Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,209,255 members, 8,005,443 topics. Date: Monday, 18 November 2024 at 02:05 AM

Praise Father, Son And Hol Am Dere! - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Praise Father, Son And Hol Am Dere! (348 Views)

Governor Akeredolu Commends Ondo Pilgrims For Displaying Good Conduct During Hol / Photos- Actress Joke Muyiwa, Son And Daughter-in-law Survive Car Accident / Here N Dere- Dubai (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Praise Father, Son And Hol Am Dere! by lalaponcus(m): 1:25pm On Apr 30, 2017
PRAISE FATHER, SON AND HOL AM DERE!

(Runs towards a sitting brother)

Abeg who you dey praise wey you dey siddon for dia.
Because I nor sure say you know who you dey praise.

The Agbada-gburu wey 'Buratai-ze' your enemies.

The Alagbada Ina wey make NEPA to on light ontop your mata.

You sef remember na!
How that exam and lecturer wan use u do suya for mallam shop.
How that poverty take you shine for front of everybody
So tey people wey poor sef dey use you take thank God say their own case different.
So tey no rat gree show face inside ya room unto say na shine your pot dey shine every time.
So tey the local dog for neighborhood dey go hustle bone, come drop for your doormot say make una two share am because say your condition critical.

Abi you nor remember?

How those nurses don begin call you chief tenant for the hospital.
How the 100 level students don begin call you Grandfather for class.
How the buka people don begin call you 'chief-plate washer'
How everyone for church don see you as commander in chief of prayer warriors
Unto say your case get as e be, and you fight better battle to break loose.

So now you don become big man na.
Dey swing; one step right, one step left; when better praise dey go one.
Dey raise hand mid-way when them say make you wave for God.

"Thunder fi..."
Bia, nor let make I mistalk for hia o.

Just stand and begin to do the needful.
Dey komole when better Alujo Jesu (dance for Jesu) hit the floor.
Dey speak everything wey Baba God do for you wen time reach.

Unto say..
Unto say....
Na person wey praise na im God dey raise.
Church don close.
#BASHORUN

Okontas.com

(1) (Reply)

May Day: Buhari Assures Nigerian Workers Of New Minimum Wage In 2017 / Laziness Or Normal: Washing Ladies Underwear With Washing Machine / Today Sure Game100% Accurate

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.