Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,191,837 members, 7,945,691 topics. Date: Wednesday, 11 September 2024 at 12:13 AM

Jude Okoye's Open Letter To Ladies. - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Jude Okoye's Open Letter To Ladies. (650 Views)

Jude Okoye Breaks His Silence On P'square's Split / Jude Okoye Shows The Interior Of His House (Photos) / Peter Okoye says P-Square is back! And that brother Jude Okoye is back as MNG (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Jude Okoye's Open Letter To Ladies. by tonero4urch(m): 12:26pm On Mar 07, 2016
A Letter To The Ladies .... by Jude Okoye

# Girls pt 1

Most times wen I dey go work in d morning,,,,,,, I
dey always pass thrru national Stadium & e dey always make me laff anytime I see sum girls wey their belle big,,,,,, dey run round stadium,,,,, all in d name of say dem wan get flat tummy .But my dear sister,,,,,,,,,, as far say u don vow to dey chop boys money like say 2morrow no dey,,,,,,,, then, ur belle don also vow to dey big everyday like say u be Bendel Brewery Factory Manager.

Gone are them days that guys were serial-eaters, nowadays it is the ladies! Guy go use him godly mind
take u out,,,,,,, but u go use ur bad mind carry ur glutton friend(s) follow body. Guinness Malt wey everybody know say na 1 u fit drink in a day,,,,,,,, but u & ur glutton friend carry 6-6 bottles drink,,,,,, like say na beer.
U feel u're punishing a guy by ordering d whole food in an eatery. We spend the money, You lose d shape, You see a beautiful girl who's got everything, but
one thing just kills them: THEIR BELLY.

Only u go chop cow tail,,,,, cow head,,,, cow nose
& even cow belle....... u b carnivorous animal? Then wen
2morrow reach,,,,,, u go wear tight,,,,, dey run go stadium
bcus u want flat tummy....... E b like say u neva hear dat english wey dem dey speak say "u can't eat ur cake & have it" U no dey see oyibo girls belle ? U no see as their belle flat?......... D reason wey make their belle flat na
bcus dem no get dis bad attitude of "Tessy cum make we go wreck dat guy" Wen u take oyibo girl out,,,,,,, d highest tin wey dat oyibo girl go ask for no pass ice cream & pop corn,,,,,, then 2nd tin wey oyibo girl want 4rm u is just to look her in d eyes & tell her how much u love her as she dey lick d ice cream..........Datz all .But take sum of our Nigerian girls out,,,,, only she go chop egg roll,fish roll, drum roll, toilet roll. She go finish 4rm
roll enter,,, meat pie,fish pie,kpomo pie , even chop stockfish pie smh,,,,still chop sausage join,,,,,,chop rice,,,,,, even chop d white paper wey dem give her take clean mouth smh.Why u nuh go see most girls having running stomach on monday?,,,,,,,, then on Tuesday,, u see them running round stadium. She dey bounce one side beleh dey bounce follow am(nzobu nzobu) .Make una Continue to dey chop guys money.......Na the whole
State. una go soon dey run round every morning.

From: Jude Okoye
Re: Jude Okoye's Open Letter To Ladies. by opeyemiieblog(m): 12:37pm On Mar 07, 2016
wooow
Re: Jude Okoye's Open Letter To Ladies. by bennifield11(m): 12:50pm On Mar 07, 2016
Lol,this is funny but true!!!
Re: Jude Okoye's Open Letter To Ladies. by Afrok(m): 1:17pm On Mar 07, 2016
Op u for try use your name nah as the writer, abii because no body sabi your name? undecided
Re: Jude Okoye's Open Letter To Ladies. by nuelzy: 1:50pm On Mar 07, 2016
the stockfish pie and toilet roll got me...gringrin
Re: Jude Okoye's Open Letter To Ladies. by tonero4urch(m): 2:57pm On Mar 07, 2016
Afrok:
Op u for try use your name nah as the writer, abii because no body sabi your name? undecided
@Afrok No be me write am ooooo. na Jude Okoye. Lols

(1) (Reply)

[DETAILS]: Psquare Finally Settles Their Beef And How Paul Apologized. / Olumuyiwa Osinuga's (nomoreloss)death Shows Artiste Associations Fake. / Actress Chinyere Wilfred Shares New Photos To Celebrate Her Birthday Today

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.