Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,173,719 members, 7,889,296 topics. Date: Sunday, 14 July 2024 at 08:18 AM

Christmas Eve Miracle:N850m Spills On The Streets Of Hong Kong - Family - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Family / Christmas Eve Miracle:N850m Spills On The Streets Of Hong Kong (846 Views)

Woman Gives Birth On The Streets In Onitsha (photos) / Unclad Man Roaming The Streets Of Abuja With His Kids All Dressed Up (Photo) / Photo: Lady Lying On The Streets In Surulere, Lagos (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Christmas Eve Miracle:N850m Spills On The Streets Of Hong Kong by AKPOSbaba: 3:49pm On Dec 26, 2014
Christmas groove start early for many pipo for Honk Kong as dem pack plenti money wey spill for road like oil spillage wey appun for Niger Delta.
British security firm, G4S, wey dey responsible to transport about $4.5 million for Hong Kong,don enta heavy igbese (debt) as dia securiti van driver , no know say di back door no lock well and dis one kon make almost all di money troway for one busy highway for Wan Chai.
No be small drama as passers-by,taxi drivers, okada riders, mama, papa, pikin,mama akara and all sort of pipo rush enta road and pack di one wey dia power reach.
All di money wey leak from di bullion van, dey in Hong Kong 500 dollars note.
Out of di $4.5 million,( 850 million for naira),police announce say na $2 million dollars still dey miss and dem don dey beg pipo to return dem or else na 10 years criminal offence dem dey commit so.

READ MORE>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/12/christmas-eve-miracle-for-people-as.html

Re: Christmas Eve Miracle:N850m Spills On The Streets Of Hong Kong by holatin(m): 3:52pm On Dec 26, 2014
really
Re: Christmas Eve Miracle:N850m Spills On The Streets Of Hong Kong by marv1: 3:54pm On Dec 26, 2014
Pls write in english language when giving vital info not everybody can understand pigin.
Re: Christmas Eve Miracle:N850m Spills On The Streets Of Hong Kong by Nobody: 3:57pm On Dec 26, 2014
How to get dat kain money unless dey knw d numbers wey dey d note dem
Re: Christmas Eve Miracle:N850m Spills On The Streets Of Hong Kong by mkpakanaodogwu(m): 4:09pm On Dec 26, 2014
Gbese,na awoof,
Re: Christmas Eve Miracle:N850m Spills On The Streets Of Hong Kong by AKPOSbaba: 4:10pm On Dec 26, 2014
marv1:
Pls write in english language when giving vital info not everybody can understand pigin.

Sorry sir o
(ogakpatakpata..com) is a pidgin english blog for a particular target market.

It is di first language of over 100 million Nigerians. Na di language wey my mama and her friends like to dey speak from morning till night.
Come to think of it...
MTN, GLO, GUNNESS etc, all pass vital information with pidgin English bicos na di lingua franca of Naija pipo be dat.
listen to radio stations..They invest more in pidgin adverts and it put a lot of food in my table.
We no dey form and we no dey use dis language joke for were i come from.

(1) (Reply)

lost my dad 20 years ago . my experience. share yours / Shiloh 2015 From Glory To Glory :) / Weird Relationship With An Uncle, Should I Do Something?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.