Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,180,223 members, 7,910,315 topics. Date: Sunday, 04 August 2024 at 03:34 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Share Your Funny Akward Dreams Here (1714 Views)
Share Your Funny And Weird Pictures Here / 10 Practical Ways To Make Your Dreams Come True And Enjoy Life / Share Your Most 'WEIRD' Experience Of 2017. (2) (3) (4)
Share Your Funny Akward Dreams Here by MichaelSokoto(m): 4:19am On Oct 14, 2017 |
At some point in our lives, we do dream some funny, stupid awkward dreams. pls let's share so just dis nite, I just woke up 4rm a chilling akward dream. una know dat Commando film starring Arnold Schwarzenegger? during d time he went to break into an arms warehouse to collect those arsenal of weapons, my broda, na me follow am with army camo bag. as d guy dey load em own, na so him put one machine gun & a mini rocket launcher for my bag wey I carry for back like backpack. Arnold come waka leaving me to take d weapons to my house. I enter my bike ride comot 4 d compound, it was fast getting dark & I was riding towards king square center, ring road in Benin city. unfortunately, our Naija police chose dat very evening of all every evenings to mount dia tax collection checkpoint. 4 dis very dream, dem contract agberos to help dem block loop holes so dat if u try avoiding dem for one side, agbero boiz gor kpanke u for d oda side as I dey turn round a bend na so I sight dem, small chill hold me but been say I carry army camo bag 4 back, been think say dem go soji then lemme pass, highest I go form esprit 'd corp. dis police dem carry gun for one hand still hold long stick for d oda. as I dey near dem dey form soja man, dem dey flank me down but I dwy fire on. police man carry him stick take wipe me with all of dem also tryin to but I managed to escape. come see agbero dem sef for front wit em stick to wipe me join but I still escape. pheww! I haven't even riden more than two NEPA poles, I still jam anoda set of police checkpoint wit em agbero platoon. same previous escape scenerio played out again. I ditched d bike & was now jogging onto a street wit a kinda slow moving traffick. as I was jogging on one side of d road, my broda come see our Nigerian soldiers for inside dia military truck wit some of dem fully armed & me na, I carry camo bag wen I nor be soldier. army truck was discharging off some officers (close of work for d day tinz), me for my mind I say "ee don be for me today" for d weapons wey I carry? heaven dey await pesin today but I summon courage, hold my liver put for right hand dey form solja man walkin style but tryin to avoid eye contact in case I hear, "hey you! esprit 'd corp, wats ur army numba? wat unit are u? why are u not in full carmo? wats in d bag?" but I managed to bypass dem & quickly cornered into a nearby street then I woke up. |
Re: Share Your Funny Akward Dreams Here by Joiceee(f): 7:20am On Oct 14, 2017 |
Lol.............ensure you treat malaria this week. 1 Like |
Re: Share Your Funny Akward Dreams Here by bidexolumanish(m): 4:04pm On Oct 14, 2017 |
Joiceee:this one pass malaria 1 Like |
Re: Share Your Funny Akward Dreams Here by bidexolumanish(m): 4:05pm On Oct 14, 2017 |
Joiceee:joicee whatsup |
Re: Share Your Funny Akward Dreams Here by Joiceee(f): 10:34pm On Oct 17, 2017 |
bidexolumanish:am gud |
(1) (Reply)
ONE Of Nairalander Just Started A Unique Ideal Give Him Support / Lady Forced To Conduct HIV Test To Clear Her Name / Fulani Herdsmen Attacks Catholic Church In Benue, Killed 2 Priests
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15 |