Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,209,263 members, 8,005,462 topics. Date: Monday, 18 November 2024 at 03:54 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Takun La: Beru Olorun (fear God) (376 Views)
Father Distroy Nigeria And Let Us Start Afresh Nitori Olorun - Nairalander / The meaning of " la vida loca" (photo) / La Clique La Bend..... MEHOON (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Takun La: Beru Olorun (fear God) by lalaponcus(m): 9:34am On May 03, 2017 |
TAKUN LA: BERU OLORUN (FEAR GOD) Alhaji beeru Olorun. Everyday na fight for una house. So tey na slap don become the ring tone wey una dey use wake me. 'Alhaja nor put enough salt for soup' 'Alhaja nor come home early from work yesterday' 'Alhaja nor gree me to perform my man duties yesterday' So so complain wey u dey render in defense of your callousness. Abeg do examine yasef first. Old agbaya wey dey raise im hand to beat im wife. Fake alfa wey go dey preach peace outside but im house dey boil. Wicked man wey don 'koju-ife (professed love)' to younger alfa wives while im get wife for house. Takun La Alhaja. Na Alhaji private life you don dey circulate all around the mosque. So tey every pikin for 'ile keu (school of koranic studies)' don know say Alhaji na two minute man for bed. So tey all the other Hajias don know say na only 300 naira im dey provide for soup every two days. So tey other men don begin disrespect Alhaji because gist dey go round say im mama get drinking problems. Beeru Olorun dakun Fear the creator and stop it all. Stop wrecking your home with your own hands biko. Desist from acts of wickedness for they lay precedent for the little ones around. Abi you nor know? Say Segun, una son, don begin think say na normal tin to beat woman. Unto say Alhaji vs Alhaji don turn everyday thing like NTA news. Say Teniola, una daughter, don begin think say na excellent thing to bad mouth her future husband for public. Unto say na every Alhaja visitor dey hear the latest gist of Alhaji incompetence. Make una fear God o. Else na terrible pikin go bury una for future. Pikin wey go corrupt the world because una don corrupt them from small. Takun La le kan si. Beeru Olorun le kan si (fear God once more) #BASHORUN Okontas.com
|
(1) (Reply)
Lagos State Government Withdraws Dreaded VIO From Lagos Roads / Beliefs. / Nairaland Administrator
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9 |