Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,201,164 members, 7,977,376 topics. Date: Thursday, 17 October 2024 at 07:05 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. (2413 Views)
Have You Ever Been Threatened Before? Share Your Experiences / What Broke Your Trust With Friends? Share Your Experience / Share Your Experience With Weird People You Have Encountered (2) (3) (4)
Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 5:49pm On Aug 01, 2020 |
Please Note: This epistle is written in Nigerian pidgin. . My own no bi long tori. When I bin dey primary school I go challenge one slim girl. I can't remember what she did to me. My mind bin yarn me say I go beat craze comot the girl body. O boy, I say make I handshake am come press the hand, the girl hand bi like iron, na she come press my hand so tey e pain me I carry person lunchbox take stone am. . Ha, she promise me say she go wait me for road design my body. I tell am she dey kolo say till then. I just say am because I no want make people see me as coward. . Bros, as school dey wan close, I don dey reason the fight. I try make I make peace for school with am secretly, babe tell me say na fight e must end. . We don dey go home na, me self don dey forget the fight. Naim I see person jump out from bush (na Lola o). I sincerely bin wan just apologize go home but as I see my corner don dey gather with other pupils and students (and one useless boy always adding salt to injury cos he wants to see a fight), mehn dude gatz take his stand. We begin rumble. I try to fling this girl, she stand like rock gidibam. . Next tin be say she don carry me for air land for ground. She come sit on top me reconstruct my jugular vein. She use her iron hand beat craze comot for my head. Finally come put sand for my mouth. I wake up for school sick bay. In fact, for school sick bay, students gather me. I dey awake but close my eyes in shame. . I literally couldn't enter my class for two weeks because of shame. When I did after then, I had to lie I had an operation and that was why I couldn't do zilch cos the operation was new. . Did I prove my lie? Of course. I carry two-by-two one day break her head like madt. . Enough respect. . . Now to you.. . Person don beat you pass wetin tinker beat pan before? Please make u share ur experience. No dulling. Abeg make you use pidgin arrange your tori. 1 Like |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Vyzz: 6:01pm On Aug 01, 2020 |
Remember the time I had to fight with twins.... I was fighting with one then the other join.... Me that can't even beat one of them was fighting both... I took a straight ass whooping that day... ThankGod I survived 2 Likes |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 6:03pm On Aug 01, 2020 |
Vyzz:Tell me the part where you ran bro! I love to read that part. 2 Likes |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 6:13pm On Aug 01, 2020 |
farano, Rocktation, Lalasticlala, Mynd44, Dominque , Seun na fp matter. |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by StephenBB(m): 6:43pm On Aug 01, 2020 |
This thread go make sense
|
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nicoddemus(m): 6:47pm On Aug 01, 2020 |
. |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by JOACHINpedro: 6:54pm On Aug 01, 2020 |
2007 the year one fine girl beat me black n blue |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 6:56pm On Aug 01, 2020 |
chatinent:You think all of us can read pidgin? I understood nothing you wrote! |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 7:18pm On Aug 01, 2020 |
Well I never chop beating but make I share this story on behalf of an ex. So he get this particular guy I dey do lovey dovey with that time, dude been dey do anyhow but a Belle wey dey in love I dey overlook him error., Naso one day like that sha, I visit am, guy come say make we do the do. As person wey never do am before, I bone face guy come dey yarn trash like say Na him mama give me pussy. Long story short, baba give me ultimatum, sex before next week or no relationship. Omo I vex that day ooo. I come dey ask myself wetin I dey do with this otondo, to add salt on injury, him come vex leave me for room go dey gist with him friends. Chai! Na so my papa house own enter me, park my bag, wear my shoe dey go my house around 10:45 pm. I just go home go crash on top bed. A week later guy see me for street, guy's face be like say him jam trailer. I come pity am ask am wetin happen. Na so baba gimme story lol. That night wey I leave him place ehn, him come back inside no see me. Him come tell him friend say make them trace me come my house, naso some people jam them for street, beat them like mad come call them thieves. Chai! The beating no be here , Na him friend I pity pass, I apologise to him Sha, but as for that my ex ehn nah bitter sweet feelings for me. One part of me dey pity am, other part dey talk say good for am. Well I stayed for the relationship for a month Sha, but finally break up when he cheated. That beating though I saw pictures he took ,I come dey feel for am. |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:18pm On Aug 01, 2020 |
Dew04:Don't worry, I'll translate it to you. . I'm clearly narrating how a stronger girl than I was in my class back in primary school waylaid me on my way home and gave me the beating of my life, which landed me in the sick bay. Ashamed I was, I lied I had an operation -- conversely saying that was why the girl beat me. I had to prove it to my undeserving mates by using a 2x2 plank on her head then. Lastly, I was urging others (like you) to also share your experiences if you've been beaten before. . You are welcome. 1 Like |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:24pm On Aug 01, 2020 |
StephenBB:Baba, narrate urs ni. |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by illicit(m): 7:31pm On Aug 01, 2020 |
the night one guy tear me thousand slaps from behind as I dey toast him toastee..... hmmmm Dude come run away. I no fit open my eyes for one week anytime sun dey shine.... I no fit forget but I do my own back Sha... |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 7:38pm On Aug 01, 2020 |
chatinent:lmao! thanks! As for me, I've never been involved in a fight. Learn to settle differences with words, okay? |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by paulolee(m): 7:39pm On Aug 01, 2020 |
remember the day i fight last for street.. |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:40pm On Aug 01, 2020 |
Dew04:Oh, I settle differences amicably now. This happened many many years ago. You are welcome. |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 7:45pm On Aug 01, 2020 |
Back then When I wasn't a real niga One motherfucker use his level to outsmart me but although I still stand my ground but I chop ponch that day no be small But now zini head don turn if I see say you go big like Goliath and I no fit beat you omo na to carry weapon O |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 7:56pm On Aug 01, 2020 |
JOACHINpedro:This life no balance Na girl beat you Maybe you're not feeling fine that day 1 Like |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by JOACHINpedro: 8:41pm On Aug 01, 2020 |
ZINIBANKS:Lol. I was smaller then |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 8:41pm On Aug 01, 2020 |
JOACHINpedro:Oh OK I thought as much |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by sholikay(m): 9:09pm On Aug 01, 2020 |
Lol..funny thread..my own be say na 2 times girl don beat be back to back..the first one na when I dey primary school, e get one hausa neighbour daughter, her name na "iyanatu" I no know if e correct..I dey make mouth for this babe say I go beat her like mad..my mouth loud gan, I dey flex muscle untop..lol...nasoo!... One day pipul for hood just leave 2 of us to fight, nasoo we start am..omo this babe just carry me for up show baba God, iyakata, I don land for ground..she come climb me dey punch me seriously, nasoo people come rush seperate us...shame catch me, but I no still stop to dey get mouth or threaten her further..my friends use me laugh for days.. The 2nd Beating na for ss1..the girl sef panel beat me no be small walahi.she get body pass me, kuz I be smallie those years... but now, I No even like wahala..anything fight like this, I go run oooo...both male and female.. 3 Likes |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 9:56pm On Aug 01, 2020 |
Lol |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Reex12(m): 10:08pm On Aug 01, 2020 |
Never been beaten |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Ejenavi18(f): 10:33pm On Aug 01, 2020 |
Dem never beat me before, I be gentle girl, I nor get power to fight naim make I dey do my things jejely to avoid trouble especially from those class bullies wen I still dey secondary school and my troublesome childhood neighbors. 1 Like |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Majikman(m): 10:56pm On Aug 01, 2020 |
Lmao. .. my own nah play turn fight For boarding school dat year I dey jss2 ,I go dey use play slap my senior for ss1 run.. omo wen d guy catch me , e be like say him put all the slap together load me for face . my eyes comot water ... other students con dey yarn am say why him go slap me like dat nah. I no know wetin enter me oh , from back I con go load am again ... cheiii d guy Chase me go front of hostel , nah Dere my own finish. 2seconds I dey floor dey chop premium beating ... Pple con carry d guy comot my body ... me sef still stand up dey tell am say him get luck (which luck? Nah me get luck oh )... Since den I dey avoid fight like plague oh 2 Likes |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Kvvngkhalifa202(m): 11:13pm On Aug 01, 2020 |
illicit: 1 Like
|
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by YoungLionken(m): 11:16pm On Aug 01, 2020 |
Lol |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Dreyton36: 11:24pm On Aug 01, 2020 |
I don get many experience for beating na , make I just share one only Base on the Edo boy wey i be ,one night cultists they fight and me I don sleep go because I don play ball tire I just hear shouts , I come wake up say make I know wetin they happen outside because my house face road side Sleep still they my eye sef , naso somebody just land me correct wood for head , my neck stiff straight up I come try to look back , I see soldier uniform , Soldier : Kai move idiot Me: oga wetin i do Soldier: move , stupid cultist , na so slap just they enter my body from different angle Las Las the soldier carry me go meet their oga for junction And streetlight they there , many people they sell roasted corn there and E get this particular women wey dey always warn me to stay off her daughter She just shout yes , beat him , he's one of them , mogbe The rest na story 3 Likes |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:28am On Aug 02, 2020 |
illicit:Lol. What did you do as retaliation? |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:30am On Aug 02, 2020 |
ZINIBANKS:What's this thing about being a real nigga? It's surprising how you attached bad definition to your gentlemanliness. |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:31am On Aug 02, 2020 |
sholikay:Baba, just kuku kee me. Lol. |
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:33am On Aug 02, 2020 |
Ejenavi18:You dey form gentle girl when we dey with you but you'll still go home and beat your siblings to stupor. Lol. |
Nigerian Talent Shows 2018: List Of Talents Shows And Competitions In Nigeria / Are They(ladies) Too Demanding Or We (guys)dont Provide Enough? / Hot-angel, Nike4luv, Wesleyana, Etc: Are They Jobless?
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 63 |