Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,206,110 members, 7,994,777 topics. Date: Tuesday, 05 November 2024 at 08:12 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Abba Fada- Poem In Pidgin (476 Views)
Meet "Extraordinaire" The Brain Behind Fada Fada And Runtown's Mad Over You. / Nigeria National Anthem In Pidgin / Wedding IV In Pidgin: Hit Or Miss (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Abba Fada- Poem In Pidgin by lalaponcus(m): 9:05am On Jan 04, 2017 |
Twale baba. Your people dey hail your name. Bokun Bokun na your mercies for our lives. Yakata, na im your blessings dey fall from heaven. Na fall devil be for wan fall our hand. So so gbege na im we dey find ourselves. Until you show. Like area boy wey see soldier headlight, Our enemies tear race commot. Like LASTMA wey see Dangote truck. Their head follow their leg reason well for race. Na so we see am o. Na so alert dey enter. Na so crase begin worry our enemies. Na so our pregnant women dey born full ground. Na so book begin enter our dull head. Na so customers dey enter without marketing. Na so money dey multiply without MMM. Na so we praise you. Oga bros. Aunty. Okpeke. Pikin. Run go meet am o if you wan enjoy. No dull yasef for this deal wey Him dey offer. Him name na Jesus. Bros J for short. Correct paale for people wey dia papa don kpeme. Confirm maale wey no go run if gbege enter area. Because Him odi-eshi pass every other one. Him name na Jesus. And I like make you sef taste am too. Make blessings full ya belle. Make constipation of joy worry you well. Make you sef follow us chop everlasting life. #NaBashorun Check out more of these articles at okontas..com
|
(1) (Reply)
Best Marriage Advice Ever By A Dad To His Son. This Is Gold! / Luis Suarez Hits The 100th Goal Landmark For F.C. Barcelona / Wow!!! See This Excellent Galevant And Sacroscant Quote From A Young School Boy
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7 |