Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,192,912 members, 7,949,166 topics. Date: Saturday, 14 September 2024 at 08:25 PM

Cambridge University Professor Wey Nor Fit Read Until 18 - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Cambridge University Professor Wey Nor Fit Read Until 18 (188 Views)

P'square Rudeboy Blasts Joe Igbokwe: “Elder Wey Mumu, Your Papa!” / "I'm In Oxford, Not Cambridge" - Dj Cuppy Corrects Her Father, Otedola (pix) / "Pepper Wey Nor Too Hot" - Linda Osifo Shares Adorable Photos (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Cambridge University Professor Wey Nor Fit Read Until 18 by DyshApp: 11:19pm On Mar 29, 2023
Notice: This is a pidgin English translate

One man wey no fit read or write until im be 18 go become di youngest ever black professor for di UK Cambridge University.

Dem diagnose Jason Arday wit autism and global development delay for im early years, and im no fit speak until im be 11 years old.

Now, di 37-year-old dey set to become professor of sociology of education for di prestigious university.

Although im no fit tok, di young Jason dey always question di world around am.
"Why some pipo dey homeless?" im remember dey wonder "Why war dey?"

Born and raised for Clapham, south-west London, Prof Arday, one sociologist, say im formative moments include watching Nelson Mandela release from prison on television and South Africa symbolic triumph for di 1995 Rugby World Cup.

Im remember im dey always dey deeply moved by di suffering of odas and one strong compulsion to act.

"I remember thinking if I no make am as a football player or a professional snooker player, then I wan save di world," e tok.

Im mama play ogbonge role in developing im self- confidence and skills. She introduce am to a wide range of music in di hope say dis go help how im dey learn language.

But e also kick-start one lifelong interest in popular culture wey don characterise some of im research.

"I dey always feel say na privilege to get a period of 11 years wia maybe I no fit speak and follow pipo tok wen everybody else fit tok because e allow me see tins in a different way." Oga Jason tok...

You can read the full story on Dysh
At Dysh, we honor true heroes and their academic accomplishments, celebrating them as stars. We invite you to join our community of like-minded individuals in our real talk group. Link in bio
FACEBOOK


(1) (Reply)

Trending: Listen To Aprez - Balabala Trending On Spotify Today! / Amb. Wahala, Abuja King Of Airwaves Makes Surprise Comeback On "Toriwowo / Ofego Deletes All His Instagram Posts | SEE

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.