Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,201,895 members, 7,980,135 topics. Date: Sunday, 20 October 2024 at 06:37 AM

Big Brother Naija Season 5 Housemates Names: Rebecca 'neng'i Hampson, Bbnaija He - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Big Brother Naija Season 5 Housemates Names: Rebecca 'neng'i Hampson, Bbnaija He (432 Views)

Nengi Hampson Rocks Wedding Dress In New Pictures / Nengi Hampson Buys A New House (pictures) / Mercy Twerks For Don Jazzy On BBNaija, He Comments About Her Pants (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Big Brother Naija Season 5 Housemates Names: Rebecca 'neng'i Hampson, Bbnaija He by RynaShubie(m): 10:25pm On Jul 25, 2020
Fans of di Big Brother Naija show season 5 lockdown edition don enter social media to debate, Rebecca Hampson AKA Nengi actions for di house on Thursday night.
Nengi na di first Head of House for di ongoing 2020 Big Brother Naija reality TV show.
Di Balyelsa State born housemate for di kitchen area of di house on Thursday night dey hug, lean on a fellow housemate, Ozoemena, in di kain manner wey be like say she dey express a special likeness for di guy.
Meet di first Head of House BBNaija 2020 housemates
Big Brother Naija Season 5: Main highlights for Day 1
She also lose some points during question session wen she help answer question wey Big Brother ask Ozo.
E be like say fans dey disappointed about her showing interest in a man, instead of di other way round. but some fans also support her action.
See wetin dem tok

Who be Rebecca Hampson AKA Nengi
Rebecca Hampson na 22 years old entrepreneur from Bayelsa State, Nigeria. She be former model and MBGN Top 5 contestant wey love learning new things, having fun, travelling, taking on new adventures.
She study communications for di University of Port Harcourt. She say she like clean place, clean pipo and like to dey true to hersef.
Wetin go happun dis weekend for di house.
Game Show
Friday night na game show wen Big brother go make di contestants play some games, e neva dey clear which game dem go play tonight but wetin we sabi be say:
Pipo go lose points
Some pipo get opportunity to stay longer for di house if dem win.
And eviction fit happun (di surprise na wetin dey always characterise di Big Brother show)
Saturday Night Party
Social life na great part of Big Brother Naija, Dis Saturday night, housemates go get one club like party, dem go dress like party rockers and life DJ go dey di house wey go thrill dem wit good music.
Big Brother neva unveil who go be di ogbonge DJ for di house dis weekend but we go dey update una.
Wetin we sabi be say, e dey expected say housemates go unwine on Saturday night and romance na one of di atrributes wey we go fit confam between housemates wey dey involved wit each oda.
Eviction Sunday
Dis na anoda emotional moment for di house. In di morning of every Sunday atleast one housemate go comot for di house.
Who go comot? Di Friday night game, Saturday party and activities wey don happun during di week and audience votes go determine who go be di first pesin to comot from di house dis Sunday. Written by Rynashubie

(1) (Reply)

7 Things You Didn’t Know About Nengi, Bbnaija Housemate / A Mother Beats Her Daughter' Puzzle And Answer / 2nd Saturday Night Party | Bbnaija 2020 Season 5

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.