Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,193,658 members, 7,951,763 topics. Date: Tuesday, 17 September 2024 at 10:55 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) (835 Views)
Nigeria Vs Mali. African U23 Championship (3 - 2) On 29th November 2015 / Osaze Odemwingie Completes Move To Cardiff / Yobo Could Be At Cardiff City Next Season (2) (3) (4)
Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:04pm On Aug 25, 2013 |
Na cardiff doormort man city go meet dem so, d match just dey shelle now now make una follow me dey go |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:08pm On Aug 25, 2013 |
dis cardiff boys no wan gree o, dem nearly goal nw o e bi like sey d malaysia billionaire wey get d team don promise dem big big money o |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:16pm On Aug 25, 2013 |
i no no y way dis cardiff city fans dey booe booe man city o, but cardi boys too dey enter man city post |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by mascot87(m): 4:18pm On Aug 25, 2013 |
so na u come tanda gidigba for nairaland dey give us the tori of the gbege wey dey shele between Cardiff and mancity. Abeg dey give us the casala wey dey happen cos we dey file up tanda dey watch your tori as them dey take dribble yafunyafun for d field. |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:21pm On Aug 25, 2013 |
fine fine pass from man city nw nw |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:31pm On Aug 25, 2013 |
goal never come for any body o d two team dey play fine fine ball sha |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:35pm On Aug 25, 2013 |
cardiff city no allow man city to play their style of ball o e bi like say na borrow po ball man city con dey play |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:44pm On Aug 25, 2013 |
44 mint no goal yet |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:52pm On Aug 25, 2013 |
d first laff don pafuka all dis cardiff boys just dey scarter ball like sey na fufu dem chop come na God save me self, they shot for nack me for head |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:56pm On Aug 25, 2013 |
mascot87: so na u come tanda gidigba for nairaland dey give us the tori of the gbege wey dey shele between Cardiff and mancity. Abeg dey give us the casala wey dey happen cos we dey file up tanda dey watch your tori as them dey take dribble yafunyafun for d field.na cardi stadium i dey nw wit my kunu and akara, dey bring una all d echechere tori |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:03pm On Aug 25, 2013 |
d part 2 don start na make we see dis part go be |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:11pm On Aug 25, 2013 |
goaaaaaaaaaaal Dzeco don bulala thick and heavy shot enter cardi net o for 52mint |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:16pm On Aug 25, 2013 |
jesus don commot, na nasri con enter |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:20pm On Aug 25, 2013 |
yepaaaaaa, Gunarsson don goal for cardiff o for 60mint , dis one na bad market for man city o |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:27pm On Aug 25, 2013 |
Dzeco don cary blood for nose commot for Negredo to waka come in |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:34pm On Aug 25, 2013 |
man city wan quench here today o |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:37pm On Aug 25, 2013 |
campbell don goal again for cardiff o |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:42pm On Aug 25, 2013 |
na 5mint remain o, na who go help man city o |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:47pm On Aug 25, 2013 |
campbell don make am 3 for cardiff for 87mint o |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by mascot87(m): 5:47pm On Aug 25, 2013 |
My guy, u do well. I dey feel u wela for my domot |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:52pm On Aug 25, 2013 |
Aguiero just nod ball enter nw for city |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:58pm On Aug 25, 2013 |
i no fit believe my nose say cardiff city bulala man city 3 2 my people na cry i dey cry so d part 2 don pafuka |
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by osymerga(m): 7:52am On Aug 26, 2013 |
Cfrain c,so u still dey ? Make u kukuma come finish ur tori for Me and Asaba job oooo,b4 wat happen in 1960 will repeat itself oooo.Abi u wan try us ni |
(1) (Reply)
Test Post / Iheanacho, Alampasu For FIFA 2014 Ballon D'or Gala / Who Will Win The EPL Title
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12 |