Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,198,488 members, 7,968,344 topics. Date: Monday, 07 October 2024 at 04:32 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / A Facebooker's Poem About The State Of Naija. Written In Broken English! (535 Views)
BROKEN HEDGE By Toyin Taiwo / The Bond That Can Never Be Broken / A Broken Destiny: The Sword Of Vengeance (2) (3) (4)
(1) (Reply)
A Facebooker's Poem About The State Of Naija. Written In Broken English! by Brightgem(f): 7:51pm On Sep 09, 2016 |
Na today dem start to learn to theif? Na today dem begin to crown theif as cheif? Chai! We don truly see things! Chai! We don really hear things! The other day dem say: Country hard, money no dey But every time, we dey hear Millz Every time, we dey hear Billz Every time, na another news The other day dem say: "Things go change" but we still dey wait Na here we dey, we never see the change Hunger dey, people dey die Hunger dey, crime don dey so high Imagine dem plan to chatter jeeps When all men dey look for food to eat The other day dem say: Job go dey but we still dey wait Na today dem start to lie? Na today wahala rife? Dem sabi conjure lie Masters of propaganda Dem whitewash things to turn black to white Dem wan put cotton for our eyes Dem dey try to hypnotise our mind Make we no see things as dem don make am to be But we all don pass dat side Our psyche don start to high We don dey accustomed to their lies Dem dey try to take us for a ride Bring the change before kasala go blow Imagine dem come for our votes Dem beg, dem say dey wan serve us Dem beg, dem say dey go make us smile Imagine, dem promise us Jericho Dem say dey go bring us milk and honey Dem say dey go bring us sweet and money Dem sweet talk us till dey confuse our mind Dem sweet talk us till dey make us blind Imagine wen we give dem our votes By then, dem come draw up the blinds By then, dem come start to rip our minds By then, servants come transform to masters Imagine wen we give dem our votes By then, dey come take us back to Egypt By then, we come realize their deceit By then, we come dey see their conceit Imagine when we come give dem our votes Rather than milk dem come dey feed us vinegar Them say we dey sick so we need to heal Rather than honey, dem release the bees on our bodies Rather than money, dem begin to tell us stories Chai! Money no dey, money no dey Yet we dey hear recovered trillions Imagine when tomatoes come cost pass apple Imagine when mama exchange pikin for garri Imagine when papa exchange pikin for money Chai! Suffer dey, suffer dey Na whom we go blame Dem no like to hear the truth When you tell dem all the truth Dem go dey vex, while their mien go start to change When you tell dem truth, dem go send the state apparatus after you Dem go get a lie to cover the truth Even now as I dey yarn, no surprise when dem pick me up Their oga no like criticism Him lieutenants, ever ready to please Go swoop on you even before you blink an eye Since dem land, na gidigbo among themselves Since dem come, their house don begin to scatter Chai! Which kind yawa we don enter Chai! Who go save us from all these wahala. Written by a friend JOSEPH IMAKU. https://www.facebook.com/joseph.imaku?hc_ref=NEWSFEED&fref=nf |
Re: A Facebooker's Poem About The State Of Naija. Written In Broken English! by pheyikemi: 8:05pm On Sep 09, 2016 |
Nice one, to show how bad things are, people wey dey chop for dream nor sabi food chop in their dreams anymore since this administation started. 1 Like |
(1) (Reply)
Have You Complained Today? / Guide Our Leaders Right. / ILLS Of Militancy And Terrorism
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17 |