Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,193,549 members, 7,951,293 topics. Date: Tuesday, 17 September 2024 at 01:45 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English (1549 Views)
Caf U23 Championship Qualifier :Nigeria 0 Vs Congo 0 (Live) / Olympic Qualifier: Nigeria Vs Congo (U23) 2-1 (Full Time) / Nigeria Vs Congo : AFCON 2015 Qualifiers (2 - 3) On Saturday September 6, 2014 (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English by iamkay(m): 9:37am On Sep 06, 2014 |
De road to enta Morocco for de 2015 Nations cup don open yesterday, and all countri for Africa don dey run dey find de ticket wey go make dem enta Morocco ness year for de competition. Naija go sabee dia level today for Calabar as de Supa Eagus and de Red Devils of Congo go enta de same trouser for dia fess match for de kwalifia for ness year Nations cup. Na Naija be de countri wey win de lass Nations cup for South Africa, and all man don sit down wan see how de Eagus go take start dia waka today. Since de day wey Naija don crash kommot for dis year World Cup, na today go be de fess day wey de Eagus go tap ball again for any level. Walahi, na luck na hin Congo take enta dis Nations cup kwalifia level, becos if no be Rwanda wey do wayo, Congo for no get de chance. Naija and Congo don jam diasef 7 times bifor bifor for international level, and na 3 times na hin Naija take bilala dem. Emmanuel Emenike and Ahmed Musa na hin plenty Naija fans go dey look say make dem waya goal for dem today, and de man talk say na muss make hin score. “I know say de match wey we wan follow Congo play go tough well well, but I don readi for dem becos na muss make I score dem,” na wetin Emenike talk be dat. Meanwilly, Naija go try make dem win dia game against Congo today sake of say South Africa don waka go bilala Sudan 3 kondo for dia house lass nite. Na 5pm Naija time na hin de match go start today for Calabar. |
Re: Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English by Omero(m): 2:11pm On Sep 06, 2014 |
na wich stetion go show d mach? |
Re: Nigeria Vs Congo Live Commentary In Pidgin English by Haywhymido(m): 5:13pm On Sep 06, 2014 |
Dem dey show am 4 one local channel here.wish dem best of luck |
(1) (Reply)
Caf Outlines Afcon Qualifying Rules / . / See Pictures Of Kelechi Iheanacho In 2010 & 2016
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8 |