Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,189,394 members, 7,937,197 topics. Date: Sunday, 01 September 2024 at 04:50 PM

We No Fit Catch Barca-mourinho - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / We No Fit Catch Barca-mourinho (523 Views)

See How Fans Showed Support For Juventus And Barca ( Photo) / #UCLfinal: 5 Reasons Why Juve Will Shock Barca Tomorrow! / Naija No Know Pass Ball And The Ball Sef Una No Fit Play Am (2) (3) (4)

(1) (Reply)

We No Fit Catch Barca-mourinho by Livermeka: 11:32am On Dec 17, 2012
Jose Mourinho no bilif say Madrid fit catch Barcelona again, to come retain dem tiltle afta dem bin draw 2-2 wit Espanyol for house for Sunday match.

Barca wey dey unbitin, hammer Atletico Madrid wey be secon for table 4-1, Messi score two inside d goal for d match for Nou Camp come carry 13 point gap Real wey dey numba 3 for table.

" Lai lai, e no fit happen," Mourinho tell one news confirence " D gap plenti no be small for dis stage wey we dey, last year we gif Barca 10 point for februari time come hold am like dat take win d Lig.

" But as e be so if we go fit omprof for Lig, e go helep us for King's Cup and Champion Lig sef.

Real dey struggle to show d kain form wey dey show lass year wey dem scatta rekod yakata, and dem drop 15 point sef wit d 3 draw n d 3 difit wey dem get wey pass all of last seasin own.

Barca sef don win all dem Lig game dis year minus d one wey dem draw 2-2 wit Real for October time.

As Madrid bin lose 2-1 for Celta Vigo hand for King Cup , pipul come dey talk say Mourinho sef fit waka befor im kontrak go finish for 2016 time.

" E don tey wey i dey dis kain position, i no juss undastand, d kain points wey we dey drop no good at all, we suppose go bak, think am well well, come do beta tin for field, we no fit dey continu like dis" Mourinho talk.

Barca sef no send d win wey dem win dem rival Atletico becos dem bilif say as seasin dey go, Atletico and Madrid go dey gif dem close marking dey shadow dem.

Midufilda Sergio Busquets talk say say " Na good advantage but Lig still dey far, match plenti, nobodi bin tink say we go dey where we dey, but we go dey continu to dey do wetin we dey do."

Atletico coach Diego Simeone no gree wit wetin Busquets talk sef " Barca no be we mate, na different level dem dey, dem ball pass be careful, " Simeone bin yarn ,after Barca cari 9 point gap dem for numba 2 position.

" We bin try to play too, we play d way wey good for us, we try sef for d game, but wit d kain ogbonge attak wey dem get, e no fit happen, dem too much.

" Messi na d best player for dis world. Me just hapi say me and im come from Argentina.











http://www.supersport.com/football/nigeria-naija/news/121217/We_no_fit_catch_BarcaMourinho
Re: We No Fit Catch Barca-mourinho by Nobody: 12:57pm On Dec 17, 2012
My best sports read of the year. @ Poster, Three great Gbosaas! grin grin grin

(1) (Reply)

Uefa Champions League Draws-ronaldo Returns To Old Trafford / The Best Xmas Gift Ever / 2012 Arsenal Moments!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.