Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,217,554 members, 8,034,622 topics. Date: Sunday, 22 December 2024 at 07:00 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Kambo My Guy! (458 Views)
(1) (Reply)
Kambo My Guy! by pcaliphate(m): 8:39am On Feb 02, 2018 |
Hello Everyone. Here is a comic piece of mine titled 'Letter to Kambo'. Enjoy with any rhythmical beat you make. Kambo my guy, how you dey? Kambo my guy, where you dey? Kambo my guy, I miss you well, Kambo my guy, hope all is well? Kambo my guy, na Pito dey talk, Kambo my guy, e don tey we talk. Kambo my guy, since we comot for school, I never hear from you, you never hear from me too. Kambo my guy, no vex at all, You know say man must hustle which is very sure. Kambo my guy, make I knack you some gisting, Carry chair for there make you hear make you listen. Anita don marry, Kelechi wan wed, This guy don travel out, you sabi Ahmed? Banku Shaku don go the prison, Na hear me I hear, me no no the reason. Uche don big now, she don born three, Infact belle swell, the last time we see. Kambo my guy, things hard for your guy, As you dey London, try reason your guy. Exchange rate don drink, the matter don high, If You send the pounds now, na jump to the sky. Kambo my guy, me go dey expect reply, As palava red for me, me no go shy. Kambo my guy, no tear this letter. No put am for corner and dispose it later. Kambo my guy, shey you still remember, You tell me that year say we go always dey together. Kambo my guy, my ink wan finish, Abeg write your own too, when you read am finish. Kambo my guy, stay safe my bro, Ehhhh! I don forget, help me greet Nero. Kambo my guy! Yours faithfully, Pito Kalamase. By Olowo Tosin John. 1 Like
|
(1) (Reply)
Allergic Rose - Nigerian Love Story By Joel Williams / Reading Group. / Fiction: My Child by I May End Soon
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8 |