Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,169,737 members, 7,875,850 topics. Date: Saturday, 29 June 2024 at 11:16 PM

Ejiro And Jude, A Very Touching Story - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Ejiro And Jude, A Very Touching Story (594 Views)

Militants Playing Football On Benin-Lagos Expressway - Ehiwario Jude (Video,Pic) / Jude Nkama Appointed As Judge In New Jersey / Ejiro Adigbo Advises Governor Wike On What Next To Do. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Ejiro And Jude, A Very Touching Story by Nobody: 9:07pm On Nov 20, 2015
USE YOUR BRAIN!
(True Life Story)
Sometimes, when I dey hear some kain
things wey dey happen for relationships and marriage, I dey fear cos some of the
issues dey hit my brain like a tidal wave.
To love somebody nor make you a goat.
Open your eyes.
When dem say love is blind, e nor mean
say you go dey close eye waka. Ejiro dey friend Jude.
Dem two don go far for the relationship.
Na Jude nai break her hymen.
Ejiro na that kain girl wey dey love with
everything she get.
She can do anything to please her man. On several occasions, she don show Jude
say she dey ready to love and love she go
love till she breathe her last.
A time cum come when Jude fall sick.
Doctor cum diagnose say e get kidney
problems. E two kidneys dey fail. And the only solution medically na for
dem to do kidney transfer.
Na there dem for reason who go gree
donate kidney give Jude.
Jude papa and mama and e family
members kidney nor match e own. When Jude ex hear the matter, she still
come salute am for hospital. She cum
agree to donate her own one kidney for
Jude.
Actually, na Jude nai support Angela wey
make her gree go school. Angela na orphan.
When her parents die, her hope of going
to school cum die.
Then dem just finish Secondary school.
But as Jude papa hold e side, Jude cum
support her through her university days. As she dey graduate nai dem take her for
GT bank.
From there nai dem carry her abroad go
do master so that when she come back,
dem go make her Marketing manager.
When she dey yonder, nai Jude take fall in love with Ejiro.
Na so e take start to dey avoid her calls.
Angela find am difficult to love another
person.
When she come back from abroad after
her studies. She start her job as manager for Gt bank.
When she hear of Jude sickness, nai she
take come visit am for hospital.
For her mind, even if na the kidney she
donate for Jude to tell am thank you for
being there for him when she nor get hope, na something.
So, after much diagnosis by the doctor,
dem cum tell her say her kidney nor
match.
Ejiro still come out to volunteer for her
donation. Na Ejiro kidney nai cum match.
Na Ejiro nai donate one kidney give Jude
wey dem transplant befor Jude cum fit
make am.
My pipo, na becos of something nai dey
make all of us dey do atleast anything. Human beings dey always do something
becos of something.
For Ejiro mind, she do wetin she do becos
she love Jude and ready to marry am.
Jude was back on his feet.
He continue his work. Na Jude dey manage he father two filling
Stations.
The ending of that year when Jude go
meet e papa and mama for their room
say e wan see dem.
E say e wan rent house now so that e go fit marry raise e own family.
Since e nor go fit stay with e parents
forever.
E papa cum suggest say e go park go stay
one of e buildings for town.
Say dem go evict one tenant. When dem ask am who e wan marry, he
say na Ejiro.
For e mind, dem nor suppose ask am that
question cos na only Ejiro dem dey see
with am for the past one year plus since
when Angela travel. Na there e mama for tell am say e nor go
fit marry Ejiro cos na Urhobo girl.
Say none of her pikin go marry from
Urhobo base on her experience.
Say she just kpanji since thinking say, as
a guy man, Jude go leave her for someone better, say Urhobo girls are bad.
Jude try to make e mama and papa
explain their reason, but like a dictator, e
father say the only girl dem approve for
am na Angela.
Say make e marry Angela. Angela on her own, nor dey into any
serious relationship then.
Na last last nai Jude for understand say e
parents dey reason say deir pikin get
only one kidney, so dem nor want make
e marry woman with one kidney. Say anything can happen to the two of
dem at any time.
E just dey think so.
See world pipo?
But last last, e cum approach Angela, nai
e decide to marry her. All through when e start to dey see
Angela again, Ejiro dey see the
handwriting for wall.
Na the third time wey she ask am wetin
e get with Angela again nai e open up
give Ejiro say e parents nor approve of their marriage.
That day when Jude dey tell Ejiro say
make she take heart say they can't end
as man and wife, na that day Ejiro world
end.
She went up broken and devastated. Na ears she take hear say Jude marry
Angela the third month of her stay in
town.
Right now, Ejiro is psychologically not
balance.
She dey talk on her own all the time like mad person.
Her parents don carry her go church
where she dey receive prayers.
But none of her family members know of
her kidney donation to Jude.
A woman wey give you a very vital organ, should be appreciated.
But for her case, she was stabbed.
What a world!
What a wicked world!!
Her good don turn bad.
May our good nor turn bad. Amen.
Now let me warn some of our girls.
Becos of love,
# some girls go run comot from house go
stay with boy wey norva marry dem. #Some girls go thief their parents money to go give boy wey norva marry dem.
# Some girls go dey do ashewo dey give
boy money just becos dem love the boy.
#Some girls go even join their boy friend
dey quarrel with their family and loved
ones. My pipo, make unu get sense.
E nor bad to climb mountain for love.
Or take a bullet for someone.
But use your brain.
As long as you are a human, know say
you get limit to what you can do for someone you love.
You can be nice, good, generous and
caring.
You can be someone helper, girlfriend,
wife, sister but never someone's God.
Know when to surrender any situation to God to take control.
So, use your brain.
Na our prayer this afternoon, say
whatever help we render to the ones
Re: Ejiro And Jude, A Very Touching Story by Nobody: 9:08pm On Nov 20, 2015
use your brain.
Na our prayer this afternoon, say
whatever help we render to the ones we
love, dem nor go use am as judgment
against us. Amen.
Who do you blame in this situation?

Jude?

Angela?

Jude Parents?

Or Ejiro?

(1) (Reply)

Photo:Emir Of Kano Sanusi II Visits Victims Of Kano Bomb Blast In Hospital / I Did Not Sack 15 Council Chairmen For Defecting To APC – Wada / The Change Nigeria Needs

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.