Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,201,339 members, 7,978,085 topics. Date: Thursday, 17 October 2024 at 06:40 PM

Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W (735 Views)

Ladies: This Is Why U Must Investigate A Guys Source Of Income Before Dating Him / No Man Has Ever Approached Me – Young 22 Year Old Lady Discloses / I Served My Boyfriend With Jollof Mixed With My Shit – Ex-girlfriend Discloses (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W by Frushsy: 7:22am On Jul 21, 2021
This is his interview with BBC pidgin
Obinna Iyiegbu, wey pipo sabi as Obi Cubana, don reveal inside exclusive interview with di BBC Pidgin, im life tori and journey.

Di 46-year old business man from Anambra state for eastern Nigeria wey dey into entertainment and hospitality business, from im hometown of Oba, Idemili South, Obi Cubana sidon to tok many tins, including about di early days of im business life.

Di business mogul wey di burial of im mama for im hometown Oba over di weekend of 16, 17, 18 July, 2021, become di biggest tori for social media, tok about di role of im parents, im education and how im make im first N1m ($2,400).

Over di weekend of 16, 17, 18 July, 2021, di burial of Obi Cubana mama, wey im do for im hometown Oba, become Nigeria biggest tori for social media and e get why.

Tori begin fly upandan say Obi Cubana by Friday say go immortalise im mama wit pendant and neckpiece wey worth $100,000 and ceremony wey cost even more.

“E happun like dis becos we don promise our mama say wen she clock 80 years, di kain carnival wey we go do, nobody don do am for dis world,” Obi Cubana tok as im explain why di burial na tok of town.

E say but wen im mama die before her 80th birthday, dem come decide to direct all di planning and energy for di burial.

First One Million Naira

Di Political Science graduate say after im comot school, e dey Abuja dey do National Youth Service (NYSC) for 1999 wia im serve for di National Assembly.

At di same time Obi Cubana come enta Estate Agent work, dey sell land and real estate property.

“Na for dia I hear 5% for di first time in my life!”

But im big break come e say, as e bin meet one client wey give am house furnishing contract.

“We do [di job] well o, e dash me N500k...inside di job my profit come be like N600 and something [thousand], so na N1.1m be that.”

Oda jobs later follow.

“I do small contract for PPMC, make small money that time buy my V-Boot [Mercedes Benz car], na so we come start life.”


Wetin we call dis Video,
Terry Waya: Na me discover Banana Island

Mama and Papa

Di business mogul praise im parents well-well for how dem raise im and im siblings, especially im mama, wey e say become everytin for dem since dia papa die 15 years ago.

“Na she dey play di role of papa and mama… before you go she must pray for you, after she go pray for you,” di Lagos based businessman bin tok about im mama.

E say im mama bin dey teach for for di primary school im attend: Central School, Oba.

Money spraying

Obi Cubana defend di spraying of currency notes for di ceremony by guests, say na dem get dia money and so dem fit spend am anyway dem like.

“How I go plan make pipo troway money, carry am bath? Di money na dem get am… na dem get dia money na dem get dia style.

Watch full interview


https://www.youtube.com/watch?v=a0r_BXmq1RY

1 Like

Re: Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W by Chigold101(m): 7:49am On Jul 21, 2021
good

1 Like

Re: Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W by Polynek(m): 8:09am On Jul 21, 2021
Nice 1
Re: Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W by fnep2smooth(m): 8:09am On Jul 21, 2021
oga carry go.
you can't sit down in your house and you will be insulting someone working and making his money.
Re: Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W by WibusJaga: 8:29am On Jul 21, 2021
Hardwork pays.
Re: Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W by Born2winnx: 8:49am On Jul 21, 2021
Dorime,

Much love bro.
Re: Obi Cubana Full Interview With BBC He Discloses Everything Including Source Of W by fourboys: 8:51am On Jul 21, 2021
embarassed

(1) (Reply)

Bbnaija 2021: Meet Housemate Who Is A "Sucker For Love" / Bbnaija: Queen Reveals Why She Slept Off After Waiting For White Money. / Couple Stuck Together While Having S3x (video)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.