Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,206,847 members, 7,996,993 topics. Date: Thursday, 07 November 2024 at 07:47 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Dating And Meet-up Zone / Friendship Needed (3629 Views)
I Need Impactful Guys For Friendship! / friendship / I Need Beautiful Girl to be in Friendship With (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)
Re: Friendship Needed by adesodgi(m): 12:32pm On Oct 22, 2005 |
grinny K2 |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 6:52pm On Oct 25, 2005 |
what's up scorpio? i dey for Manitoba(peg city) and the cold here no be beans! |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 10:23pm On Oct 25, 2005 |
doh! na so i hear about Manitoba, my uncle just moved there and i don't think i'll be going to vist him anytime soon I hear say na so so dem indians full there too, take am easy k. when dem don pay me, i go come move you to toronto k |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 12:25am On Oct 26, 2005 |
u're so funny scorpio! i for no mind come live for toronto sef! i no blame u as u dey avoid this place, cold wan kill pesin but no shaking sha and as 2-face talk, nothing dey happen! |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 1:34am On Oct 26, 2005 |
dat's word. hold it down 9ja style k mayb next summer i go reach ya side |
Re: Friendship Needed by adesodgi(m): 2:32pm On Oct 26, 2005 |
who knows? |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 3:15pm On Oct 26, 2005 |
huh? |
Re: Friendship Needed by adesodgi(m): 3:35pm On Oct 26, 2005 |
i said who knows,is ther a crime in that,why de hun?then? |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 3:49pm On Oct 26, 2005 |
just wanted to be clear on who n what u were sayin, no qualms. |
Re: Friendship Needed by hotangel2(f): 3:57pm On Oct 26, 2005 |
*quietly passes by* |
Re: Friendship Needed by adesodgi(m): 3:58pm On Oct 26, 2005 |
caught you.....^ |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 3:59pm On Oct 26, 2005 |
yea, u did |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 5:50pm On Oct 26, 2005 |
Scorpio:Word! that should be fun. At least i fit boast of our summer here, na real 9ja weather we dey get, for real! |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 6:47pm On Oct 26, 2005 |
fo'real i like summer no be small o, infact you go see me next year this year's weather wasn't that bad in d T.dot actually, it was one of the hottest, so i no vex |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 9:35pm On Oct 26, 2005 |
hey scorpio, i hear u! I follow u love summer. so how Toronto dey? na una get Canada, abi no be so? u know p-square? them be nigerian musicians like that, them tap oh! |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 10:07pm On Oct 26, 2005 |
yea, na we get Canada ke? we dey try o, just know say 9ja's are gettin their fair share here course i know p-square, their songs are really good, or wait, dem dey here( searches for p-square), abeg yarn me o, no let me lost like that |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 10:11pm On Oct 26, 2005 |
them dey where? Canada?i no understamd your question |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 10:11pm On Oct 26, 2005 |
i b think say u say dem dey hia, i b just dey find them now |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 10:13pm On Oct 26, 2005 |
u crack me up scorpio! if to say them dey here sef, i for don find them tee tee! i no dey take those boys joke abeg! |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 10:15pm On Oct 26, 2005 |
like i no dey take faze play no worry, when dem show we go kidnap them. then we can be their managers, friends, |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 10:19pm On Oct 26, 2005 |
who b faze? anyway, i gree oh! if them dare step here, na trouble be that! na we get them be that! u don see their new videos? my best na bizzy body, i tell u, if i catch em, them must to soji and lose control! |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 10:30pm On Oct 26, 2005 |
Gurl, u're killin me o. if you no know faze eh, you need to contact me make i nack u tori. faze was in d plantashun group along with dem tuface na, d guy's good, his voice is really noice. my fav is Na True. don't mind p-square, make dem show first |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 10:34pm On Oct 26, 2005 |
oh! i been tink say faze be 2-face. abeg nack me! who u say im be again? |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 10:38pm On Oct 26, 2005 |
na Faze i dey talk of o, gurl, kai manitoba no good o k back to da topic. Faze was in the plantashun group with dem tuface n blackface, he isn't da cutest in d group though, but he's voice is beautiful chai girlfriend, u need to meet me o make i fill you in |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 10:47pm On Oct 26, 2005 |
i hear u! na watin manitoba dey do pesin o. Hmm, i no too know all them plantaion boyz sef, na only 2-face i know, again, make u blame manitoba! but im voice fine pass 2-face own?at leat, i know say na 2-face fine pass d rest of them boys abi u no gree? |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 10:57pm On Oct 26, 2005 |
compared to tuface, i go say im voice is unique. tuface has his own style n so does Faze. but i like Faze better, no doubt tuface is cute(wat wif his head ) |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 11:01pm On Oct 26, 2005 |
na im be say i go go find faze be that . watin do my 2face head? im head make am fine more sef! |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 11:02pm On Oct 26, 2005 |
scorpio girl, i go dey bounce now jare! i don laugh tire. we go everly still jam! |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 11:07pm On Oct 26, 2005 |
fo'sho girl, make i go find ya e-mail add sef before dem kick us comot for here o take am easy k |
Re: Friendship Needed by hotangel2(f): 1:04am On Oct 27, 2005 |
Una try! |
Re: Friendship Needed by Scorpio(f): 3:48am On Oct 27, 2005 |
Re: Friendship Needed by ocho(f): 11:35pm On Oct 27, 2005 |
scorpio, oh girl where u dey today na?i see say u no dey on line as i dey. Any how, e go be! |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)
I Need A Boyfriend, Love Me / 77 Things You Need To Know Before Marriage / My Long Awaited Picture
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19 |