Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,178,830 members, 7,906,047 topics. Date: Wednesday, 31 July 2024 at 01:17 AM

Before You Leave Him Or Her Think Twice! - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Before You Leave Him Or Her Think Twice! (1434 Views)

Think Twice Before You Follow Him To The Hotel: My Personal Encounter / Think Twice About Your Relationship If Your Partner Does Not Have These Three Qu / Why Did You Leave Your Ex? Share Your Experience. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Before You Leave Him Or Her Think Twice! by jonaifame22(m): 6:24pm On Jun 17, 2016
Love is sweet as in very sweet and when it turns sour e go sour pass egusi soup wey person chook hand wey e no come warm am,
You might be contemplating leaving dat gal or that guy for any of the below mentioned points,pls I beg u wth my gtbank ATM card pls think twice.

For ur mind u feel sey the bobo or the erema no fine,chai abeg u fit define beauty for me ehn? Person fit no fine for face atleast e get wetin dem dey call inner beauty why not consider that one na ehn abi shey u neva hear sey monkey no fine but him maale like am like dat? Or as a guy you dey think sey ur babe yansh small like 5 naira offering dat one no mean sey make you free the babe na ehn remember no condition is permanent


If e fit be sey dat guy wey u dey friend broke like breaking plate wey fall smash for ground,chai dat one no mean sey make you come dey abuse the bobo wth him condition,instead as a correct babe why not boost him ego wth sweet words so that the lion in him go rise up like early morning pe,nis ere,ection and before you know wat the guy go make you proud, u fit leave am now and before you go come back him don hammer and you fit see sey na rihanna be him next babe abeg think twice


If it be say the bobo or the erema no get swagger,chai abeg define swagger for me, you wey dey think like dis how many swagger you get when dem born you abeg epp am manage the small swag wey him or she get,abi u neva hear say toto water small buh e reach preek to take baff, abeg teach swag if swag na ur problem



If it be say the guy or the gal no dey satisfy u for bed, buh make I ask you dis queshion shey na every time when you chop u dey belleful, when u no belle ful wetin you dey do,shebi u go drink water,so why not find as you go take discuss wth ur partner on how to satisfy you.instead of to waka leave ur partner for another guy, some of una sef una sex drive run pass all the whole vehicle for ifesinachi transprt so no be any body fault sey the sex no do you


E fit be sey ur fwends dem no like ur partner,wetin consign ur fwends wth ur relationship,shey ur partner wan marry u and ur fwends together? Abeg think twice



A bird at hand e worth two for bush, and a bobbi at a guy's hand e worth two for bra,abeg be wise!

7 Likes 2 Shares

Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by Nobody: 6:28pm On Jun 17, 2016
grin. Op i will only agree if you gimme your gtbank atm card and ur pin...


FTC?!!!!

1 Like

Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by jonaifame22(m): 6:37pm On Jun 17, 2016
teddieee:
grin. Op i will only agree if you gimme your gtbank atm card and ur pin...


FTC?!!!!
my atm pin na 2288,will PM the atm card to you!
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by KingsJohnson(m): 6:38pm On Jun 17, 2016
True talk my broda

1 Like

Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by DLondonboiy: 7:01pm On Jun 17, 2016
what if the girl no fine at all....
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by Nobody: 7:06pm On Jun 17, 2016
jonaifame22:
my atm pin na 2288,will PM the atm card to you!


I'll pretend to believe you
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by jonaifame22(m): 7:51pm On Jun 17, 2016
teddieee:


I'll pretend to believe you
pls do, my word is my bond!
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by callmemuzby(m): 7:55pm On Jun 17, 2016
Where is the atm card......
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by jonaifame22(m): 8:29pm On Jun 17, 2016
DLondonboiy:
what if the girl no fine at all....
chai, my guy love dey blind e no dey see whether person fine or not abeg luv the ugly and facially less priviledged gal like that because no be her fault, dis fine or no fine thing e be like raffle draw na when u don pick na dat time u go come open wetin you pick see for ur self! She no purposely choose the face for herself!
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by ivyT(f): 8:56pm On Jun 17, 2016
M disappointed with this thread


#CauseTroubleFriday

Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by Spactacle(m): 9:01pm On Jun 17, 2016
@op,your head day there like ororo wey full inside bottle gidigban;;
true yarn from you abegi;

1 Like

Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by jonaifame22(m): 9:22pm On Jun 17, 2016
ivyT:
M disappointed with this thread


#CauseTroubleFriday
u have an apple shaped face that makes ur looks so sweet!

1 Like

Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by jonaifame22(m): 6:27am On Jun 18, 2016
callmemuzby:
Where is the atm card......
wetin u wan take am do!
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by jonaifame22(m): 9:08am On Jun 18, 2016
Spactacle:
@op,your head day there like ororo wey full inside bottle gidigban;;
true yarn from you abegi;
thank you my guy,u sef ur head they there!
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by tee59(f): 10:05am On Jun 18, 2016
So u can post smtn reasonable lik dis, grin.
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by Spactacle(m): 10:08am On Jun 18, 2016
jonaifame22:
thank you my guy,u sef ur head they there!


no shakes:i i day like to see true yarns like dis.
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by Generalkorex(m): 7:42pm On Jun 18, 2016
Spactacle:


no shakes:i i day like to see true yarns like dis.
oga gabby inbox me ur digit na sharpboymekorex@gmail.com hope u r doing fine boss
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by jonaifame22(m): 10:25pm On Jun 18, 2016
tee59:
So u can post smtn reasonable lik dis, grin.
maybe sometimes!
Re: Before You Leave Him Or Her Think Twice! by ivyT(f): 10:27pm On Jun 18, 2016
jonaifame22:
u have an apple shaped face that makes ur looks so sweet!

1 Like 2 Shares

(1) (Reply)

. / Lol.husband Snatcher.ladies What Will You Do If Such Happens.(pics) / OMG! This Lady Claims To Have The Biggest Butt On Instagram [image ]

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.