Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,174,067 members, 7,890,507 topics. Date: Monday, 15 July 2024 at 03:10 PM

Thieves In My House - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Thieves In My House (427 Views)

Funny Moment As Lion Attack Thieves / Stocking My House Already(pics) / How Different Girls React To "Will You Come To My House This Night?" (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Thieves In My House by henndukwe18: 9:51am On Apr 06, 2023
THIEVES IN MY HOUSE
I just dey alone for my house dey baf inside bathroom as I dey sing soso by omah lay, na so person kick bathroom door
Me: who b dt
1st thief: oya comot for there
Me: bros no vex make I wear my boxers.
Soap stl dey my body oo, I com wear my boxers, switch my phone off com hide am inside bucket, as I comot for bathroom
1st thief: where d money
Me: which money
1st thief: where your money
Me: I no get money, cash no dey
2nd thief: shut up, bank don dey give cash
Me: I no get money for acct
1st thief: guy search D's place
3rd thief: OK
1st thief: so as u dey so money no dey D's house
Me: money no dey here
3rd thief: guy, garri dey here oo
Me: see abeg no touch my garri, u fit carry anything BT if u touch my garri, me n u go get problem
3rd thief: u dey mad
Me: sorry no vex.
Then My phone com ring inside bathroom I com remember sey na reboot wey I press instead of shutdown, they collect d phone
1st thief: so u no get money BT u dey use iPhone
me: bros we thank God oo, na just packaging
1st thief: packaging abi, no wahala make I package D's 1
Me: bros no collect my phone oo, if u no how much wey i buy DT phone, dem fit sell ur papa to buy am
1st thief: u dey mad.
D guy com slap me, me n am begin dey fight, d others com dey separate us
2nd thief: guy wetin dey worry u, leave am na, make we comot D's guy no get anything
1st thief: D's guy don insult me I no fit leave am, I go deal with am b4 I go leave here
3rd thief: wetin u wan do am, nothing dey here
1st thief: I go rape am, abeg leave me make I rape D's guy
2nd thief: omo D's guy don mad oo.
D guy com dey remove belt
1st thief: oya comot ur boxers.
I com dey look d guy like Castro for real house of comedy
Me: just dey play
1st thief: guy I say off boxers u dey look me.

Na so I vex giv d guy Castro slap, d guy turn to saint Louis bread, d others run, funny tin b sey, d bread wear belt

1 Like

(1) (Reply)

Please Let The Fun Continue By Forming Your Own Verse(photo) / Howdens K'i't'chens For Sale Penge / New Element

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.