Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,170,611 members, 7,878,771 topics. Date: Wednesday, 03 July 2024 at 06:23 AM

This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# - Jokes Etc (8) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# (9167 Views)

See What Happens When You Mistakenly Shout Sai Baba In A Fuel Queue(pic) / This Happens Only In Nigeria... / Hilarious Made In 9ja Keke (pics) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (5) (6) (7) (8) (9) (Reply) (Go Down)

Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 11:09pm On Nov 01, 2013
Tmonex: Make i jst Answa all of una, abeg wetin be d question??
u no cari ur eye c all d questns wey dey here?
U wan mah ask more questions?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 11:15pm On Nov 01, 2013
Jovanna: wetin be ur own 4 our mater sef? Ur broda no knw say i no sabi cuk b4 e cari me 4 huze? Abi u want mah kill dat huzegurl u wan bring?
y e no go concern am?
Wen u bin marry hin broda u no bin knw d matter go concern am??
U go fit fiqht dat house girl wey dey fiqht lyk tiger?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 11:16pm On Nov 01, 2013
Jovanna: since 1901 abi u don 4get?
hah! U bin born dat tym??
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by larride(m): 1:28am On Nov 02, 2013
Una still dey on top this mata?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 6:05am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
The dude fine reach as u don describe am so?

That na understatement sef, the boy head round and oily. Him like to barb Akpan/bololo/skin cut, everyday na him head I dey take dey check my face 4 hin head because in clear pass mirror. In no too tall but him tall pass usain bolt, hin chest broad pass una door, him get big yannsh. Him perfume na die ooo. . .wetin you wan hear again to make u understand say dis boy na BOOMBB? grin
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 6:10am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
na wetin u dey try talk nw??
Sey i no dey mentor u well?

No be the matter be that, the thing be say u no dey reason my side. Since last week nai everybody dey embarax me, u side me?? Na com good thing be dat as a mentor? sad

And u still dey expose some of those small secrets wen get security..cry
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 6:13am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
y i no go fear? Coz u dey comfortable, u wan mah follow dey comfortable?
How i go take teach u wen i no even believe sey u go knw hw 2 teach me?

If i b mama junior, u go gree b papa junior?

Me na good teaching person oo, I get PHD for teachingnomia. I go make the things sink for ur brain and u go come dey think about them foreva. I good pass all ur big bellied, womanizing lecturers oo. We go dey comfortable after the first 4hours of steady none stop prophessional lecture.,


No na, as u be my mentor so I go be Uncle Junior na grin
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:27am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
how i go take knw??
Na me send u skul?

Why you no go know?

Must u send me go school first?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:29am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
Una dey fly?
U no knw sey i 4 lyk join dat kingdom?
I no fit kum be princess 4 dia?

No oo, no be bird ing stuff, but we dey waka for air sha..

You must get aim oo, u no know say dem dey fill form?


Princess? And u never join? No problem, come reign with mesmiley but you sure say u get good plans for us so?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:35am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
which tin again housegirl d give her master??

B4 nko? As ur broda marry am, u no knw sey hin go sufèr?

Apart from kondu?? U be gel boy, u sure say u no get house boy so?

The girl na hotie, she wan even hot pass you sef. Wetin u feel say she use take seduce my classful brother marry am, wen she no sabi cook? sad

when I see her face, I feel say na enjoyment oo. . .but now, you go mind me?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:36am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
since wen i bcme ur persnal persin sef?

You dey deny her?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:40am On Nov 02, 2013
Jovanna: wetin be ur own 4 our mater sef? Ur broda no knw say i no sabi cuk b4 e cari me 4 huze? Abi u want mah kill dat huzegurl u wan bring?

No be your cute face, luxirous back and ostentatous front decieve all of us?

Now we know better.

No just try am, the girl get man features ooo. Na 10.5ft tall, she grab join her beauty oo. Her face dey bring smoke, just respect ursef make una live peacefully like partners in crime.. U dey hear so?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:50am On Nov 02, 2013
Jovanna: i ask u sef join nw abi u no fit ansa?

Habaa, me na strong Christian na, u neva hear my story?


Okay make I yarn you:

My papa na pastor, my elda broda na pastor, my 3 sisters marry prayer warriors each of them na pastors too. Two of ma cousins dey carry bible for Deeper Life general Kumuyi. My grand papa nai father Benson Idahosa, my great grand uncle junior brother nai teach T.b Joshua and Pastor Chris Bible. My best friend na tight padi to Johnson Suleiman. My great great great great great great great grand nephew first son wife niece senior brother, nai follow Ajayi Crowther come back to 9ja, but hin no gry show face b'cos of holiness nai make them no hear hin name. . .abi make I continue?


What more u want mke I yarn you? Eh?

With all these records, I go fit pursue Chickens, I mean chicks? sad
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:53am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
hw dat wan take concern u?
No b na nrmal tin 2 disturb chicks wey dey area??
Or u wan follow am?

Normal thing ke? Me na born again ooo.

I'm married to the Word of God, Girs on black and white leave me alone..grin
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:53am On Nov 02, 2013
Jovanna: since 1901 abi u don 4get?

You sef don 4get, na since 1900, why u add one year join?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:55am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
u no cari ur eye c all d questns wey dey here?
U wan mah ask more questions?

You dey mind am?

Why u catch the slap wen I throw give am na?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:57am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
y e no go concern am?
Wen u bin marry hin broda u no bin knw d matter go concern am??
U go fit fiqht dat house girl wey dey fiqht lyk tiger?

300 Gboza for you jor...

But how you take know about this house girl be4 I talk? You no sure say u dey search my secret files so?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:57am On Nov 02, 2013
larride: Una still dey on top this mata?

Na under the matter u want make we dey?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 10:30am On Nov 02, 2013
larride: Una still dey on top this mata?
which mata again u wan mek we dey ontop?
Y u no follow us kum dey ontop d mata too?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 10:33am On Nov 02, 2013
E<R>F:


That na understatement sef, the boy head round and oily. Him like to barb Akpan/bololo/skin cut, everyday na him head I dey take dey check my face 4 hin head because in clear pass mirror. In no too tall but him tall pass usain bolt, hin chest broad pass una door, him get big yannsh. Him perfume na die ooo. . .wetin you wan hear again to make u understand say dis boy na BOOMBB? grin

All dis na 4 only 1 persn?

1 Like

Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 11:13am On Nov 02, 2013
E<R>F:


No be the matter be that, the thing be say u no dey reason my side. Since last week nai everybody dey embarax me, u side me?? Na com good thing be dat as a mentor? sad

And u still dey expose some of those small secrets wen get security..cry
na dat small tin dey mek u kum dey cry??
Abi i no try small?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 11:24am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
y e no go concern am?
Wen u bin marry hin broda u no bin knw d matter go concern am??
U go fit fiqht dat house girl wey dey fiqht lyk tiger?
aproko no put ur mouth 4 dis matter o, abi u be part of our family ni? Abi na u be d huze gurl sef?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 11:25am On Nov 02, 2013
PretiEbony:
hah! U bin born dat tym??
u knw how old i be?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 11:28am On Nov 02, 2013
E<R>F:


No be your cute face, luxirous back and ostentatous front decieve all of us?

Now we know better.

No just try am, the girl get man features ooo. Na 10.5ft tall, she grab join her beauty oo. Her face dey bring smoke, just respect ursef make una live peacefully like partners in crime.. U dey hear so?
u want make thunder strike ur maut shey? No help me try nonsense o abeg
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 11:32am On Nov 02, 2013
E<R>F:


Habaa, me na strong Christian na, u neva hear my story?


Okay make I yarn you:

My papa na pastor, my elda broda na pastor, my 3 sisters marry prayer warriors each of them na pastors too. Two of ma cousins dey carry bible for Deeper Life general Kumuyi. My grand papa nai father Benson Idahosa, my great grand uncle junior brother nai teach T.b Joshua and Pastor Chris Bible. My best friend na tight padi to Johnson Suleiman. My great great great great great great great grand nephew first son wife niece senior brother, nai follow Ajayi Crowther come back to 9ja, but hin no gry show face b'cos of holiness nai make them no hear hin name. . .abi make I continue?


What more u want mke I yarn you? Eh?

With all these records, I go fit pursue Chickens, I mean chicks? sad
who ask u history? Nd wetin be d moral lesson dis story sef? Bt u sabi lie o, who tell u all dis jagbajatins?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 12:26pm On Nov 02, 2013
PretiEbony:
All dis na 4 only 1 persn?

Na come two pipo b4?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 12:28pm On Nov 02, 2013
PretiEbony:
na dat small tin dey mek u kum dey cry??
Abi i no try small?

That thing na small thing to you?


You try small sha but, you suppose dey tie red vadan for your head like Nijas, add some rope round your waist, buy sharp cutlass take pursue all of them wen dey embarax me. . .no be that one be better try? cheesy
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 12:32pm On Nov 02, 2013
Jovanna: aproko no put ur mouth 4 dis matter o, abi u be part of our family ni? Abi na u be d huze gurl sef?

No be she be the house girl oo, but she know am. The girl na area scatter for their town, top babe wen no dey take nonsense from pipo. She don beat PretiEbony once sef, since then she dey respect her. So as a friend and a personal person, she no want make u get that kain experience. . .abi no be good friend she be? grin
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 12:33pm On Nov 02, 2013
Jovanna: u knw how old i be?

You dey gree old? No be the way you dey 19th century nai u still dey?
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 12:38pm On Nov 02, 2013
Jovanna: u want make thunder strike ur maut shey? No help me try nonsense o abeg

No dey fear grin you be action mama, na only food side comma dey. Everyoda side straight like witch, so make u fight back, You can do this- I trust you. You oo know say I like to see you with rise eye and swollen body, plus fat leg and bend waist? grin
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 12:41pm On Nov 02, 2013
Jovanna: who ask u history? Nd wetin be d moral lesson dis story sef? Bt u sabi lie o, who tell u all dis jagbajatins?

No be the history go ease ur tension?

The moral lesson be say, ERF is a saint infact, call me Saint ERF. You dey hear?


Lie ko Jagbajatins ni? I neva lie or jagbajatize since my mama born me ooosad
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 9:51am On Nov 04, 2013
Whr'z everybdy nau??
Shey una no wan ask question again?

(1) (2) (3) ... (5) (6) (7) (8) (9) (Reply)

3rd Term Examination Questions And Answers / Things men do that upset women / Six Truths In Life

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.