Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,173,496 members, 7,888,581 topics. Date: Saturday, 13 July 2024 at 10:59 AM

Rich Girlfriend And Broke Guy.. - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Rich Girlfriend And Broke Guy.. (980 Views)

Photo:he Spent 5k At Mr Biggs With His Girlfriend And Wearing This Kind Of Boxer / Lol...hungry And Broke <naija Confam< (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Rich Girlfriend And Broke Guy.. by oadewale(m): 4:47am On Nov 03, 2014
Na Lagos I go ooo, I come see sometin outside my
house when i see one clean beautiful girl come out
from her SUV dey cry dey kneel down dey beg one
slim bobo wey be like say him never chop for
months, the babe just dey beg dey cry dey follow
the guy dey tell am say she no need
money, she no need brazilian wigs,she no want
shoes,house or anything, she say she no even
need the SUV all she want na him love, his kisses
and his warm embrace, guys the babe just dey
shout dey cry, when i hear these words my heart
stop, my head spark and my brain burst, the guy
no even dey look the babe sef na there me i vex
say if this guy no value this girl well Right now me
i don fall in love be that so make i go claim this
girl but As i near there, one man just touch me for
back say oboy abeg no block the camera.. . . .
RUBBISH na one new # NOLLYWOOD film dem dey
Shoot for there. . Hahaha

4 Likes

Re: Rich Girlfriend And Broke Guy.. by nzeaji(m): 4:47am On Nov 03, 2014
Classic Naija. grin grin grin
Re: Rich Girlfriend And Broke Guy.. by kilokeys(m): 5:23am On Nov 03, 2014
hehehehehehehe... lmao.
i for fear o.
d stress class B actors face in nollywood sef..
if u rnt john dumelo or majid nobody wants a love scene with ya. talk more of a broke dude

op. apply as waka pass na.. na 2k o. free money
Re: Rich Girlfriend And Broke Guy.. by Liamm(m): 6:03am On Nov 03, 2014
Lol grin

(1) (Reply)

?? / 'if You're Deaf, I Am Blind' - See Screenshot / Check Out The Soon To Be Olajumoke

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.