Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,228,478 members, 8,073,962 topics. Date: Saturday, 08 February 2025 at 11:22 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Which Matter Are They Settling In Your Area? (3558 Views)
Which Matter Them Day Settle For Your Area Now? / Which Matter Dem Dey Settle For Una Side? / Which Matter Dem Dey Setttle Now ? (2) (3) (4)
Which Matter Are They Settling In Your Area? by Sunisonflex39(m): 1:21am On May 29, 2020 |
to cut long story short 1. As per covid 19 inter state boarder closure, One guy no fit go edo from PH go renew him yahoo plus jazz, and baba say na June 1st e dey run mad.. no the matter we dey settle since. 2. pastor say him put 3k as offering,as head usher say the overall offering na 1800.. na the matter we dey settle since o. 3. Police officer stretch hand to collect 50 box from driver, Driver pour hand sanitizer for him hand. na the matter we dey settle since. 4. Oga sack gate man and tell am to pack all him things leave, gate man go main building go carry junior join. na the matter we dey settle since o. 5. House girl call Oga "Naughty boy for madam front. na the matter we dey settle since. 6. My guy post him mother picture for facebook,and one guy commented " guy, you sef know this yeye woman, she no dey like condom" na the matter we dey settle since o. 7. I buy Second hand phone, come see my baby nudes inside gallery...my baby never own that kind phone before. them dey settle the matter. 8. Papa sell him land take sponsor Son to travel go New York, son come back say cold too much for New York. na the matter we dey settle since. 9. Doctor impregnated COVID 19 patient in isolation center. na the matter chikwe and Bose mustapha dey settle since. 10. My friend go splash old woman water with him car oo, na so the woman laugh disappear as I dey talk now we dey mountain since morning dey pray oo� �� 11. Yahoo boy go use VPN register jamb now en center dey for greece. As I dey talk to you now. We still dey jamb headquarters. Na the matter we de try settle. 12. Serious matter don arise ooooh we just hear now say angel Michael don sell trumpet � � � � � Na the matter we wan go heaven go settle ���� 13. One DJ mistakenly go play Davido music for Burna boy party, na the matter we dey settle now. 14. After 7 years of looking for admission Kelechi finally get admission but as e dey rejoice e mistakenly press "REJECT" button �♂️Na jamb office we dey since☹ 15. Side chic carry Sugar Daddy Jeep go make hair for Sugar daddy wife saloon.....The matter bloody����� Virgin wey them one use for sacrifice to the gods, Igwe Don go finish her obosiasis. na since we dey calm ezemuo. which matter them dey settle for your area? 9 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Staphylococcus: 1:23am On May 29, 2020 |
Gibbberish, Bunkum and balderdash! 1 Like |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by anthonyuncle(m): 2:16am On May 29, 2020 |
bobrisky rape tonto dike & e kom lead to pregnancy 4 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Comedian2019: 3:28am On May 29, 2020 |
As I reach house this evening, na hin dem tell me say my babe don beat soldier wife black and blue. As I dey talk now, I dey do frog jump in front of barrack, some elders dey try settle #thematter. 7 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Sunisonflex39(m): 8:27am On May 29, 2020 |
Sekeleberde:you dey mind that guy.. na over seriousness go wound am.. man fast laugh and be merry 1 Like |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Nobody: 8:42am On May 29, 2020 |
One guy go theif soilder okada the soilder dey come back from barracks this morning Kon stop bike as he wan enter like this na hin he see say na him bike be that,,the soilder wan kill am all chairman dey beg him na the matter we dey settle since now 5 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Sunisonflex39(m): 9:32am On May 29, 2020 |
babe delete emeka imtoken app wet get 5 bit coin and 11 etherum just to free up space to download tiktok..to make matter worse, emeka no carry him password and others for head, we wake up this morning dey settle matter 1 Like |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by adioolayi(m): 11:42am On May 29, 2020 |
Dem talk say one celebrity couple just born and e be like say the pikin resemble another celebrity....Na akproko rumor ooo ..but anyhow we still dey settle the matter |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Freelane33(m): 12:54pm On May 29, 2020 |
Two men posted the same son pics on children’s day na the matter I Dey Settle since Morning 5 Likes 2 Shares |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Freelane33(m): 12:56pm On May 29, 2020 |
Na your matter we Wan start to settle ,down the thread now Staphylococcus: 5 Likes 1 Share |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Nobody: 1:00pm On May 29, 2020 |
My Guy Carry 3k Go Dey Price Jeans Of 15k, Zip Come Spoil Now Like This I Don Run Leave Dey Shop Make e Settle Him Own Matter Only Am 4 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by dboo442: 2:54pm On May 29, 2020 |
one abino carry im neigbour pikin throw go up e no c wen the pikin land for ground,we dey hospital nah the matter we dey settle o 4 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Sunisonflex39(m): 2:55pm On May 29, 2020 |
Freelane33:make I go call elders make we settle him matter 1 Like 1 Share |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Sunisonflex39(m): 2:56pm On May 29, 2020 |
Kingsuave:this one off me |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Nobody: 9:48pm On May 29, 2020 |
Na so e happen oo 1 Like
|
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Nobody: 9:48pm On May 29, 2020 |
For my church oooo hmmm 1 Like
|
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Ugolistikp: 11:02pm On May 29, 2020 |
Mad woman way dey for street don go call Alhaji "Honey" when him and him wife dey pass....Na d matter we dey settle since ooooooo..... 2 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Nobody: 11:27pm On May 29, 2020 |
Emeka pick money for ground turn fowl,come run enter him landlord poultry mix up with other fowl,how we want take locate emeka now? 13 Likes 1 Share
|
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by maleekeminent(m): 11:37pm On May 29, 2020 |
King tell OLUAWO to ask the oracle watin dem go use for sacrifice, oracle don pick king as sacrifice.we still dey palace now we never see the matter settle o 4 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by maleekeminent(m): 11:41pm On May 29, 2020 |
Babe wash vegetable with washing machine.Na the another matter wey we dey settle now 4 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by 11Anonymous(m): 12:05am On May 30, 2020 |
Babe post boyfriend picture for her status. The guy say make the babe screenshot the status views send give am, babe neva reply. We dey try calm the guy down since. 2 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by sunnydike1(m): 4:33am On May 30, 2020 |
My Guy Buy Fairly Used Phone, Na So e See e girlfriend naked pictures inside,we sha dey station dey settle am. My padi even carry cutlass reach station sef. 1 Like |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by jidamsel43(m): 6:53am On May 30, 2020 |
A woman go call policeman may he arrest her husband and side chic for hotel. The policeman wey come na him be the husband of the woman in the hotel. We are still in police state to settle the matter 3 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by skyhighweb(m): 7:20am On May 30, 2020 |
Well let's give this rubbish trend a week n we go back to normal 3 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Igbojihadist: 7:44am On May 30, 2020 |
matter too much 4 naija 3 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by ninetiethcrown7(m): 7:47am On May 30, 2020 |
skyhighweb: I swear. This trend has turned my WhatsApp status Redundant. 1 Like |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by skyhighweb(m): 9:02am On May 30, 2020 |
ninetiethcrown7:some will just write different stories through out their time line n end with nah d matter we dey settle, di trend is just stupid abeg 1 Like |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Elite14(m): 9:17am On May 30, 2020 |
#Copied Dj don go play alora song for aye party Me i no fit interfere for #TheMatter Make dem no settle bottle for my head.... 3 Likes |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Lordfranklin(m): 9:29am On May 30, 2020 |
ninetiethcrown7:I left Whatsapp because of this reason. 1 Like |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Nobody: 10:04am On May 30, 2020 |
What led to this trend sef ooo?? Somebody should educate me. |
Re: Which Matter Are They Settling In Your Area? by Benards(m): 10:37am On May 30, 2020 |
realokopi: No worry we go enter your matter small time...... But meanwhile make we try settle this girl matter. Me sef i never brush teeth since last week
|
Topcio Whitening Herbal Ghana Soap / Top 10 Richest Musicians In Nigeria 2021 / Meet Lagos Sugar Mummy Living At Lekki Phase 1
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2025 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 29 |