Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,200,325 members, 7,974,404 topics. Date: Sunday, 13 October 2024 at 11:47 PM

Mr President : I Dey Beg You - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Mr President : I Dey Beg You (820 Views)

Today, I Prayed For The President; I Prayed For Nigeria. Come In If You Wish To. / Apostle Johnson Suleman: Pray For Senate President, I Saw Him Removed. / If Jonathan Is Returned As President I Will Never Complain About Hardship In Nig (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Mr President : I Dey Beg You by boman2014: 11:28pm On Dec 27, 2014
Dear Mr. President, I just want
beg
you Bros Jonathan. I take all the
gods of Nigeria beg you. I take
all
the gods wey people dey hide
worship beg you. I take the God
wey most of us dey worship
openly
beg you. I take the day wey dem
born you take beg you. I take all
the
things wey you like beg you.
Bros,
as I dey write this ehn, na
prostrate
I prostrate for you oh. I take all
my
heart beg you. I take my papa
yam
farm beg you. I use my papa
cocoa plantation beg you.
I take Anti Party take beg you.
Shey
na 2015? No worry we go dash
you
till 2019. Missing $20 billion? No
be craze de worry Sanusi Lamido,
where him see that kind money
dey
miss, no mind am Bros, we don
comot our mind for that one
too.
We no even want know how you
take dey spend oil subsidy
money
Bros. Spend am anyhow, na you
be
Presido. Even the almost one
trillion
naira for security sef, we don
close our eyes. Bros, if you like
no do
any
road again, we no go ask you.
Fuel
scarcity?? No worry Bros, e don
tey
wey we don dey use to am. We
sabi buy black market. Abi
people wey dey sell am dey from
there get dem own chop no be
we
brothers? Bros, even jobs sef, no
worry your head for that one. Na
you send people make dem born
plenty children? No worry, we
sabi
struggle. Electricity? Forget dat
one
Bros J. How many of we grand
papas
use electricity? Dem no live long?
We go dey manage dat one too.
If
we want enjoy, we go use our
Gencos. Thank God say we never
follow your advice say make we
throw dem away. Bros J., all
these
my begging ehn, na one thing I
need from you.
This one wey Nigerians life no
come
even get value reach cockroach
for
oyinbo land own tire me. Bros,
just
use all your head and mind dey
see
how you go take dey protect our
life. We no need all those things
wey we dey disturb you for. Na
long
throat dey do us. Just help us
make
we dey safe Bros. If you fit do
that
one for us ehn, I go join curse
anybody wey ask you how you
take dey spend we money. We
no want
to dey waka dey fear say the
next
sound fit be bomb sound Bros.
We no want to dey see fellow
struggling Nigerians dey roast
like chickens wey oyinbo say
dem get
bird flu. Bros J, sebi you talk say
you
no get shoe? E mean say you too
be
one of us before before. If dem
former leaders no protect you
allow
bomb finish you, se you for
reach
where you dey so so tey you no
fit
know how many shoes you get.
God
wey carry you reach there never
resign oh and na Him I dey take
beg
you make you do everything to
see say we too live oh. I beg Bros
J.,
no
mind all these people wey say
you
no go continue.
Just protect our life for us. Na
your hand soldiers, police and all
of
them
dey. Use them protect we the
poor
masses too na. No be only the
big
big men and women deserve to
live
safe. We too, na life dey our
body
and wetin fit make wey una dey
where una dey so, we too fit
reach
there oh one day. But, that one
na
only if we live. I take God beg
you
Bros J., na beg I dey beg, no be
strong head.
Greet mama peace,abi wetin
dem
call am,for me!
Re: Mr President : I Dey Beg You by DaBullIT(m): 11:32pm On Dec 27, 2014
Nna bros , Bros J for GEJ no dey hear word o , he dey always form ruggedy baba ,he dey form akpako master , he dey form remix master and he dey form say he be don for the obodo country , but he go wound when 2015 knack ..

1 Like 1 Share

(1) (Reply)

This Is Unfair, ‘rivers’ Monthly Allocation Slashed By 50%’. / Jonathan Trending In Yahoo / Lol. This Can't Be Real, Or Is It? photo of Buhari watching the 'anaconda' video

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.