Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,209,051 members, 8,004,716 topics. Date: Sunday, 17 November 2024 at 02:07 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. (1032 Views)
Omo!! See Wetin This Girl Carry For Back... / Guys In The House.... Was I Too Hard On This Babe?? / Just Passing My Own On IG And Saw This Babe (2) (3) (4)
See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. by Truefederalism(m): 4:50pm On Apr 12, 2016 |
So last night around 7:30 babe called and asked if we were still going out....I rush like usain bolt go baff wear cloth to comot na im she call again say weda we get light say she dey find where light dey. I tell am say we no get light but say since I no too get money I fit use her icecream money buy fuel. She say no wahala say make I buy. I don baff naa spray perf so no need to baff again. Naim I kukuma carry galon still carry dustbin make I go throway make everywhere sengemenge. As I go buy the fuel she dey call dey disturb; "have you bought the fuel?", "have you put on the gen??" Say she no wan die for heat. For my mind I dey say, "see this girl, all these question and command na because say I dey try make we reconcile? You get Gen for house?" She call again say make I wait for am for junction as e don dey dark already and light no dey street. I say ok come kukuma sidon for uncompleted building wey dey junction dey wait for am dey happy say this fuel wey I buy for #260 per litter no go bad. Heat no go kill am till tomorrow morning...highest highest kpekus go dry, wet, dry again for where fan dey blow am. Na so I sidon for junction with my galon dey wait till she drop from keke....all these one na make street boys no run am street this night o. We don waka go house naa on Gen, babe dey happy dey shine teeth dey watch tv....small small we begin play o...from pillow fight she push me for ground...I go fall stand push am comot bed we go dey laff...she go dey change tv channel dey happy say chai she don miss this place tire...say her friend dey ask am why we break up, say them no know say na me break up with am, and say they always dey talk of how dem dey miss to come watch telemundo. For my mind I dey say "you never chi chomchin, na kpekus dey scratch you this night". We never even begin anything o, just normal on top on top something o and with full regalia sef, plus small small play naim babe say she wan dey go her house! Whaaaat!!! :oFor my fuel? 9 o'clock Gen dey burn! The worst na say once I on gen my two neighbors dey get light....same with when them on. Na so them wire the house o. First I think say babe dey play as she still dey dey reluctant to stand while still insisting verbally on leaving. As she don too talk am I come say ok, say I no go even hold am back say na bus go pursue am come back as buses no dey stay late again as fuel no dey. You see as I find wahala?? Babe shout stand up adjust cloth carry bag. I just dey look am. "Babe your brush still dey here and you know I have a towel for you and there are two big female combs you can use for your hair tomorrow". She no hear that one o, she open door say make I come escort am. First I been no even dey hear am. All my mind dey give me na Gen wey dey burn and how I no fit off am. My neighbors wey don see me carry galon like malam go buy fuel carry girl come back come on gen go dey laff me. Wetin concern them?! Them with their babes go dey alright this night first. Na me go find trouble. I for first ask if she dey sleep over abi she just wan charge phone and powerbank. I just dey look am, I wan cry! I nor know wetin to even reply am as she still stand there dey say make I come escort am. Na so I swallow spit after I don think am finish tell am make she come. As she waka come naim I tell am say "babe, nothing is keeping me from escorting you but I feel really stupid". Omor she begin beg dey explain say she go come again say she wan go wash plate and say this one happen that one happen, say no be first time she dey sleep over be this naa. I just dey look am dey reason my fuel. For my mind I say anyway come dey go make I charge my two batteries, my laptop and my power bank as you don kukuma colobi all the spaces plus my chargers join with all your plenty equipments. She say weda I no wan escort am as I still dey on top bed I say no, say I no dey comot. I no even care if them kidnap you this night, sorry but na so e be. She close door carry herself by herself waka dey go. I never talk to am since then, I no even know if she reach house. she no call, I no call. Abeg my people I do bad?! Na this pinshure wey I see remind me of this matter o 3 Likes 1 Share
|
Re: See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. by multikolour(m): 4:57pm On Apr 12, 2016 |
Brother ke brother ni |
Re: See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. by osesology(m): 5:06pm On Apr 12, 2016 |
Lol! one chance |
Re: See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. by libertyfather(m): 5:18pm On Apr 12, 2016 |
Take heart bro, it does happen.... that weird moment u don nack opa eyin, ale and all colobi tinz |
Re: See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. by Truefederalism(m): 5:24pm On Apr 12, 2016 |
libertyfather: No be small something, brotherly. The matter use me play just like that! |
Re: See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. by Leriebloom(f): 5:27pm On Apr 12, 2016 |
Too long |
Re: See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. by Truefederalism(m): 5:31pm On Apr 12, 2016 |
Leriebloom:#okbye |
Re: See Wetin This Babe Do Me On Top My Fuel. by UyiIredia(m): 5:40pm On Apr 12, 2016 |
The babe don use you catch trips. E be like say you don learn from am sha. Next time I sure say you no go try am again. No fall my hand next time o. 1 Like |
(1) (Reply)
A Letter To My People! / 8 Major Questions To Ask Before You Marry Him / See What This Bible Verse Predicted About Ladies Of Today(baby mamas everywhere]
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21 |