Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,198,671 members, 7,968,940 topics. Date: Monday, 07 October 2024 at 03:35 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) (1295 Views)
Oh BOY! Nigerian Student Breaks World Record For Longer Sex Ever" / OH Boy I Don Dyee; Girls Don Suffer For This We Country{pics}wicked Name / No Girl On Nairaland Is Finer Than My Girlfriend, No One (pix) (2) (3) (4)
Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 3:14pm On Sep 04, 2014 |
Almost every girl, don dey do runz for naija now e go hard make you see girl wey nor dey yanshh one bobo or her father mate because of money for korro sotey na competition now if you enter portharcourt wey I dey, men you go fear fear especially all those campus girls wey dey carry Big Big phone and iPad for offices o, na the same Thing if oga don yanshh am one sweet bobo customer go enter Abuja na worst, where my duplex dey for asokoro, my guy come jam naija babes wey don bleach their bone come out kpatakpata haba, na so wey go dey?? nor mention Lagos(persin go faint) if you kon say make you find woman go church? Bros they worst oooo all those choir wey dey form soprano and alto, many of them na resident pastor dey shine their "klicto" my broda Life taya me for were women dey oo better ones don finish!!!! how you see am na?? 4 Likes 3 Shares |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 3:42pm On Sep 04, 2014 |
Hahaha.....girls don suffer |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by valmunich(m): 3:48pm On Sep 04, 2014 |
So wetin you wan make we do now as u talk am so ? |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by kilimanjaro(m): 4:43pm On Sep 04, 2014 |
Na so we see am o, 98.9% of Abuja girls na runs dem dey do. If you ask dem, dem go say na guys cos am. Lol, guys, make una sef no dey jilt dem now. |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by 100Cents: 4:58pm On Sep 04, 2014 |
This world is rotten. I regret not marrying some 5 years ago. I was running after money and financial security.. I have spent so much cash dating absolutely useless girls who would enter your house, fold their legs, get served by me, yet they can't dress a bed or move a stool. Girls now see dating as business, no longer a means to getting married. They have monetized dating. You become her driver, her sponsor, her recharge card dealer and after all that, she won't even respect you.. Smh. God help me.. 4 Likes |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by mencade5(m): 5:00pm On Sep 04, 2014 |
my brother, for dis obodo naija wey we dey so things don spoil reach ground finish o. If u say make u turn left look for correct babe na rubbish you go see, right nko? Na nansense! Girls for naija don turn kpotokpoto finish oo. E get one time wey i visit north, i think say their Erima go make sense, for where? The runz gals wey i jam no be here oo. Yongwizzzy i go still dey talk am, e better make guys dey marry una 18 and 19 them. Atleast if them spoil, them no too spoil like that. We go manage am. But say you want go for 24 and above them? Bros e, make i no talk. Na cry i dey cry like this. Eeeeewwoooooooo! *blows mucus from nose* 2 Likes |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by chimerase2: 5:47pm On Sep 04, 2014 |
Even small pikin way dem born new if no be one tin I for talk say no be virgin |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 6:10pm On Sep 04, 2014 |
Walahi things don spoil finish |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Crocz(m): 6:14pm On Sep 04, 2014 |
Word of advice...there are still some gorgeously dressing girls in the village wearing blouse on-top ready made skirt...sounds perfect eh? |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by raquel23(f): 6:29pm On Sep 04, 2014 |
D tin be say these same runz girls as u call am na men lik u go still marry dem d good ones still dey buy aso-ebi for ashawo wedding 1 Like |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 6:46pm On Sep 04, 2014 |
Crocz: Word of advice...there are still some gorgeously dressing girls in the village wearing blouse on-top ready made skirt...sounds perfect eh? I prefer responsible mgbeke pass olosho blackberry bleached pawpaw like your babe |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Crocz(m): 6:50pm On Sep 04, 2014 |
Yungwizzzy: Which of my babes?...if I wan marry I know where market dey na |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by ifycares(f): 7:17pm On Sep 04, 2014 |
after messing up d good grls ,una goho begin dey look for fresh girls to marry,who una come leave d bad ones for |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by goalburner(m): 9:16pm On Sep 04, 2014 |
ifycares: after messing up d good grls ,una goho begin dey look for fresh girls to marry,who una come leave d bad ones forchurch brothers. Trust me, my brothers in chrch can marry any lady bad or good only if she becomes born again. Only for the pastor to do the needful pastor: Bro Paul, Holy spirit told me 25 times that sister Mary..... |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by ifycares(f): 9:18pm On Sep 04, 2014 |
[quote author=goalburner] church brothers. Trust me, my brothers in chrch can marry any lady bad or good only if she becomes born again. Only for the pastor to do the needful pastor: Bro Paul, Holy spirit told me 25 times that sister Mary.....[/quote hmmmmm i see |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by lexrichy(m): 9:28pm On Sep 04, 2014 |
I don book this space.. Pidgin hard sha |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by adeoladrg(m): 9:39pm On Sep 04, 2014 |
I strongly believe in the 'like attracts like' philosophy. There are still wife materials out there, buh we aren't patient enough. |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by isi4(m): 9:47pm On Sep 04, 2014 |
Just wana ask how do u all see a girl wey dey come directly from church come greet person but wear short gan (wey breeze fit lift up) and pant only Just still wondering sha. My first time to comment on Romance section ever, though can't do without reading all the Topics and some hilarious comments daily. |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 10:02pm On Sep 04, 2014 |
women this women that......una no de tire to carry our mata ontop head like gala? Wait I de come |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 10:08pm On Sep 04, 2014 |
miztola: women this women that......una no de tire to carry our mata ontop head like gala?ghen ghen |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by tobiboss(m): 3:48pm On Sep 05, 2014 |
D tin get as e b sef, omor na God hand we dey oh, al dese girls dem wher moni don cova dia brain. How was my pidgin english?? 1 Like |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 4:27pm On Sep 05, 2014 |
Yungwizzzy: Almost every girl, don dey do runz for naija nowna2 go nursery school go dey nurse future wife till she mature be that oh...abi how una see am so |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Spidermon: 4:45pm On Sep 05, 2014 |
Sometimes ehn, I go just dey reason maybe e go better make person just go ashawo house go marry. Some gals look decent but their puna has had more customers than shoprite. 1 Like |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Houseofglam7(f): 5:03pm On Sep 05, 2014 |
You get duplex for Asokoro? Potential maga! |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Deiok(m): 5:05pm On Sep 05, 2014 |
My broda the tin don tire evri bodi, even 12 years old girls for nigeria com dey form runs nowadays. Dem go wan carry big fone wey fear nor go let dere papi wether rich or poor carry around. Com dey flaunt their different attachment and all their artificial poos up and down the street. The one wey dey pain me pass nah the fact say them don even worst pass those wey dey on sex trade bussines. Infact those ones nah learner for were some nigeria girls dey fo naija my country....;(;( chia chai... The one wey dey make me cry pass nah those ones wey dey go give their grandpapa mate their ponny wey them suppose reserve for their future husband, the thing bad sote patience jona our first lady com begin dey cry... " chia chia... There is godu oooh all these ponny you are sharing because of money.... " . Abeg we guys need to hold fasting and prayer for this matter ooh. 2 Likes |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 5:11pm On Sep 05, 2014 |
gmyguy: na2 go nursery school go dey nurse future wife till she mature be that oh...abi how una see am so Bros u funny die!!! but you sure say child right activists them nor go gbab persin?? |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 5:13pm On Sep 05, 2014 |
Houseofglam7: You get duplex for Asokoro? pm me baby I dey pay well I swear 1 Like |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Ghost01(m): 5:22pm On Sep 05, 2014 |
You Nairalanders no go kill person. Lmao 1 Like |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Houseofglam7(f): 5:33pm On Sep 05, 2014 |
Yungwizzzy: Warrrefa u dey pay, I go double am I swear. |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Nobody: 5:45pm On Sep 05, 2014 |
Houseofglam7: double satisfaction?? wow I've seen the pm |
Re: Oh Boy, No Girl To Marry Again Oo??(pigin English Complain Thread) by Houseofglam7(f): 5:59pm On Sep 05, 2014 |
Yungwizzzy: Who send you? ya village people abi? |
(1) (Reply)
Men Who Hate Women AND Women Who Hate Men / Letter To The Greedy Guys.(a Must See) / How Come When A Girl Snatches A Girls Boyfriend, She Hates The Girl/ex Girlie?
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37 |