Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,176,855 members, 7,899,029 topics. Date: Wednesday, 24 July 2024 at 04:14 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / Write the Bible In Pigin English! (13497 Views)
Summerise The Bible In One Sentence / Why Did God Need To Write The 10 Commandments / Did God Really Write The Bible? (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)
Re: Write the Bible In Pigin English! by 9jaguy7(m): 1:24pm On Dec 04, 2012 |
John 11.35 baba God cry well well. 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by BSF: 1:26pm On Dec 04, 2012 |
Jesus Say, SureBanker, Sure Banker If I tell this mountain make him commot for road, and enter inside water, and I no doubt am, but come believe sey, wetin I tell the mountain must happen, I go get wetin I use my mouth talk(Mark 11:23) 4 Likes |
Re: Write the Bible In Pigin English! by donfemzy: 1:59pm On Dec 04, 2012 |
e-mail:tell us urs |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Nobody: 2:02pm On Dec 04, 2012 |
Romans 8:1 As e be so, long tori no dey for we wey dey Jesus |
Re: Write the Bible In Pigin English! by ijawkid(m): 2:05pm On Dec 04, 2012 |
advocate666: The bible is such a joke. I get one scripture for YOU.....oya read am... ____________________________ Proverbs 14:6..:::: Person wey dey find trouble or wey dey curse with him mouth go always find way to know something but na "OLODO" him go remain as........but for person wey get "SENSE" to know something no dey hard......... ____________________________ For you to abuse the bible you be OLODO.......lol 4 Likes |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Nobody: 2:05pm On Dec 04, 2012 |
Na me be the way, the true tue and life, no bodi dey reach papa side except thru me. 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 2:07pm On Dec 04, 2012 |
As this we world come get one language, and everybody come dey talk the same thing and dey hear the same thing. He come waka pass, as dem dey waka come from east area, dem come see flat ground way dey Shinar area; dey come tanda for there. Them come look theirself talk say, come o! Make we go, make we make brick, cook am wella. And so dem get brick for stone, and slime for morter. Them come talk say, Waka go, make we build for ourself one kind mega city, a tower, way d up go touch d sky come touch heaven; so make we carve name give ourself, before we scatter yakata for this big world. Papa God quick quick, run come down come open mouth look to see the big tower, way man pikin come nack for ground. God come talk say, Look o, chei, true true, this people na one o, na one tongue dem get: so nothing way dem wan do go hold dem, since dem get big mind o. Oya waka, now, make we go down, confuse dem language, make dem no know watin another man go talk. So Papa God come scatter scatter dem all over we world and land, so dem quick, quick, pick race commot for that mega city way dem wan build. Genesis 11:1-8 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by wengerjay(m): 2:15pm On Dec 04, 2012 |
E get one particular young chic,wey no get breasts.Wetin we go do for am on hin wedding day.Song of Solomon 8:8. 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by kemoolala: 2:16pm On Dec 04, 2012 |
cor.4:7 For who makes you differ from another? And what do you have that you did not receive? Now if you did indeed receive it, why do you boast as if you had not received it? pidgin version says: for una make u differ to una mate? wetin u get wey u no collect? if na true true u collect am why una dey do as if say una no collect am. ; |
Re: Write the Bible In Pigin English! by advocate666: 2:19pm On Dec 04, 2012 |
wengerjay: E get one particular young chic,wey no get breasts.Wetin we go do for am on hin wedding day.Song of Solomon 8:8. |
Re: Write the Bible In Pigin English! by meetmeonline: 2:21pm On Dec 04, 2012 |
. [size=14pt]If you be sleep-sleep hungry go kill you...bross! shine your eye make you for see beta food chop[/size] Proverbs 20:13 . 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 2:21pm On Dec 04, 2012 |
don_femzy: tell us ursYou have not been following. Start reading from the very beginning. Thank you. |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Ndoz(m): 2:22pm On Dec 04, 2012 |
ITbomb: Ecclesiastes 4:11 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Eneze1(f): 2:23pm On Dec 04, 2012 |
advocate666: The bible is such a joke. must u comment, if u don't have something sensible to say y don't u keep quiet. |
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 2:23pm On Dec 04, 2012 |
meetmeonline: .Correct! |
Re: Write the Bible In Pigin English! by paris10: 2:23pm On Dec 04, 2012 |
If una allow Jesus be una friend, all the ashawo, ogogoro, lies, agbere, barawo, baba ijebu, looting and the rest of the sin wey una don do for una life go disappear, una life go come new like new pammy wey dey inside bottle. (2 Corinthians 5:17) 4 Likes |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Nobody: 2:29pm On Dec 04, 2012 |
anything wey u want make people do to u, na dat same thing u suppose dey do to people too. this one na d law and d prophets. |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Enoquin(f): 2:30pm On Dec 04, 2012 |
I love this! I am so bookmarking this thread... Wetin we go come talk, say Baba God no dey righteous? God forbid! Im don kukuma tell Moses say im no carry vex vex for some pipu, say im go pity pesin where im wan pity So no be pesin wey too show or pesin wey too waka but the one wey God go pity open way for am Rom 9:14-16 Let me try on two of my favourite passages Na so the spiritman dey help us for the thing wey dey pain us pass, as we no come know how we go take talk to Baba God, this spiritman come help us talk to Baba God for their language, the kain language wey na only dem two understand Im wey dey shook eye for our heart come know wetin the spiritman dey follow am talk and all na because im dey talk for people wey dey do wetin Baba God want Romans 8:26 -27 This kain pesin no dey see, im no even fit see far self, im don kukuma forget as dem take comot am from all the yama yama wey im dey do 2 Peter 1:9 2 Likes |
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 2:32pm On Dec 04, 2012 |
mawojuuche: anything wey u want make people do to u, na dat same thing u suppose dey do to people too. this one na d law and d prophets.Thanks for contributing. No Bible passage though. |
Re: Write the Bible In Pigin English! by email1(m): 2:36pm On Dec 04, 2012 |
Enoquin: I love this! I am so bookmarking this thread...Thanks alot for loving this thread. You too try. Ur own make sense. |
Re: Write the Bible In Pigin English! by advocate666: 2:49pm On Dec 04, 2012 |
Eneze1: like you just did. |
Re: Write the Bible In Pigin English! by bunlizlaw(f): 2:52pm On Dec 04, 2012 |
Baba Lord bi my light and salvation.Na who I wan fear?Psalm 27:1 2 Likes |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Jazzgreen(m): 2:57pm On Dec 04, 2012 |
Genesis4: 9.BABA GOD come ask dat bad guy cain say:were ur junior bros de? Den cain come turn look baba God for eye tell am korokoro say:leave me Joor,i no knw:i be my junior bros goal keeper? I be man u fan, he be barca,how i go come de keep ball for him.abi na u transfer me to dat side dis summer season? 10.den baba God come suprise how cain de question am.he come ask am:wetin u jst do? Ur bros blood de cry "IYAA MI ooo" for ground.and d tin don reach my ear. 11.2day, 2day, i don put curse for ur head,for dis land wey don open mouth de enjoy ur bros blood lik red wine from u. 12.if u put cassava for ground, e no go giv u plenti garri lik em de do b4:na Agbero,419 and BOKO HARAM u go be for dis land 13.den CAIN open mouth look baba God tell am:CHEEEE,baba God why na,d kind torturization wey u jst giv me don pass d tin we i do 2 Likes |
Re: Write the Bible In Pigin English! by carzola(m): 2:58pm On Dec 04, 2012 |
God talk say make we enter d world make we no cari last make we fu*k well well cum plenty 4d world. |
Re: Write the Bible In Pigin English! by 1shortblackboy: 3:10pm On Dec 04, 2012 |
advocate666: The bible is such a joke.. Park well jor nobody get ur time 1 Like
|
Re: Write the Bible In Pigin English! by greatdave(m): 3:11pm On Dec 04, 2012 |
Bros J yan give am say;na me be d correct road,d confam örijo,and beta life...no man fit tochlite my papa if he nor use my network. John 14:6 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by vivaciousvivi(f): 3:18pm On Dec 04, 2012 |
I fit do efri efri things as long as Jesus dey continue to pack power gif me! 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Goshen360(m): 3:23pm On Dec 04, 2012 |
Loving this thread. Bookmaked! |
Re: Write the Bible In Pigin English! by greatdave(m): 3:31pm On Dec 04, 2012 |
E dey possible make woman 4get her smal pikin wey dey suck böbbi, make she nor pity am? I dey tel you say she fit 4get,but me nor go 4get u lai-lai. See, I don draw ur pishur for my hand;I dey reason ur side evrytime. Isaiah 49:15-16 2 Likes |
Re: Write the Bible In Pigin English! by wengerjay(m): 3:34pm On Dec 04, 2012 |
Abeg,find me bible,ppl don dey quote heresy for here o. 1 Like |
Re: Write the Bible In Pigin English! by Eneze1(f): 3:39pm On Dec 04, 2012 |
advocate666: cant be exchanging words with you |
Re: Write the Bible In Pigin English! by wengerjay(m): 3:42pm On Dec 04, 2012 |
Jesus cry so tey!John 11:35. |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)
Should I, As A Christian Pay Tithe? / The Many Mistakes Of Apostle Paul's Teachings: Mistake No. 7 Correction / What Packaging By Pastor Adeboye
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 36 |