Sep 29, 2018 |
I wan learn 20 Likes 2 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 8:18pm On Sep 29, 2018 |
OK sure say your mendolla fit chest am 19 Likes 3 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 8:58pm On Sep 29, 2018 |
Okay na me de start am Abobi Na so e go o! Yesterday me and Padimina bin lap im Wari , tanda for I'm Veranda. we bin de plan to go Lap Ozed junction carry small pololo make man no Kon go de rub mej for night. nai before we knw Area Men for the Area Kon start Para nai we GATS sub enter im hass (House) o. Nai wen tins don jant small nai my Bross Kon go say im wan go sight how the outside be o. Nai Ojo begin bust out. Dive am say I'm mus join for the Boys wen just raks na na. No be small tin o now my Padiman de Sanko as e stand so. But Sha as I reach my way DAT Night, My Banni lap me. Omo she fear kpanshin 149 Likes 7 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 9:14pm On Sep 29, 2018 |
First of all I rep Benin As for the pigin matter nah we Benin invent am ..Benin is the home of pigin infact e everything for benin nah with pigin,baba the matter serious ooh..I swear bayelsa they learn, davido admit for Benin radio station say skelewo nah slag for Benin 45 Likes 6 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 9:25pm On Sep 29, 2018 |
Jesse25: We Yeniz Men no de buga plenti. but Bross I sure say Waffi men go follo you Nak teeth for that yan. and Padi man try decode my pidgin weh I nak dia nor vex. 91 Likes 4 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 9:38pm On Sep 29, 2018 |
cooldipo:Sure say your Mendolla fit chest am! 14 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Anduku: 5:39am On Sep 30, 2018 |
Nonsense 8 Likes 3 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 12:47pm On Sep 30, 2018 |
Anduku:Wetin be ur own wahala 51 Likes 1 Share |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 12:57pm On Sep 30, 2018 |
Anduku: OK its rubbish but you still wasted your time commenting on it just to follow it. Ofurukpe Nigga 113 Likes 3 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 1:23pm On Sep 30, 2018 |
Sinistami:When you don knack para finish let me know, I go complete am for you, well sha happy Sunday 4 Likes 1 Share |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 1:25pm On Sep 30, 2018 |
Jesse25: No shakin na Happy Sunday give u back 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 1:28pm On Sep 30, 2018 |
Sinistami:No take it back in full.... 6 Likes
|
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by tonzo(m): 7:47am On Oct 01, 2018 |
Pele(sapele)naim be d ogbonge home of pidgin langua How Una Marra be for here sef No be say dem say ,I rep waff city.happy miliki to our obodo naija today. As we dey shayo today make we use we ankaras take do evri sofri sofri.ekelebe no get say to dey if dem do anyhow dem go do go collect anyhow. Driver dropping dey,make I enta Hausa quarters go change 100dolomi to naija kpogiri I hail all the Sabi people for this Kuban 133 Likes 7 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 2:09pm On Oct 01, 2018 |
tonzo: I Sight you! Your face de Show Boloko I de feel Your yans scatter for this Obodo Bayelsa weh I tanda so. but make I try decode that Yan wen you yan for there sha. Sapele is the real home of Pidgin. How are you people here? Its not that I rep Warri city. Happy indepence day to Nigeria. As we are partying let's use Ankaras and do everything Softly. The police don't have a say because if they do it's to they own detriment. Driver I need to come down let me go into Hausa quarters and change a 100 Dollars to Naira. I salute every knowing person in this Thread. 71 Likes 5 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Ishilove: 3:02pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami:You speak in esoteric tongues... 13 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Ishilove: 3:05pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami:How on Earth did you decode that?! My eyes glazed over halfway through 11 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Anijay1212(m): 3:24pm On Oct 01, 2018 |
Chisos !!! See as boys dey lap pidgin like say notin dey happen. Dis one wey i see so e mean say nah o level i still dey o... Wait o... Na who dey misyarn under me so abi Bubu purshu am for dream,but i suspect say im village people dom pay am visit or my weight dey press am too much on top im head. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Samsimple(m): 3:25pm On Oct 01, 2018 |
This tread is as lifeless as our president.. *spits* person wey quote me make e remember say "yansh no get teeth but e dey cut sh!t" 25 Likes 1 Share |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Livebygrace: 3:25pm On Oct 01, 2018 |
Pigin galore |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by OBTMOS(m): 3:26pm On Oct 01, 2018 |
We.die here 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Jerrick(m): 3:26pm On Oct 01, 2018 |
This is promising 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by SocialJustice: 3:27pm On Oct 01, 2018 |
Jesse25:Go sit down one place. Bini boys speak Bini, them no sabi pidgin. When them dey parliament, you no go ever hear pidgin only bini 16 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Righteousness89(m): 3:27pm On Oct 01, 2018 |
Ty |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Amberon1: 3:27pm On Oct 01, 2018 |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 3:27pm On Oct 01, 2018 |
Oh na na na na, omo, its Paper boi, you know the voltage nah It’s your boi Erigga Paper boi & Graham D baba Omo E get wetin play when ah go Accra recently mehn! Ah nor fit yarn am, so ah gats put, ah gats express am through music you understand About my guy Okiemute Okiemute say like this he wan go join HK For Accra nothing dey him hand only 10k Eribaba believe me ah nor be JK Before ah waka we fit gather smoke your SK As we dey smoke ah tell am say na Akanuche E work for me nor mean say e go work for Uche He say Erigga lock up, who I wan follow pench Na my real guy beside, ah dey expect one cash On he way to Lagos he receive alert Family land na he sell the boi too get heart Enter Accra, he guys dey hail am Bossu He nor dey hustle every night steady bottle If dem wan cook for house nai him dey go withdraw Small small big Man for Accra don poor Nobody tell am around 10 o’clock for night Dem send am message lock gate, fling him things outside Habeg!!! According to brother Shaggy Oyibo talk say, patience na virtue is okay thank you The same kpo wey we smoke write better music Some other artiste smoke am wetin dem sing stupid Are you feeling me? Or should I repeat No be everybody be your man inside this street Boiz don fall person because of yeye pick up For my present police throw am for pick up Okiemute come area we ask am wetin sup For like 2 days ah swear my guy no gree talk Only to hear say he say where dem carry am go Dem give am knife shook mirror but nah him mama show He say he nor fit use him mama na him make am discharge Say around 10 o’clock for night he enter road come Lag Forgetting say everything wey dey happen for Accra, area don hear the real gist ah wan laugh belle scatter Because E work for Mr A like that No mean say E go work ki for Mr B like that Because your friend travel go Ghana en make him money You think say if you travel you go make am too Use your sense waka no be leg The hustle wey we dey so na God abeg If not for the Streets, boiz for dey beg Na only God fit to change leggedis to Benz Note: this song is dedicated to all the Great men out there and also through all this inspiration some of us are living gracefully now Work and pray. 31 Likes 2 Shares |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by gaby(m): 3:27pm On Oct 01, 2018 |
Lol... No keys to take kpokish di original pigin slang for all d keyboards wey dey d world... 3 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by eendy(f): 3:27pm On Oct 01, 2018 |
Na warri nai pidgin English take hand teh touch ground... e get how go even tidy the pidgin pass enh you go weak for yoursef ... I wonder why kpomo men go dey bring this kind argument. if warri use pidgin take tidy matters for you... you go feel am 13 Likes 1 Share |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by ehis05(m): 3:28pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami:chai dis one is strong 4 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by SoftP(m): 3:28pm On Oct 01, 2018 |
See all dis ofurukpe wey never taste street dey drag oil with Warri... For warri to dey dat list naa under rating Ishii 24 Likes 1 Share |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by BruncleZuma: 3:28pm On Oct 01, 2018 |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply)
Ooni Of Ogunwusi Visits Badagry, The First Storey Building In Nigeria / What Is The Bride Price In Your Own Hometown? / Yoruba Cultures - What You Want To Know! And What You Do Know!
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 41 |