Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,207,371 members, 7,998,761 topics. Date: Sunday, 10 November 2024 at 06:47 AM

How You Fit Get Money Tek Start Your Own Bizness (nigerian Pidgin) - Business - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Business / How You Fit Get Money Tek Start Your Own Bizness (nigerian Pidgin) (471 Views)

Tony Elumelu Hits The Gym To Keep Fit (Photos) / Bill Gates Speaks Pidgin English On BBC (Video) / Oyinbo Man Spotted In Nigeria Pricing Banana In Fluent Pidgin English (2) (3) (4)

(1) (Reply)

How You Fit Get Money Tek Start Your Own Bizness (nigerian Pidgin) by eadiatu: 6:57pm On Nov 23, 2016
How You Fit Get Money Tek Start Your Own Bizness

To tek start your own bizness no be moi moi at all. No matter how the bizness fit small reach, the true talk be sey you go need money. The question be sey, how you fit get money tek start your own bizness and at last mek you be your own oga?
Savings: The best wey to start your own bizness na make you save the money yourself.
With that, you go get rest of mind as you dey do your bizness. You fit open bank account to take save the money or you fit open policy with insurance company. Before you open eye close am, you go done save beta money to take start your own biz and at last, you fitbe your own oga for life.
Friends and family: The second wey to tek save money for your bizness na to go meet your friend or any one for your family.Na like this many bizness pipul tek start their own bizness. You fit dey reason am say why you need to go ask for loan from a friend or relative? The reason be sey those pipul know you wella, dem no sey you no go fit cut back. Another advantage wey dey there be sey, them no go ask you make you go bring document for your house or car to tek do collateral.
Pension Fund: If e remain small mek you retire and you wan start your own bizness, you fit use your pension money or part of am tek arrange your biz.
Banks: The fourth wey to take raise money tek start you won bizness na to go collect loan from bank. I beg, remember sey nothing goes for nothing o, bank go ask you mek you brink collateral and the interest wey dem go put on top no be small o. But if you fit plan you bizness well well, you go fit pay back the money wey you borrow from dem and your bizness go still dey go well.
Copyright: E.M. ADIATU
For more articles in Nigerian Pidgin, please visit: [url][/url]www.nigerianpidgin.com
Re: How You Fit Get Money Tek Start Your Own Bizness (nigerian Pidgin) by eezeribe(m): 8:12pm On Nov 23, 2016
Op Na true tori you de yarn.., Tiri gbosa for you...
GBOSA! GBOSA!! GBOSA!!!
Re: How You Fit Get Money Tek Start Your Own Bizness (nigerian Pidgin) by eadiatu: 9:37pm On Nov 23, 2016
You do well my brother. Mek all of us dey support Nigerian Pidgin together. E.M. Adiatu

(1) (Reply)

Printers Needed For A Printing Job... / The Inspiring Story Of A Nigerian Entrepreneur Who Created A $6 Million Business / Hundreds Of Businesses Storm Anambra International Trade Fair

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.