Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,189,137 members, 7,936,530 topics. Date: Saturday, 31 August 2024 at 03:30 PM

My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... - Crime (485) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... (3227369 Views)

"New Generational" Aye Cult Member Addresses His Colleagues In A Viral Video / Ikorodu Cult Group Kills A Rival Cult Member (Disturbing Video) / My Story As A Cult Member, Initiation Phase Included (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (482) (483) (484) (485) (486) (487) (488) ... (649) (Reply) (Go Down)

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Omahlaycha: 10:45am On Jan 30, 2021
All ds ones una two above me just yarn dey somehow for ear, we dey say no to cultism, say e better to b ju cos freedom of mind go dey because nothing concern ju wt hit as nothing concern okada wt seatbelt, bt una dey talk say even ju go dey affected so mk we condemn being a ju&kuku join d confra ni? Op&many others don talk say as we dey say no to cultism, mk we stil avoid dia frndship e get why. Bt wetin una two just type fnsh laidis show d consequences of befriending cultists wen b say u b ju instead of avoiding wahala mk wahala sef 4 avoid u. Mk we dey use our head4dz tread o cos sm pple dey bkground dey reason how to reverse d purpose of d tread wt style. @Greenarrow1 don talk am fnsh for him last post

8 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by hatchetman(m): 12:58pm On Jan 30, 2021
Why you go Say no to cultism, come begin dey happy when dem dey count scores?

4 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ekene101: 1:08pm On Jan 30, 2021
Omahlaycha:
All ds ones una two above me just yarn dey somehow for ear, we dey say no to cultism, say e better to b ju cos freedom of mind go dey because nothing concern ju wt hit as nothing concern okada wt seatbelt, bt una dey talk say even ju go dey affected so mk we condemn being a ju&kuku join d confra ni? Op&many others don talk say as we dey say no to cultism, mk we stil avoid dia frndship e get why. Bt wetin una two just type fnsh laidis show d consequences of befriending cultists wen b say u b ju instead of avoiding wahala mk wahala sef 4 avoid u. Mk we dey use our head4dz tread o cos sm pple dey bkground dey reason how to reverse d purpose of d tread wt style. @Greenarrow1 don talk am fnsh for him last post
oga u got d whole point wrong,we only replied those saying the fight should continue because they believe as they are Jews,nothing fit happen to them forgetting that what affects head also affects the eyes and ears too. even d peaceful protest,innocent people got hit talkless of confra war. so praying for the war to continue thinking that the innocent will not be affected is wrong,we should all sue for peace not praying for people to kill each other and every sensible person will know its safe to stay away from people of questionable character. there is a saying "the friend of a thief is also seen as a thief too" shey u get now?
if war no dey,nobody go fear for anything,na only who dey cult go dey fear make them no use am start war,Jew no get anything to worry about.when my brother later rent him own house,he get rest of mind,no fear of say roommate fit dey game dey hide. make anybody no go join cofra,being jew is still d best as u fear less than being a game boy. as I dey now sef I no get friend,not even one. na how far,how far I get with area people. nothing like say I go stand dey reason with anybody for anything make person no go think say I dey game con dey hide dey pay dues but no won cast myself. to stay Edo state and survive,guy man gats use brain+wisdom together.

11 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ReligionofPiss: 1:51pm On Jan 30, 2021
freshkpomo:
Those of you saying you are Jew and so the war should continue cos it does not affect you. Let me tell you this, each full blown cult war usually claim at least one Jew. In Benin currently, Jew when Don die go Don reach 10 if not more than.. That's the one I have heard o, what of the one never hear..

One borrow him friend car who was already mapped, as the guy drop say make him open gate, them give am for back, na right there my guy die. As them be way confirm am na him them notice say na wrong person.

Another one mistake flat description go kill wrong person, another go the guy room kill him babe and babe sister, another kill him brother, another kill him guy when dey wait for am for room.

The one when happen for Oguola along siluko area, as the guys drop begin chase their targets, people begin run, One guy still sit down saw after all him na Jew, na there one of the 6 guys from back slash him head open, towards him neck, another shoot the guy to make sure say him die finish, na the guy when dey back come observe am dey shout nor be him be this, but last last who Don go Don go.

Eiye also beheaded a Jew some time ago around textile mill area.

Around egor area, another Jew had his head split open while returning home with his friend at night, people woke up to see his dead body. Stray bullets have hit some Jew in upper area.

Also heard some of the killers arrested have pointed some police men to be part of their squad.
exactly, Jews are mostly affected too.
E get one video here wey eiye dey go on Killings, as them miss their target them Carry that vex go meet jew man for ugbioku upper ekenwan na so Dem descend on am.
Even shops and businesses owned by jews go closed for safety

7 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Omahlaycha: 1:56pm On Jan 30, 2021
Dem don dey surface small small. If we preach say no to cultism fm now til dem blow final trumpet, confra go stil count scores, na constant k 4 dia constitution. Even dem sef no want peace cos dem dey count scores during peace talk. D koko of d matter b say na d death wen dey follow cultists upandan dey mk pple avoid joining if not pple 4 think say na just flexing involve as celebrity members dey paint am, cos frat&sorority dey abroad, no comparison wt naija own sha, but mk u go join cm begin count scores&see as dia law go rubbish u. We just dey advice doz wen stil b ju to keep flexing dia ju life&flee fm cultism, nothing go concern u wt hit&also doz wen dey game but stil get conscience to change, bt doz wen feel say ruggedity na dia identity&carry cult 4 head, mk dia careless death b more than enough reason to say no to cultism as na d reason we dey always update d tread wt hit&livescores, so anybody wey e dey pain, mk him go use himself count scores, na good riddance&natural selection as person don alrdy talk am 4 wetin I quote down

Princeofasia:
every cultist is a potental killer and a potential dead man.

Princeofasia:
as a cultist wey u be, death is sure for you. i know say that one connect your brain. even if you denounce, , e still sure for you

Princeofasia:
guy as a useless hard man wey u be, u go die like fowl, them go use u count scores and we go dey here to hype am for nairaland. i repeat every cultist is a walking dead man. if e pain u close the thread

Princeofasia:
you called death to yourself the very day you became a cultist. like i said all cultist are potential dead men walking.

Hope u no b kk, d person sabi himself

1 Like 1 Share

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by okrikaboi: 4:05pm On Jan 30, 2021
Everybody dey claim jew for the thread all of a sudden. Some dey tell us how the cult war na to kill all Street cultist/touts so that confra go civilise. Y'all should do what you can to make life a better place for someone at least one person before you die

4 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Sennex57: 4:17pm On Jan 30, 2021
okrikaboi:
Everybody dey claim jew for the thread all of a sudden. Some dey tell us how the cult war na to kill all Street cultist/touts so that confra go civilise. Y'all should do what you can to make life a better place for someone at least one person before you die

cheesy cheesy cheesy I swear everyone is now a Jew.
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Deffjam: 4:48pm On Jan 30, 2021
Sennex57:

cheesy cheesy cheesy I swear everyone is now a Jew.
lol.....i tell you.

1 Like

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Sennex57: 5:37pm On Jan 30, 2021
Omahlaycha:
Dem don dey surface small small. If we preach say no to cultism fm now til dem blow final trumpet, confra go stil count scores, na constant k 4 dia constitution. Even dem sef no want peace cos dem dey count scores during peace talk. D koko of d matter b say na d death wen dey follow cultists upandan dey mk pple avoid joining if not pple 4 think say na just flexing involve as celebrity members dey paint am, cos frat&sorority dey abroad, no comparison wt naija own sha, but mk u go join cm begin count scores&see as dia law go rubbish u. We just dey advice doz wen stil b ju to keep flexing dia ju life&flee fm cultism, nothing go concern u wt hit&also doz wen dey game but stil get conscience to change, bt doz wen feel say ruggedity na dia identity&carry cult 4 head, mk dia careless death b more than enough reason to say no to cultism as na d reason we dey always update d tread wt hit&livescores, so anybody wey e dey pain, mk him go use himself count scores, na good riddance&natural selection as person don alrdy talk am 4 wetin I quote down

Hope u no b kk, d person sabi himself

I was thinking that myself

2 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Sennex57: 5:54pm On Jan 30, 2021
freshkpomo:
Those of you saying you are Jew and so the war should continue cos it does not affect you. Let me tell you this, each full blown cult war usually claim at least one Jew. In Benin currently, Jew when Don die go Don reach 10 if not more than.. That's the one I have heard o, what of the one never hear..

One borrow him friend car who was already mapped, as the guy drop say make him open gate, them give am for back, na right there my guy die. As them be way confirm am na him them notice say na wrong person.

Another one mistake flat description go kill wrong person, another go the guy room kill him babe and babe sister, another kill him brother, another kill him guy when dey wait for am for room.

The one when happen for Oguola along siluko area, as the guys drop begin chase their targets, people begin run, One guy still sit down saw after all him na Jew, na there one of the 6 guys from back slash him head open, towards him neck, another shoot the guy to make sure say him die finish, na the guy when dey back come observe am dey shout nor be him be this, but last last who Don go Don go.

Eiye also beheaded a Jew some time ago around textile mill area.

Around egor area, another Jew had his head split open while returning home with his friend at night, people woke up to see his dead body. Stray bullets have hit some Jew in upper area.

Also heard some of the killers arrested have pointed some police men to be part of their squad.

I can tell you countless times where Cultist will Kill Jews and say they are rivals because they’re too afraid to actual get revenge.
Cultist are bullies they bullies Jews because they don’t belong to other cults. A bully will never pick on someone his own size.

I’ve seen bird claw a Hs in a bar whilst knowing he’s a Hs then say “Habakrier How far who goes” the Hs will be shocked and confused and the bird will say “How far HBK this man you clawed me, me I clawed you back this guy how far Identify yourself ” the HS will then offer money or buy drinks to not anger the guy. To be honest I used to burst out laughing when I saw this but then I realised this is bullying.

This links to the Story of the OP (say no to cultism) said how he was in a bar Vikings wanted to start something and his friends shouted Aye Axemen and the Vikings walked out.
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Sennex57: 6:03pm On Jan 30, 2021
As a cultist I don’t care HOW RUGGED YOU ARE.
I DON’T WHAT YOU HAVE DONE OR HOW MANY PEOPLE RESPECT YOU. The worst fear is being in a place maybe at an event or club or bar and your with you friends or family and not your men. Then you hear your rival cult shout maybe “AYE AXEMEN” or “AROO MATE” as you turn you see them like 20-40 men deep flying there colour then you become shocked. Like Bleep maybe one of them in that crowd was one rival I used to rob or maybe I killed his friend or maybe I used to bully him and he’s finally joined one cult now wants revenge. Then you are thinking will they recognise me and the people your with, are looking at you like “what’s wrong” now you have to play it off but your shaking in your boots. And if one recognise you then....I’m guessing you know what happens next grin

22 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Sennex57: 6:11pm On Jan 30, 2021
I would say a lack of love at home is why I joined a cult it’s was like I wanted to fit into to some but I didn’t know what but I like I wanted to feel like I fitted in or something it’s a weird feeling to explain. It’s like how a rich man has everything he wants but yet he still has nothing.

Why Eiye you might ask? I wanted to belong to ANY Cult it came a time I didn’t care it was literally which ever one accepts me I’ll be loyal to that one. I saw my BAN friend he said no that’s he doesn’t want that mental baggage I was like ha.

I asked my Axemen friend bam me he said No he’s scared I’ll die in the initiation.

I Asked my Aromate Friend he said I have to pay. I was like whhaaaaat nah I’m good.

Then I went to my Eiye friend and he said okay.
But I swear to God i don’t know if it’s a common thing for all cults but when I was hatched into Eiye i thought the whole world was against me I later found out that Davido and a lot of celebrities were Aye I didn’t regret join but knowing I was part of Eiye which was their rival I became paranoid like died.

I only let like 3 HS know I was a bird and they were shocked asf like a boy like you. If you saw me you’ll never guess. I was clean and tidy but when I used to hang with some street birds some shopkeepers who knew me would stop me and ask why am I hanging around with such hoodlums that’s they are nothing but trouble. (I’m not trying to praise myself o) I would just nod my head and just think to myself “if only you knew”

Never use to flex for girls because I always used to think “why would I kill someone over this girl just for her to sleep with someone else as I am in prison”

Never used to go clubs that often funniest thing is was in my dorm I was in a room with 2 bunk beds and one of my room was an Axemen one was Aro and one was a Maphite and they didn’t know I was a bird. We all made a peace treaty that even their cults clashed our room was a safe haven for all of us. It wasn’t until I left I later told them I was a bird they didn’t believe me at allll I had to prove it too them and showed them pictures of when I used to go celebrate June 15th.

20 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by The5DME(m): 6:32pm On Jan 30, 2021
[s]

[/s] sssshhhhhhuuuu.

5 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by freshkpomo(m): 7:16pm On Jan 30, 2021
ReligionofPiss:
exactly, Jews are mostly affected too.
E get one video here wey eiye dey go on Killings, as them miss their target them Carry that vex go meet jew man for ugbioku upper ekenwan na so Dem descend on am.
Even shops and businesses owned by jews go closed for safety
Shey them tag that area pissful based on say him near barrack and na the new headquarters of yahoo boys and unto that One everybody na hustler, no time for confra there. This your revelation shock me o, though Agbero(boys when their head nor dey house) plenty for there sha.

4 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by freshkpomo(m): 7:37pm On Jan 30, 2021
Omahlaycha:
All ds ones una two above me just yarn dey somehow for ear, we dey say no to cultism, say e better to b ju cos freedom of mind go dey because nothing concern ju wt hit as nothing concern okada wt seatbelt, bt una dey talk say even ju go dey affected so mk we condemn being a ju&kuku join d confra ni? Op&many others don talk say as we dey say no to cultism, mk we stil avoid dia frndship e get why. Bt wetin una two just type fnsh laidis show d consequences of befriending cultists wen b say u b ju instead of avoiding wahala mk wahala sef 4 avoid u. Mk we dey use our head4dz tread o cos sm pple dey bkground dey reason how to reverse d purpose of d tread wt style. @Greenarrow1 don talk am fnsh for him last post

You misinterpreted the whole write-up. The write-up was for those praying for cult war to come so cultist can kill themselves cos they are Jew an feel it won't affect them.

A family member called and told me they woke up to meet a dead guy close to them. Guess what? The guy was a Jew returning late with a friend, the cultist were very angry they did not get their target, they Obtained these two guys and still inflicted life threatening wound on one of them that later took his life just to send a message to their target that they came around.

What about the one they destroyed his house (rented) shot at all the window because the guy already escaped, nor be only the guy flat them attack o, all the flat hear am, the luck him wife get say them nor know her in person cos na she them even ask about the man,wife and kid.

The better this cultism stuffs end the better for everyone. Can you still walk freely in some part of Benin? Try am, na Eiye rolling squad mixed with baby bird go collect all your valuables, look for something to tag you Ayes, devil go come punish you say black and yellow dey your clothes of handband, them go so beat you ehn, them fit just kill you just update say them Don kill one Aye. Them kill one guy like that use knife carve BOLD 7 for him chest.

For Uselu robbery for one street na based on register, them dey mark register for who them Don rub.. Na rolling squad dey do am so o, pos shops Don hear am and many of these people dey trade with loans.

The war nor dey Favour anybody so let's not get excited about it.

16 Likes 1 Share

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by freshkpomo(m): 7:53pm On Jan 30, 2021
Police hand nor pure for this Benin matter o, them still dey vex for the emdsars protest. Imagine police dey threaten to kill all vigilante for one area lol.

Let me quickly drop this for my Benin folk. My younger brother's wife just delivered a baby girl some days ago, guess what was the reaction of those at the hospital!" thank God say na girl o, if na boy them for just fly am out of the country or from Benin cos na God dey save Male children for Benin o, them go either be thief or cultist."

The labour pain of so many women there made me realise that the best way to show how ungrateful you are to your mom is by becoming a cultist.

24 Likes 2 Shares

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Oyinbopepper: 9:03pm On Jan 30, 2021
My ex girlfriend broda joined eiye unwillingly and was forced to join according to him,dem beat am and after that day,he has been avoiding dem left and right.
The sad part is anywhere dem see am na to cause trouble or obtaining,and dem don cast the boy to all his family and even friends of other fraternity say d boy na their member.

Now he is contemplating joining other cult frat or just give in and roll with the eiye frat.he is planning to cross carpet. Na wa for cult matter.

2 Likes 1 Share

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Deffjam: 9:59pm On Jan 30, 2021
Oyinbopepper:
My ex girlfriend broda joined eiye unwillingly and was forced to join according to him,dem beat am and after that day,he has been avoiding dem left and right.
The sad part is anywhere dem see am na to cause trouble or obtaining,and dem don cast the boy to all his family and even friends of other fraternity say d boy na their member.

Now he is contemplating joining other cult frat or just give in and roll with the eiye frat.he is planning to cross carpet. Na wa for cult matter.
just tell am make him change location.....cross carpet no be am.

3 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by dontknownutn11: 5:02am On Jan 31, 2021
https://www.nairaland.com/6391504/cultists-arrested-threatening-kill-man

These are all eiye cultists in my hood.. The one on the left, cuffed alone, Emma. Always wanted to be an Axeman..but ayes ddnt want to bam him cos he is too troublesome and a ticking bomb. He went to join Eiye. Smoking and taking drugs all day thats all they do. That one in d middle, His father is the Baale of the area. ALAGBOLE BEFORE AKUTE. Omo baale na bird.
The one in d tshirt na bros o..close to 40. Na agbero and bird together. I know them all very well and they all know me too. Been staying there since 1994. Stay away from cultism

17 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ProfAmaben(m): 8:12am On Jan 31, 2021
In case anyone wondered what Flying Ibakas looked like, here's one. At the end of the day, they are mere touts and urchins capable of perpetrating evil. This is the flying Ibaka Aruba nest, 2018.

Stay away from cultists (even your blood brother), they only bring destruction and evil wherever they go.

Read your books, learn a trade, marry and have kids but run from cultism. Anything that's easy to join is always meaningless at the end of the day.

Armed robbers ======= All cult members.

19 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by annayawchee: 8:45am On Jan 31, 2021
Deffjam:
what if i was back then, all the evidence pointed out i am.....did u know if i'm only d9ing due to fear? Lets just forget about it. Thanks anyway. For the record.

where did i impersonate aye?...show me
You are back to your old self abi...

Back to jumping on every comment abi...

Use your head , na the second time I dey tell you be this

3 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by daddytime(m): 8:46am On Jan 31, 2021
Another wasted sperm....I feel sorry for his parents and loved ones.

https://www.nairaland.com/6391686/boy-butchered-death-delta-state

4 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Sally4jfson3: 9:43am On Jan 31, 2021
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by 007sledge: 12:25pm On Jan 31, 2021
The street wing of eiye in my area (blue berry) always call themselves aro, I thought it s Vikings that uses that word
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by foxman04: 12:36pm On Jan 31, 2021
ReligionofPiss:
exactly, Jews are mostly affected too.
E get one video here wey eiye dey go on Killings, as them miss their target them Carry that vex go meet jew man for ugbioku upper ekenwan na so Dem descend on am.
Even shops and businesses owned by jews go closed for safety
no be lie bro.. e get one wey happen for my area 5yrs ago. aiye men come find one eiye guy for him house but them no meet the guy for house around 8pm, meanwhile there is a shop not too far from their target house whr guys do relax and charge phone too .. I dey do my dj stuff on d shop owner laptop when I see double barrel wey dey point to my direction, d next wey I see na axe wey dem use break the big bulp wey dey up, na so dem corner us o. luckily I was able to hide my fone cus I was d first to see dem tho dem steal my small Nokia fone wey I dey charge for outside. we reach like 8guys for the shop dat nyt(8jew guys) dem thief d phones and laptop wey people dey charge, unfortunately for d shop owner, na that day e go market go buy stuff for him shop dem empty every whr.

wetin pain me pass, aside d gun and axes dem still take mess attack us, d kind mess wey fit suffocate a full grown elephant. na so so hbk dem dey shout followed with heavy mess. axemen wey dey shout hbk, all of em use face mask. when they were leaving Dem carry padlock lock everybody for inside

12 Likes 1 Share

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Nobody: 1:49pm On Jan 31, 2021
Me I am a Jesus member. I love Jesus and I propagate His gospel. I have stopped wearing red or yellow cloths, since guy(s) became confused about me being a bagger or maybe NBM. I really entered serious problems even as a Jew man. I entered one of the most terrible issues of my life that I had to go and physically negotiate/make peace to prevent a hit against me. I was a Jew man that some guys probably thought to be a top or deadly guy in a cult. I..But no, I wasn't a cultist at all and have never been one . I have good love, and I pray all guys follow Jesus Christ.

Please mind what you wear, and don't be tough ooh!! It could send wrong signals to people and breed battles that will choke you to stupor... Mind your business, be gentle, you don't need to be tough.

I have learnt to be calm. Jesus Christ is calm. In the past, I was tough, daring and sometimes fearless. But Jesus wants me to be quiet, kind, loving, forgiving, easy-going and nice..

God loves you, He loves cultists, and He wants them to repent and accept Jesus Christ as Saviour. He wants cultist to repent and live long

10 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Nostradamus: 3:17pm On Jan 31, 2021
www.nairaland.com/6391504/gang-members-arrested-threatening-kill

if the guy who made the report that led to the arrest of this three guys here(the guy that was threatened in order to forcefully iniatiate him)had first asked for advice here,some members here would have asked him to start doling out his hard-earned money and drinks on the cultists just to be on their good book.kudos to the young man for not coming here to seek for advice and heading straight to the security agents

15 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by Koralords: 5:44pm On Jan 31, 2021
Nostradamus:
www.nairaland.com/6391504/gang-members-arrested-threatening-kill

if the guy who made the report that led to the arrest of this three guys here(the guy that was threatened in order to forcefully iniatiate him)had first asked for advice here,some members here would have asked him to start doling out his hard-earned money and drinks on the cultists just to be on their good book.kudos to the young man for not coming here to seek for advice and heading straight to the security agents
Was about the give same advice before I saw your write up,imagine someone was already saying the guy that was said to be forcefully initiated to relocate.
So he will leave his work or sch cos some useless cultist Dey threathen am,most of this cultist thrive on fear if them nab them na there you go know say them no be anything example was one very gentle boy that was bammed aiye not upto 6 months ago e no let people here word again,one of his friend that’s a Jew he always like to ride that one one day we where together wanted to ride that one I ginger am make He no gree that one beat am like small pikin go call men come then bring gun and axes told that one to run away,the guy called him brother that had connections order came from eleweran state command make them go carry the guy,he reach police station begin cry like baby I come Dey Laff say see strong man wey Dey cry,na we come latter beg make them free and die the case now him don come gentle,so to that guys that’s been threaten go to the state command and make a report make them carry all of them nothing go do you

6 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by hustla(m): 10:43pm On Jan 31, 2021
Koralords:

Was about the give same advice before I saw your write up,imagine someone was already saying the guy that was said to be forcefully initiated to relocate.
So he will leave his work or sch cos some useless cultist Dey threathen am,most of this cultist thrive on fear if them nab them na there you go know say them no be anything example was one very gentle boy that was bammed aiye not upto 6 months ago e no let people here word again,one of his friend that’s a Jew he always like to ride that one one day we where together wanted to ride that one I ginger am make He no gree that one beat am like small pikin go call men come then bring gun and axes told that one to run away,the guy called him brother that had connections order came from eleweran state command make them go carry the guy,he reach police station begin cry like baby I come Dey Laff say see strong man wey Dey cry,na we come latter beg make them free and die the case now him don come gentle,so to that guys that’s been threaten go to the state command and make a report make them carry all of them nothing go do you

Eleweran for Abeokuta

If you wan lose weight, just go Eleweran for 2 weeks.them no dey tell blind man say rain deh fall

cheesy
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by azeeza(f): 8:45am On Feb 01, 2021
election2023:
Me I am a Jesus member. I love Jesus and I propagate His gospel. I have stopped wearing red or yellow cloths, since guy(s) became confused about me being a bagger or maybe NBM. I really entered serious problems even as a Jew man. I entered one of the most terrible issues of my life that I had to go and physically negotiate/make peace to prevent a hit against me. I was a Jew man that some guys probably thought to be a top or deadly guy in a cult. I..But no, I wasn't a cultist at all and have never been one . I have good love, and I pray all guys follow Jesus Christ.

Please mind what you wear, and don't be tough ooh!! It could send wrong signals to people and breed battles that will choke you to stupor... Mind your business, be gentle, you don't need to be tough.

I have learnt to be calm. Jesus Christ is calm. In the past, I was tough, daring and sometimes fearless. But Jesus wants me to be quiet, kind, loving, forgiving, easy-going and nice..

God loves you, He loves cultists, and He wants them to repent and accept Jesus Christ as Saviour. He wants cultist to repent and live long

praise Jesus halleluyah! you have received sense�

2 Likes

Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by retake89(m): 8:34am On Feb 02, 2021
.
Re: My Story As A Cult Member........initiation Phase Included... by ashawoKGB: 11:33am On Feb 02, 2021
Nostradamus:
www.nairaland.com/6391504/gang-members-arrested-threatening-kill

if the guy who made the report that led to the arrest of this three guys here(the guy that was threatened in order to forcefully iniatiate him)had first asked for advice here,some members here would have asked him to start doling out his hard-earned money and drinks on the cultists just to be on their good book.kudos to the young man for not coming here to seek for advice and heading straight to the security agents
The name of the guy who arrested them was released . The naija police will release this fools and they will later destroy that guy. Reporting to police is the worst thing ever

6 Likes

(1) (2) (3) ... (482) (483) (484) (485) (486) (487) (488) ... (649) (Reply)

Viewing this topic: 3 guest(s)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 109
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.