Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,171,528 members, 7,881,791 topics. Date: Saturday, 06 July 2024 at 09:16 AM

Thank God For Kini? - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Thank God For Kini? (385 Views)

Birthday Poem To Thank God From Garcia / How I First Got Introduced To Kini / Chimamanda’s Thank You Note To Michelle Obama (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Thank God For Kini? by lalaponcus(m): 10:38am On Aug 03, 2017
THANK GOD FOR KINI?

Dakun o
Wetin I dey give thanks for?
Shey na for my empty kitchen wey church rats dey fear to enter?
Abi na for the 'shin-gbain nothing' wey nor dey my pockets.?

Oh
Shey you feel say because I enter sweet sensation and silverbird last week,
That na why you think say omo boy don hammer better.

Well.
Na cleaner work I find go dia o
And that work nor even reach my hand unto say unemployment don kpafuka we country.

Na so some chairmen welay me for road join sef.
Begin romance my cheeks with better slap because I no wan gree release the last 500 naira wey dey my hand.

Na so one yeye boy use me take shine sef.
Dey call me 'dead broke-ass-niggur' because say I no wan gree give am chance to jump line for atm queue.
Thank God say me nor even know wetin e mean sef.
Otherwise kasala for burst for inside that banking hall that hot afternoon wey sun dey wire me for head.

Now you dey tell me to go do thanksgiving.

Make I go church dey begin smile like who don chop food wey woman jazz with love portion.

Make I dey dance go drop offering like fowl wey don mistakenly pass where ukwani boys dey smoke igbo.

Make I dey smile tell my neighbor say 'God is good', like pikin wey fear of im mama koboko force am to go apologize to teacher wey im abuse.

Make I come begin say 'bless you sister, bless you broda' after church like person wey don get assurance say im go chop belle-full after church eh?

(Bashorun intercepts)
"OGAAAAA"
You too complain abegi.

Na only you dey carry the problem of this world for back?
Abi you never hear say the rich also cry too.

I say make you go give thanks.
For the life wey baba supply you, go thank am.
Say those gbo gbo Haram boys never blow up your legs, go thank am.

Say them nor born you for place where them dey cut person lip for fun, go thank am.

Say you get small garri to soak and you no dey bend down to drink mud water, go thank am.

Say stray bullet nor dey lodge inside your skull, like nasty visitor wey no wan leave, go thank God.

Say you even get house for head, go thank am

Go thank am because na person wey dey give, na im dey recieve.
#BASHORUN

Okontas.com

Hello friend. This Sunday is thanksgiving service for most churches. Let this coming one be an extraordinary one for you by your act of genuinely thanking God.

(1) (Reply)

"GÓDÒGÓDÒ" - A Poem By Maykam / How Independent Is Independent Nigerian / The Lamb And A Poem

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.