Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,192,575 members, 7,948,224 topics. Date: Friday, 13 September 2024 at 04:21 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Letter To Some Girls Out There... (594 Views)
How Football Is Changing The Lives Of Some Girls In An Indian Slum!!! (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Letter To Some Girls Out There... by Nobody: 9:22pm On Oct 07, 2014 |
# Girls pt 1 Most times wen I dey go work in d morning,,,,,,, I dey always pass thru national Stadium & e dey always make me laff anytime I see sum girls wey their belle big,,,,,, dey run round stadium,,,,, all in d name of say dem wan get flat tummy But my dear sister,,,,,,,,,, as far say u don vow to dey chop boys money like say 2morrow no dey,,,,,,,, then, ur belle don also vow to dey big everyday like say u be Bendel Brewery Factory Manager. Gone are them days that guys were serial-eaters, nowadays it is the ladies! Guy go use him godly mind take u out,,,,,,, but u go use ur bad mind carry ur glutton friend(s) follow body. Guinness Malt wey everybody know say na 1 u fit drink in a day,,,,,,,, but u & ur glutton friend carry 6-6 bottles drink,,,,,, like say na beer. U feel u're punishing a guy by ordering d whole food in an eatery. We spend the money, You lose d shape, You see a beautiful girl who's got everything, but one thing just kills them: THEIR BELLY. Only u go chop cow tail,,,,, cow head,,,, cow nose & even cow belle....... u b carnivorous animal? Then wen 2morrow reach,,,,,, u go wear tight,,,,, dey run go stadium bcus u want flat tummy....... E b like say u neva hear dat english wey dem dey speak say "u can't eat ur cake & have it" U no dey see oyibo girls belle? U no see as their belle flat?......... D reason wey make their belle flat na bcus dem no get dis bad attitude of "Tessy cum make we go wreck dat guy" Wen u take oyibo girl out,,,,,,, d highest tin wey dat oyibo girl go ask for no pass ice cream & pop corn,,,,,, then 2nd tin wey oyibo girl want 4rm u is just to look her in d eyes & tell her how much u love her as she dey lick d ice cream.......... Datz all But take sum of our Nigerian girls out,,,,, only she go chop egg roll,fish roll, drum roll, toilet roll. She go finish 4rm roll enter,,, meat pie,fish pie,kpomo pie , even chop stockfish pie smh,,,,still chop sausage join,,,,,, chop rice,,,,,, even chop d white paper wey dem give her take clean mouth smh Why u nuh go see most girls having running stomach on monday?,,,,,,,, then on Tuesday,, u see them running round stadium. She dey bounce one side beleh dey bounce follow am(nzobu nzobu) Make una Continue to dey chop guys money....... Na the whole State. una go soon dey run round every morning. |
Re: Letter To Some Girls Out There... by dicksj93: 11:00pm On Oct 07, 2014 |
Ma guy...a beg u tear me wit laff..Biko ma copy paste..inugo |
Re: Letter To Some Girls Out There... by Nobody: 5:52am On Oct 08, 2014 |
its allowed. Ndo!! |
(1) (Reply)
I'm Ready To Resign As NFF Chairman - Pinnick / Coaches Forced To Eat Their Words / Check Out Super Eagles Players Having Dinner After Beating Congo 2-0
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14 |