Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,183,083 members, 7,919,493 topics. Date: Tuesday, 13 August 2024 at 09:40 AM

Cabals Secret Meeting And Conversations Exposed - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Cabals Secret Meeting And Conversations Exposed (1350 Views)

Terrorists Attend Secret Meeting With Nigerian 'Officials' / EndSARS: "Secret Meeting" With Emefiele, Dangote Amplifies Confusion In Protests / Ambode Had ‘secret Meeting’ With APC Electoral Panel Before Primary (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Cabals Secret Meeting And Conversations Exposed by adebayo987: 4:52am On Feb 03, 2019
Cabal 1 - How you see that man na?
Cabal 2 – that man no go gree step dan o…
Cabal 1 – see how the economy don die finish. Hmm, na wah o!
Cabal 2 – what a big shame. See him choice of ministers sef.
Cabal 1 – hmm, him don spoil our party name finish.
Cabal 2 – I dey regret sef, but one thing be say, we need to finish wetin we start sha.
Cabal 1 – that small girl wey call herself him wife wan spoil our small relationship with the man sef.
Cabal 2 – no mind that girl o, she no get respect for the elders of the land…
(both laugh)
Cabal 1 – the man sef no do like person wey dey hear sometimes.
Cabal 2 – hahaha! You dey go far, does he even read?
Cabal 1 – na me for be the next president and you; my vice.
Cabal 2 – I surprise when him say him dey go for second tenure o; wetin we no agree
Cabal 1 – brother, na him be president o. See, we need to do something about our party o, if not, once power commot for our hand na till thy kingdom com o.
Cabal 2 – I bin think say him go die sef but that guy still dey alive o.
Cabal 1 – ehen na, na we even indirectly give the media him dead info, so that him vice go take over but that guy com dull.
Cabal 2 – and na prof him be o.
Cabal 1 – mtcheeew, that one dey do holy holy.
Cabal 2 - no fear say we go loose power, e get how we fit meander the in-tactics.
Cabal 1 – how na?
Cabal 2 - First, we go spoil this administration for am.
Cabal 1 – how? You know say that him girl no like us.
Cabal 2 – hehehe, relax, na we dey do the plan. After we don deal with am ehn, that small girl wey no get respect for the elders go hear am.
Cabal 1 – so, na wetin we go do na?
Cabal 2 – we already know say this election na die o. you know say him no know anything,
Cabal 1 – ehn.
Cabal 2 - we go deceive am to break the law so that them go impeach am.
Cabal 1 – what if him still loose?
Cabal 2 – that man no go wan still step dan even if him loose o, so we need to make him look like devil before Nigerians.
Cabal 1 – how?
Cabal 2 – we go make am look like a tyrant by advising him to put all him ethnic people in the positions of strangers to him.
Cabal 1 – hihihihi… you know say him go like am?
Cabal 2 – ehen na, relax, then we go advice am to publicly rig this election.
Cabal 1 – hmm, you know say if them sue am, him fit still loose for court.
Cabal 2 – you dey fear for that side wey the person wey dey talk to you na law himself.
Cabal 1 – see ehn, e be like say you no understand o.
Cabal 2 – baba, wetin you dey think sef, oya tell me make I hear.
Cabal 1 – if them sue am, na this party go go dan o.
Cabal 2 – hehehe… noooooooooo, not while I’m alive. In this world, even if you openly or secretly rig, so far say power dey your hand, nothing go happen, unless them impeach you wey we still fit manipulate but we want him to be impeached, so we have to play the game well.
Cabal 1 – hmm, so how we go do am?
Cabal 2 - ehen, we go tell am to suspend the present CJN and use him brother put there. By that, case close, we don settle that chapter. Secondly, we go import foreigners like all our muslim brothers in nearby countries to come vote, so we no go loose too much.
Cabal 1 – kabiesi… e be like say you be pro for this thing o.
Cabal 2 – na me be the original politics na. by the time him openly rig, them go impeach am, but na still our party go still dey in power. Hahaha!
Cabal 1 – Ooooooooooooooooooooh! Na where you bin dey go?
Cabal 2 – ehen na!
(grin grin)
Cabal 1 – (picks the phone) na him o!
Cabal 2 – baba, I don go o. we go continue later.
Cabal 1 – no wahala make I go baff after I answer this him yeye old call!
(Cabal 2 is gone)
Cabal 1 – kabiesi; this small boy na witch o. hmm, I fear am.
(leaked from an insider)
Re: Cabals Secret Meeting And Conversations Exposed by helinues: 5:21am On Feb 03, 2019
Quick go bath cos I am perceiving the odour here.. angry
Re: Cabals Secret Meeting And Conversations Exposed by Dicado: 7:53am On Feb 03, 2019
Group of failures!

I even pity Buhari, with the way he's been used by those cabals to break laws, he could go to jail after his tenure expires. He has no good advisers.

(1) (Reply)

See What APC Has Reduced Able Bodied Young Men To. / Forget Fake Result Here Atiku And Buhari Marking Each Other Seriously / Ortom, David Mark, Ayu Storm INEC Headquarters To Lay Complaints

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.