Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,199,310 members, 7,971,131 topics. Date: Wednesday, 09 October 2024 at 11:16 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Pidgin Proverbs... (737 Views)
Proverbs From The Streets Of Warri / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up / Nigerian Pidgin Proverbs And Their Translation. (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Pidgin Proverbs... by ferdvict2(m): 12:52pm On Oct 25, 2016 |
1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin. 2. Woman wey never see problem... Na im dey still hold breast run. 3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep. 4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am. 5. Na for afternoon dem dey find black goat. 6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg. 7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD. 8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march? 9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far. 10. Person wey don faint before no be stranger to death. 11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see. 12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains. 13. Yansh no get teeth but e dey cut shit. 14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hailam!! é go hail himself 15. Toto water small, but é reach prick take baff. 16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND. 17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck. 18. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside. 19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man. 20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat. 21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch. 22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open. 23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK. 24. Dem no dey tell tortoise say race don start. 25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food. 26. Before you see monkey, monkey don see you. 27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again. 28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury. 29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am. ADD YOUR OWN TO THE LIST BELOW... |
Re: Pidgin Proverbs... by Nobody: 3:49pm On Oct 25, 2016 |
Breeze don blow, fowl nyansh don open. Na condition make crayfish bend. 1 Like |
Re: Pidgin Proverbs... by 1shortblackboy: 1:01am On Oct 28, 2016 |
okpolo eye no be open eye woman fit piss inside bottle ? Instead of trouble make rain fall Provision is better than kiosk 1 Like |
(1) (Reply)
Dear New Generation Igbo Parents, Stop Cheating Your Children / Reno Omokri Writes Special Tributes To Yoruba In Nigeria / Wallabies Vs All Blacks
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10 |