Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,204,049 members, 7,987,724 topics. Date: Monday, 28 October 2024 at 03:32 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Education / NÀÌJÁ POETRY 45: Kwarapshen (272 Views)
NÀÌJÁ THROWBACK: The Asaba – Onitsha Crossing, 1959 & Now / NÀÌJÁ POETRY 63: Who Buys My Thoughts / NÀÌJÁ POETRY 42: Makoko (2) (3) (4)
(1) (Reply)
NÀÌJÁ POETRY 45: Kwarapshen by NaijaphiliaBlog: 5:26pm On May 02, 2023 |
KWARAPSHEN – “Corruption“ (A poem in Pidgin English) Me, ma na SARS I sabi drop bars My gun ready to blast Any youth wey dey drive cars If tattoos na your singlet We go treat you like piglet If you no gree cooperate Omo, you go catch bullet. Me ma na politician If you check, I be magician I dey “pight” my brand of “kwarapshen” Play ball, I go give you admission. My certificate na banza My account balance na fire If I like I go make yanga Even next time I go still dey power. Me ma na Naija Our mumu don end here Una plans go backfire Na my generation go matter Una vision dey our museum And we ready to change our condition Even if una kill small portion We go still carry out our mission. Lekki na the catalyst We go use am minimize fatalities We don learn all una tactics And we have all the relevant statistics Baba God na our confidence Next election una go see our relevance We dey ready- no more reluctance 2023 una go see proper sense. AUTHOR: Kelechi Timothy Francis, born in Nigeria, West Africa. SOURCE https://naijaphilia.com/blog/2023/05/02/naija-poetry-45-kwarapshen/ 1 Like
|
(1) (Reply)
How To Revise And Pass Using PGOLD ICAN Intensive Liveclass Replay...open NOW / MHW 2023: Mr Universe Nigeria, Micheal Samuel Adebowale Visits Nigeria Schools / Exploring The NIMS Medical College Jaipur PG Fee Structure
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 5 |