Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,185,292 members, 7,925,887 topics. Date: Tuesday, 20 August 2024 at 05:17 AM

Free Readers Association – By Bisi Adeleye-fayemi [1st Lady] - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Free Readers Association – By Bisi Adeleye-fayemi [1st Lady] (162 Views)

Bisi Adeleye Fayemi Visits Fayose Ahead Of Next Tuesday's Inauguration / Fayemi Appoints Wife, Bisi Adeleye-Fayemi, Chairperson Of Inauguration Committee / Meet Bisi Adeleye Fayemi: Biography Of Ekiti State First Lady In Waiting (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Free Readers Association – By Bisi Adeleye-fayemi [1st Lady] by Ukpaka: 9:16am On Jul 24, 2020
Free Readers Association – By Bisi Adeleye-Fayemi [1st Lady]
https://247ureports.com/2020/07/free-readers-association-by-bisi-adeleye-fayemi/
-
...
Moses: (Flipping through another newspaper). No mind am. Selfish and Yeye people. I done taya sef. You go dey talk bulabula say you don chop billions whey dem suppose to use do road, do water, do school, do light. Now dem dey ask you question, you come de form faint faint. Thunder go fire him head.

Joe: What if na true true him faint? Se person de play with faint ni?

Benson: Na lie jo, which kind faint be dat? Dem put hand for him mouth, his hand still dey move. Person whey faint true true no go fit lift anytin

Steven: Benson, you don become Dr now abi? (Everyone laughs)

Joe: (Reading from paper) Minister appears before NASS Committee, accuses them of being beneficiaries of NDDC contracts.

Moses: That one na Level 1 Nollywood drama o! De one whey me I like na when de Honourable Madam dey ask Minister who dem give contract to, say she no de among. The Chairman come tap Honourable Madam make she leave matter for Mathias!

Steven: Poor madam. She no know say House member get levels. Na so some go de talk big big grammar, look for bill to pass, go de do monitoring up and down, de ones whey own de house gangan go just de chop clean mouth.

Benson: I sure say dem no call Auntie when they dey do the sharing. People no de call women for dat kind matter, na so so accountability dem go de shout.

(1) (Reply)

Again, Dogara Dumps PDP For APC, Meets President Buhari / Covid19 Offers Opportunity To Proffer Solutions To Problems- VP / Gov. Ugwuanyi Provides COVID-19 Self-Assement Platform To Enugu People

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.