Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,171,116 members, 7,880,461 topics. Date: Thursday, 04 July 2024 at 06:47 PM

To Say My Papa Na Politician - Poems For Review - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Poems For Review / To Say My Papa Na Politician (616 Views)

To Say My Papa Na Politician / Na Mercy Cause Am O / Time To Say Goodbye. . . (2) (3) (4)

(1) (Reply)

To Say My Papa Na Politician by lyricalpontiff(m): 5:19pm On Jun 17, 2013
To say my papa na politician

E for show for my flesh,spirit and soul
Now even coal tar sef dey cry out 4 my sole
*mtcheew* I know why I sighed
I for no grow up for waterside

To say my papa na politician

We for get three swimming pools 4 compound
All my wahala for nede compound
I no for trek from Rumuokoro reach Aggrey
When I toast all these girls,dem 4 dey agree

To say my papa na politician

U know how e for be
I for dey make buzz, wetin be bee?
I for be better obedient son
I for hot dey shine like Sun

If my dad were to be a politician

My academics will sit on the hiltop not dale
Aladumo,Bereton,Brookstone,Charlesdale
I no for dey RUST inside UST
All the scholarship for dey my fingertip

To say my papa na politician

NA only pepper for rest,I no for rest
I for... Forget the rest
Now with deep teary voice, I balw
Restlessly moving from side to side like eyeball

To say my papa na minister or commissioner
Of Power and Steel
E for give am power to steal
Naira,Dollars,Euros,Pounds,Franc
Still pose front of tv like he is frank

To say my papa na politician

dem for just dey suspend,dey suspend
All this power tussle,I no know when e 4 end
If only say my papa na Ameachi
I for no dey scrub avu etichi

As my papa no come be politicain
Thank God say him no dey with the mortician
I just wish he was in dat alluring den of rogues
I wish politics was no in vogue

To say my papa na politician...

Re: To Say My Papa Na Politician by lyricalpontiff(m): 5:23pm On Jun 17, 2013
Front page plsssssss

(1) (Reply)

The Ism / Drunken In Love / Artless

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.