Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,171,992 members, 7,883,420 topics. Date: Monday, 08 July 2024 at 10:28 AM

No Laugh Oo - Poems For Review - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Poems For Review / No Laugh Oo (398 Views)

The Last Laugh (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

No Laugh Oo by Ajoshberry: 4:12pm On Aug 20, 2017
Na so i enter motor dey comot,
Leave sam wey still dey cook for domot.
As i siddon inside the danfo,
Na im one thing kon happen.
"Witty matter",Oyinbo go call am,but
No laugh Oo.

As the motor they blow go,
E get one bros wey siddon for the back of my front.
You don dey vex ni?
I mean sey for the front of my back.
Na the bros cos the matter. But
No laugh Oo.

As we reach one bustop like that.
You know Lagos bustops name na.
Name wey be like bitter cola for heart.
You know wetin kon funny me?
The bros face be like prayer point.
No laugh Oo.

Eno teyl before the bros friend enter siddon.
because the bros senior the person wey enter.
Na im yawa kon gas,
Kasala too follow. But
No laugh oo.

'My guy how far na'.
Na the bros dey greet the guy so.
'Owo mi da?',the conductor don collect money for the guy hand.
Na im the bros kon dey tell the guy,
Sey make e collect the money back,sey im go pay.
No laugh Oo.

The guy kon dey tel the bros sey make e no worry.
You know as you dey do if person wan pay your money-
You go first dey claim frosh.
Na im the guy too dey do.
But guy ih no work oo. But
No laugh Oo.

The bros beg the guy so tey,
People even shook mouth.
As the guy kon dey think sey,
The bros suppose put the money for im pocket na.
As he see sey he no ask am again,he kon open im mouth.
No laugh Oo.

'Oya bros bring am'
Na im everybody kon dey look the guy.
Shu!,the money wey you no want?
'Bros na play i dey na,you suppose put the money for my pocket as mama shuki dey do na'.-
You don dey laugh?
No laugh Oo.

Naija guys?
Chai diaris God Oo.
17:18:08:11:12
Re: No Laugh Oo by immortalcrown(m): 4:14pm On Aug 20, 2017
Hehe!
Re: No Laugh Oo by squash47(m): 4:17pm On Aug 20, 2017
If i hear say i laff,make Bubu die
Re: No Laugh Oo by Ajoshberry: 5:07pm On Aug 20, 2017
Bubu ke......Hahahaha

(1) (Reply)

ALONE ~edgar Allan Poe / Invariable Belle / "It Will Never Be The Same"

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.